 |
June 16, 2026, 05:46:43 PM |
|
I greet una my great people. I say make I bring this mata come una doormot, because e dey wonder me wetin make plenty people come dey carry their moni from Crypto dey put am inside AI. Me know say this two sectors no dey compete because na the capital from Crypto like Bitcoin dey fuel AI.
But when you look am well, you go see say the money wey you go spend to mine a single Bitcoin always, pass Bitcoin's market value. Another thing be say, High- Performance Computing (HPC) for AI give more value per unit of electricity pass raw blockchain hashing.
I come dey ask, na this thing bring about the drift abi e get anoda things ?
|