Bitcoin Forum
January 25, 2026, 03:50:00 PM *
News: Community awards 2025
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: Naija Census  (Read 19 times)
Jessie2121 (OP)
Member
**
Offline Offline

Activity: 412
Merit: 73


View Profile
January 21, 2026, 06:26:27 PM
 #1

I dey moto dey hear about up coming census for radio, this one wey them dey think of to start this census with the way the country be I no sure say na welcome development at all. Who these guys wan count? like this plenty of us no trust our government again. Because from how I see am plenty people no go gree follow for this exercise and one big question wey come up na what about the numbers of people wey them kidnap, who go count them? True true who go count them and all these bandit them na from Nigeria, plenty of them so who go get mind go count them? Things no dey go well for the country nai Dem dey reason this one abi na format to take open up our location for this kidnappers? Na so one man ask for same radio station too, many questions wey people ask and I go like to hear from una...


ABEG MAKE THEM NO PUSH MY POST GO WHERE I NO KNOW AGAIN
Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!