Bitcoin Forum
September 01, 2026, 04:28:00 AM *
News: Latest Bitcoin Core release: 31.1 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: "EFCC now freezing suspicious funds in 72hrs, targets crypto wallets– Olukoyede"  (Read 39 times)
CryptSafe (OP)
Hero Member
*****
Offline

Activity: 1582
Merit: 670


View Profile
August 31, 2026, 09:55:14 PM
 #1

My country people, e don reach time wey we need to dey extra careful and vigilant. As e be now, the EFCC don upgrade their fight enter Crypto wallet's sake of say most of the Crypto transactions dey suspicious while dem dey fight against terrorism via Crypto sponsorship and conduits, dem say public office holders too don begin use crypto to launder public fund's wet sometimes e dey difficult for them to take action and for this act, dem come form one department wey dem call Fraud Risk Assessment and Control Department (FRAC) wey go dey monitor suspicious financial movements and act within 72 hours.

With dis new development,  Na call to Crypto trading for p2p platforms and participants make una dey very careful with p2p trades these days, check well the vendors you dey only trade with, no loose guard Sey na old vendor o. If your body no sweet you to trade with any vendor move to the next one, no stress yourself because e get why your body do you like that. As it stands now EFCC don begin monitor wallets transaction and another thing Na all these local crypto exchange, make una try dey avoid dem sometimes o because e get why.

Source
#BTC
Newbie
*
Offline

Activity: 9
Merit: 0


View Profile
August 31, 2026, 10:49:29 PM
 #2

My brother this one na real better update be this wey you carry enter house oh, na God go bless you my brother.

But this kind thing challenges dey oh, because our Naija people mostly our people for this forum them they trade on a steady basis.

E get one question wey I wan ask be say how person wan take dey careful finish. Because you no fit no a particular vendor or a buyer or seller wey dis government dey trace already , make person no go carry out transactions come go enter gbese. God abeg oh.
promise444c5
Legendary
*
Offline

Activity: 1120
Merit: 1115


All things are numbers


View Profile WWW
August 31, 2026, 10:51:16 PM
 #3

There have always been a need to be extra- careful when you’re dealing with P2P trades btw..it’s not a thing of now. Government increasing surveillance in crypto space was bound to happen anyway , it’s just a mater of time and it seems they are getting more serious at it .

Keep details of every P2P transactions you made incase you decide to go off CEX sometimes.. it will surely help incase there’s a need for it .  There’s no need to panic so far you’re not doing something bad, although you might be required to proof the source of your funds in some cases and how you end up dealing with a target **if you’re not a target.

Things could hit different with Nigeria system though..

Sh*t happens, just be prepared for it.

Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!