My country people how Una see bitcoin price pressure in the last few days nah? The down ward pressure just strong and e no look like what go stop falling in the next week to come sef. Make this country situation try motivate you to try hold any small bitcoin asset you can hold as something.
Bitcoin dey bleed dis time but na still opportunity for investors to accumulate more while they wait for the joy that will come after this trying period but even as e good for investors to accumulate more make we also try dey calculative especially the long term holders, no just rush now accumulate you fit wait then observe how the market dey go before you buy cause the way the price dey drop we fit wake up to 40k between now and the end of June. Country no good and everything wey fit make person future bright we no suppose use am play but concerning dis investment matter make nobody use everything ooo because nobody knows when the price go go up again.