only pidgin is needed here
You made this sentence is English and not pidgin so na you first break your rule.
Lol, na wetin enter my mind be dis ooo. Anyways, dat extra warning no dey needed since him don indicate for de title
No body fit shut down Bitcoin not even Satoshi, him no fit just dey call back all Bitcoin that is in circulation that is not possible, although Satoshi nakamoto not fit shut down Bitcoin but if he is ever truly discovered to be one person I believe say him fit cause a bull run or a bear market. Him as the biggest individual holder of Bitcoin and also as the originator him fit affect Bitcoin in a way.
Him no go fit shut down bitcoin, but e dey nice say him disappear completely after em create bitcoin because bitcoin for no really dey decentralized enough if him still dey visible, and people go dey act based on wetin him talk, if him buy or if him sell coins and bitcoin no go fulfill em purpose.
One person no go fit shut down bitcoin, em no get central website wey dem go fit shut down, any major decision wey bitcoin dey follow, de mining nodes must agree first, if majority of the nodes no agree, any protocol change wey no dey accepted na another chain dem dey create, just like BIP110. The majority of the nodes produces the longer chain and na de longest chain (with de most accumulated proof of work) de network dey follow which dey reflect de decision of honest miners.