I've noticed that 60% of Nigerians invest immediately after hearing someone made money from it. They don't even care to know about the risk and other things involved, once someone could make money from it, they believe that they will make profit, and sometimes they even borrow money to invest. When the market drops, they panic and poor decisions.
Most people no get proper knowledge before dem invest now, na just where dem go get quick money na him dem Dey find, immediately dem hear say person make money from a particular investment, dem no go even do any research, Dey will just jump into the investment, and at d end dem go Dey regret y dem invest. Crypto space no be Wetin u go just jump into because u go cry at the end. If person wey get better knowledge about bitcoin invest, even if d price Dey drop, dem no go panic because dem know say d price go bounce back.
If u go borrow to invest, na better mistake u don make be that ooo most especially if u no get any knowledge about bitcoin. If u do that kin thing, u go cry because na u know how u go take get money wey u go use pay back the loan.
One important habit is building an emergency fund. Investing money that will cover up for our life expenses like rent, school fees, or medical bills can force someone to sell during any market price. Saving some money and keeping them reduces that pressure.
If you don’t have emergency funds, then you won’t be able to hold your bitcoin for long, because any small thing wey happen, na ur bitcoin na him ur mind go Dey as u no get any alternative, but if u get emergency funds, u go forget about d bitcoin wey u Dey hold self.
Another important habit is Invest only your money. Buy Bitcoin with your personal money, and not with money borrowed from friends, loan apps, or banks. Investing with borrowed funds increases financial stress and can lead to poor decisions.
Plenty people Dey make dis mistake for dis country, most of them Dey invest Wetin pass their power, just because dem hear say people Dey make money, some of them fit go carry loan just because say Dey wan invest in bitcoin and things are not done like that. Everybody wan invest in bitcoin, but na sense we suppose use now.