I came across a news article on Facebook stating that an African country has implemented a law that punishes corruption with death or life imprisonment. The country is Niger, and it really got me thinking. This is one thing Nigeria should be learning from. How to implement laws that would help the country thrive.
Make I no lie give u, na fucked up country na him we Dey. People wey we go talk say dem go implement d law na thief na him dem be also, so how e wan take happen. How u go expect make thief implement that kin law, u suppose know say e no go possible now.
Dis country just tire me self, because nothing Dey work for dis country, and honestly e no really look like anything go work now, all d people wey Dey ahead now na thief’s dem be, Dey just dey after themselves and their family members, and dem no even want make d country better. Na as things Dey spoil for d country, na Wetin Dey make dem see money steal be that.
If u just observe how d country Dey go, u go know say everything Dey wrong for dis country, and I no sure say anybody fit come change dis country again. All our politicians now ma thief dem be, and even if Dey wan commot for post, na people wey dem teach how to steal dem go still put for power.