Bitcion opportunities have not yet gone but have only been changed, the easy money era may be smaller now, but there are still many chances for people who are willing to learn, stay patient and think long term instead of looking for fast profit.
Bitcoin opportunities never finish oh,even if you wan start today with your bitcoin accumulation journey e no too late sha,the koko be say na to dey consistent with your accumulation so that you go fit build decent portfolio for the long term.A lot of individuals wey neva start but wan start dey get this mindset say dem dey late for the bitcoin investment.Normally,I dey sha tell them to convert that thought into bitcoin accumulation.Oyibo man go talk say “Opportunity comes but once” but for bitcoin matter that ideology na the opposite,bitcoin opportunities plenty even if you no start when dem been just invent am newly no mean say you no fit start now.