I know say this dip we dey experience today many of us no really reason am say e go come so easily, and of course people wey dey system for long know say anything fit happen at anytime but them no really believe am say e go happen so soon.
If u don Dey crypto space for some time, u suppose know say pump and dump fit happen anytime, so person mind suppose dey. E dey painful say u go see ur money Dey go down if dip Dey happen but u no get choice, and if that kin thing Dey happen, d only thing wey u go fit do at that moment na to just hold ur coin, no even talk say u wan sell am, na why if we wan invest in bitcoin, then make we use money wey we no go use for long term, make we no use money wey we go Dey use chop on a daily basis. If u Dey crypto space, make u just expect say anything fit happen at any moment.
But if them ring bell say this month or from last month ending we go begin experience serious dip wetin you for do with your investment?
If I Dey profits already, na to sell my invest hold my money now, if e drop now na to buy am back, but person no fit know say dis kin thing go happen. If to say I get alert, I for don Dey find money keep since, as e Dey crash I Dey invest.