 |
Today at 02:53:43 PM |
|
All of us don see wetin dey happen for we country despite say we dey form strong say we can survive because of the way most of us dey work hard but how long we think say we go continue to dey like dis and how long we think say we fit relax make the old men bring change wey we dey find?
Now make I tell us exactly wetin bring about this topic: Election dey come up next year the current president don already dey do everything possible to make sure say him buy all the governors and as him buy them the governors go also buy the local government chairmen for him state and the local chairmen go buy all the counselors as well as the youth leaders, the traditional rulers and chiefs.
If una observe well na this people dey actually determine who go win in every election because when Dem don mobilize all of them the next thing na to give them different ugly roles to play to ensure that they work with the Independent National Electoral Commission(INEC) and to deliver their candidates.
For youths wey need positive changes in the country, wetin you don do so far to make sure say we end this bad government wey only prioritize in borrowing of loans without doing anything useful with the loans.
a) Make the youths join politics b) Make all the youths get their voters card c) Make youths create a different political party d) Make the youths ready to fight election riggers
a)Make the youths join politics: For the youths wey dey find changes, we can only change the nation when we come out come do things the right way so if we continue to fold our arms we no go fit change the ugly situation of our country Nigeria.
b) Make all the youths get their voters card: I understand say most times our votes no dey count but if we need changes make all of us wey don dey eligible to vote go get our voters card with it we fit come out in mass vote one good person wey go represent us well, if we say we no go vote them go continue to do massive selection and we go only complain and nothing go come out.
c) Make youths create a different political party: For some of us wey dey inclined politically we go understand say political godfathers na one of the things wey dey make us no dey move forward as a country. you go see person wey don leave office for many years but still dey control the people wey dey office and the resources of the state because na him put the people wey dey for office. If we get youths wey no get any good father if them win election them go work for the betterment of the people nobody go dey collect percentage from the allocation wey dey enter the state or local government na the man reason why we need another political party for youths only.
e) Make the youths ready to fight election riggers: Naija election no dey ever happen without rigging the last presidential election na one example wey don supposed teach us a big lesson now say INEC chairmen for naija dey work to deliver him Oga because na him employ am but if we must stop the nonsense wey happen before from happening again then dis time around make nobody run go house after voting, make we make sure say we protect and monitor our votes and ensure dey do not switch the original results to give to their own favourite candidates until we do so our votes no fit count.
I understand say other things dey wey we fit use make a difference in the up coming election you fit still add your own at least e go educate us more because we no fit dey hustle hard make we still dey suffer because of bad government.
|