So I been created this thread
What's the END? I still want bring am come local board make we talk about am, like Naija people mindset, no be general opinion wey we go give for public board, head make we rob mind to understand weytin go be the last last thing we go happen from this one bitcoin wey we dey hold and we dey struggle to invest in even as our country dey give us wahala inside the economy?
Weytin go be Ur own persona very END? you go later spend your bitcoin finish or you go just continue to hold am till you die abi the investment na weytin you want make your family or generations enjoy? because me I dey think so say be weytin we go hold too much, I go just sell when I don dey old enjoy am small because the money no go spend em self and another person na em go chop our money for us ohh. reason am wella.
The thing be say, plenty people get different reason why dem dey invest in Bitcoin, some na to pass am to their children, make their children come see watin dey keep for them as parents, so that dem no go too suffer for the world. Others fit dey invest because dem believe say, for future, Bitcoin go gain better value wey even pass wetin e be now. But personally oh, me I dey invest am for myself, so that as the thing the built more value, I go dey expand my investment too, the money na still my own.