Plenty people dey always blame scam anytime person lose crypto. True, scam dey real for Naija, but e no be the only way people dey loss their money. Sometimes, na technical wahala dey cause am, even if nobody dey scam you.
If person sabi the difference, e go help am protect him money better.
SCAM: wahala wey come from outside:For Naija, crypto scams dey plenty, and dem dey target beginners mostly. Some common ones na:
- Fake investment platforms wey dey promise fixed returns
- People wey dey pretend to be trusted traders
- Phishing links wey dey come through Telegram or WhatsApp or fb
- Fake wallet apps or cloned websites
For this kain wahala, person money dey lost because somebody wan deceive am.
TECHNICAL MISTAKES: mistakes wey you dey do by yourself:Wheneva we hear say person lose crypto, we dey always suspect or accuse scammers, but many Nigerians dey loss crypto by themselves without any scammer. Common technical mistakes na:
- Storing seed phrase as screenshot or for email
- Sending crypto go wrong network or wrong address
- Leaving money for exchange for long time
- Downloading wallet from unofficial source or websites
- Clipboard malware wey go replace address when you dey copy-paste
Once technical mistake happen, e fit loss your money forever be that.
Di main difference:Scam na you trust wrong person.
Technical mistake na you no sabi how di system dey work.
Both fit make you loss money, but technical mistake dey more painful sometimes because e fit happen when you dey do normal thing.
How person fit avoid am, weda by scammers or technical mistake:- Learn how wallet and private keys dey work
- Always double-check network before you send crypto
- Use official wallet only
- Treat seed phrase like cash, no treat am like password
- For large transaction, do test transaction first with chikini money
Crypto dey reward pipu wey sabi handle am well, but e dey punish careless pipu.
For conclusion:Scams go always dey, but technical mistakes fit dey preventable. If Nigerians fit sabi basic crypto technical things, dem fit reduce their losses well well.
Make we chuk mouth for this topic, talk other ways Nigerians dey lose money for crypto.