OP this matter you talk about so na good one oh but the question you need to ask be say "how many marriages go scatter if them put this thing to law, how many"? Plenty things wey go dey happen eh, the curses wey women go curse our leaders go pass the ones the whole country dey join mouth curse them. If this bill go bring money I believe say them go reason am then put am for law without wasting time but as we talk now the only thing them dey reason na how election wan be like, the lies and dead promises them wan full our ears with na wetin them dey think of but if them wan think am na after election them fit consider am.
For this matter na man dey suffer am pass and sometimes too na men dey force our women to go extra miles to get this bad act to come to light and again the health issues men dey face dey cause am for women to go out sleep with other men then come back with belle say nah their husband dey responsible, so who we wan hold hand say na this person be the real cost? Greed too dey follow, you fit hear talk like "he doesn't satisfy me in bed and all that" e dey lead women to go far, for this one e go hard for the law to get involved.
Support PIGIN For Our Local Board...
I wish say I go fit dey yarn the pigin like you dey go. But eeh, na better thing you just yarn so. As he be so, we know say the government no really care about us. But na nice topic OP drop. The matter done enter every news corner for around the world. No be better thing to write home about. Our matter for fraud done reach moon. Now this one. No be say na watin person suppose dey proud of. Even our culture sef forbid am. Talkless of the pain women inflict on men for this their matter so. Paternity fraud na crime and something suppose done dey on ground to tackle am.
Already, this will destroy marriages, and many women will not agree to it, for the bill to be passed. Women will do everything within their power to prevent the government from signing it into a bill.
I remember a certain time(2019) on Twitter when a Nigerian doctor announced laboratory running DNA on a discounted price in Lagos. He was backlash and threatened for thinking of such. I don't know what later happened, whether the doctor was silenced or whisked away because nobody had what later happened after he cried out for help for the amount of threats to his life he had received.
You see. Omo, government needs to look into this with speed. It's already out of hand. Not getting out of hand. Action needs to be taken now.