|
Zigabel (OP)
|
 |
October 21, 2026, 02:42:00 PM |
|
I go like start with one story wey make me dey wan talk about this topic, firstly i no know if person don tak about this kain thing before, make una let me know if any dey becasue i never see am for this board. so i close from work on d oda day i com say make i enter some where buy food chop becasue i no get strength to go house go cook, so as i dey dia dey eat, i see two guys wey dey dia dey loudly dey discuss their portfolio, dem dey talk about Bitcoin and trading, so i just dey hear d oda guy dey talak about how him don good well well and how him dey make money almost every week, and how him sef fit teach pipo sef, d oda guy dey talk how him don put money for differnt coins and how dem don make am plenty money and all those kain talks dem. my interest com be for d one wey talk about trading, becasue me i be person wey dey like learn, any opportunity wey i see to use learn, e no mata if d person big or small i go like learn form am, so some how talk reach my side as i sidan near dem dey eat, i com say make i ask am say bro afa, how you use dey run am wey be say e dey give you money i go like learn o. omor d guy just dey talk about exchange upon exchange, i ask am few things about non custodial wallet, and i just discover say him no even know, him just sabi do p2p and small spot trading at a very beginner level sef, i com ask mysef say why d whole loud noise? wey be say e obvious say dis person just start, i even offer to give am small info, him say na beginners knowledge i get lol, i come wash hand leave am oh  i don observe say e get dis urge wey some people dey get when dem get small knowledge about something, dem wan show am everywhere dem go, dem wan show off say dem don dey do well for life, say dem dey make money and all dat, but dem forget say dat tin fit expose dem to robbery and some kain whala for we country, e go also make you miss opportunity to get beta update because you go dey feel say you too sabi. i just say make i talk am say make we try no dey find oursef for dat kain settings make we no go drag eyes put for our bodi, use your knowledge beta your life dan to show off say you sabi any tin, try dey humble, nothing be d tin las las, d person wey you no give levels fit sabi wetin you no sabi wey be say you go need, but pride go make you miss am. No need to show off or try to prove anything, make e no put yoursef for security risk, try dey low key, E GET WHY.
|
|
|
|
Queen Amara Belle
Newbie

Activity: 11
Merit: 1
|
 |
October 22, 2026, 03:12:57 AM |
|
~snap
After reading your words, I also thought of one thing, that many times we want to show off something in front of others if we can learn a little bit. But in reality, how much we know about something cannot be proven by talking big. In a country like Nigeria, I think it is better to refrain from talking about your income or how much money you have invested in crypto in front of everyone. Because there is no reason to think that everyone will want your best. Again, even those whom we think we know less may have the opportunity to learn something from them that we did not know before. Therefore, it is much more important to take your own work forward, learn from mistakes, and listen carefully to others. There is no need to pretend that you know everything, because learning never ends.
|
|
|
|
|
|
Agbamoni
|
 |
October 22, 2026, 03:32:27 AM |
|
omor d guy just dey talk about exchange upon exchange, i ask am few things about non custodial wallet, and i just discover say him no even know, him just sabi do p2p and small spot trading at a very beginner level sef, i com ask mysef say why d whole loud noise? wey be say e obvious say dis person just start, i even offer to give am small info, him say na beginners knowledge i get lol, i come wash hand leave am oh  For Nigeria specifically people wetin people know much for crypto na airdrop and p2p trading. E no pass like that. Dem feel say once u sabi do p2p they take percentage for the people money you done learn be that, meanwhile that na just one side of crypto way no really dey necessary unless say you wan buy coin or sell coin to fiat. I guess the folks you talk about have no idea of major security practices, no idea of crypto investment and the real crypto trading way get to do with candles. Check out, e no go far these guys go open account they take 5k to teach people very soon.
|
|
|
|
SatoPrincess
Legendary
Online
Activity: 1876
Merit: 1182
|
 |
October 22, 2026, 05:20:15 PM |
|
Na so them dey do. Once them don sabi one strategy way dey give them small money, them don dey call themselves professional traders and guru. Next thing na to dey collect money from people say them go teach them how to make money from crypto. Give this guy from your story, one month of continued successful trades, he no go waste time before he go open trading academy.
|
|
|
|
|
BIT-BENDER
|
 |
October 22, 2026, 05:55:03 PM |
|
Well you may be right but not only newbie do this, by the way I think you should also be careful, it's not everywhere such discussions trading or anything finances in general are discussed you have to bring yourself into the discussion. Firstly you do not know who they are, they could be discussing that to lure people into the discussion and from that you could be a target victim. I believe strongly In anonymity and I would hardly endanger myself in such situations.
|
|
|
|
Odogwu-Blockchain
Sr. Member
  

Activity: 826
Merit: 340
NO DEPO CODE VEGAR7, NO KYC Casino
|
 |
October 22, 2026, 06:01:04 PM |
|
Na so them dey do. Once them don sabi one strategy way dey give them small money, them don dey call themselves professional traders and guru. Next thing na to dey collect money from people say them go teach them how to make money from crypto. Give this guy from your story, one month of continued successful trades, he no go waste time before he go open trading academy.
Lol, I can relate, e get wetin I see online, person dey advise say, all these screenshots of successful trades you see online na whining, say in real life, trading is very hard. Small trader go just apply small strategy wey go work for am by luck, I repeat, by luck. E go take loan open academy begin start to speak English dey teach wetin him no dey sure of. From my experience in the crypto space, I never see any academy wey don last and the student dey testify, e dey always close down, because the truth is hidden, and you know, truth will always prevail. The truth is that, trading is hard, very hard, very complicated, it's hard.
|
|
|
|
Biggeno
Jr. Member

Activity: 57
Merit: 7
|
 |
October 22, 2026, 06:28:04 PM |
|
Wetin you don talk so na wetin we Dey experience and at some point for our lives we don do that same thing until we either learn the hard way or we decide to stick to advice from people wey don Dey ahead of us…. I nor go sha blame the guy for a start, you know say when money just Dey enter your hand from one update wey you nor really know the foundation or person they one side they tell you make you do like this and like that, e come turn out say that method con Dey fish you money, e get this level of pride you go get for people wey you feel like say d below you….. But that one nai be the mistake wey Dey likely leave those set of persons for that position wey them Dey or draw them back to square one. One thing wey Dey very important while we dey on our journey to the top na humility… even that person wey you think say nor fit add any substantial thing to your life, em advice fit still go a long way na so life be.
|
|
|
|
|
|
Zigabel (OP)
|
 |
October 22, 2026, 06:50:41 PM |
|
Well you may be right but not only newbie do this, by the way I think you should also be careful, it's not everywhere such discussions trading or anything finances in general are discussed you have to bring yourself into the discussion. Firstly you do not know who they are, they could be discussing that to lure people into the discussion and from that you could be a target victim. I believe strongly In anonymity and I would hardly endanger myself in such situations.
Thank you very much, this thing wey you talk na true, dem fit use that pattern as set up wey be say person now go fall, dem go fit come do you bad thing, na my own mistake on my path be dat, when I see dat kain conversations na to dey avoid am make I no go put myself for talk. E dey possible sef say all this police or agencies fit use dat kain pattern for set up dey find who go fall make dem use am shine. To dey mind our business dey very important, except if na group of pipo wey be say I know in a way or dey close to enough to trust enough, den I fit join in, making sure I no dey at any risk. Dis na why e good make we dey bring up conversations like dis make we for fit dey advise each oda sometimes wey go help us do things beta, for me now, next time I don learn make I try dey my dey make i no go use my hand enta wahala
|
|
|
|
|
BIT-BENDER
|
 |
October 22, 2026, 07:19:45 PM Last edit: October 22, 2026, 10:53:24 PM by BIT-BENDER |
|
Thank you very much, this thing wey you talk na true, dem fit use that pattern as set up wey be say person now go fall, dem go fit come do you bad thing, na my own mistake on my path be dat, when I see dat kain conversations na to dey avoid am make I no go put myself for talk. E dey possible sef say all this police or agencies fit use dat kain pattern for set up dey find who go fall make dem use am shine.
To dey mind our business dey very important, except if na group of pipo wey be say I know in a way or dey close to enough to trust enough, den I fit join in, making sure I no dey at any risk. Dis na why e good make we dey bring up conversations like dis make we for fit dey advise each oda sometimes wey go help us do things beta, for me now, next time I don learn make I try dey my dey make i no go use my hand enta wahala
You are welcome, I understand say you were only trying to learn something new but your financial and personal security should always come first before any other thing. Them no the write Crypto-currency enthusiast or trader for face so this criminals will seek other ways to get their prospective targets, I am not saying that was the case of those guys but it's best to be safe than sorry. In between if the food you were eating was delicious you no go even try put matter for another person matter, you go fit try change the restaurant if at all.
|
|
|
|
|
I_Anime
|
 |
October 22, 2026, 08:11:36 PM |
|
Nah so e Dey be sometime , there’s this feeling wey Dey come when you newly enter the crypto space . Nah the same feeling still Dey bring the mindset of getting rich quick and stuff . The fact say dem nor understand privacy nah already sign shey Dem dey new to cryptocurrency in a whole .
The best way to learn more in this space , is through humility. Know Dey always do say you too know, e go always cloud your mind to learn new things . I also like to learn new things no matter how the individual tey Dey. Me I for still try learn something from them seff cause e get somethings wey some newbie know wey you seff nor know . Because information plays a vital role in this space.
|
|
|
|
|
rachael9385
|
 |
October 22, 2026, 08:22:20 PM |
|
After reading your words, I also thought of one thing, that many times we want to show off something in front of others if we can learn a little bit. But in reality, how much we know about something cannot be proven by talking big.
A lot of beginners in trading, investment and others are always quick to show themselves because they are too excited for people to see them in a certain way. Talking big doesn't really mean that a person is good at something, actions and results speaka louder and talking only attracts unnecessary attention. In a country like Nigeria, I think it is better to refrain from talking about your income or how much money you have invested in crypto in front of everyone. Because there is no reason to think that everyone will want your best.
Talking about your income especially if it's cryptocurrency as a Nigerian is very dangerous but it is possible not to talk about your source of income and still get attention. But it's better to be on the safe side and avoid saying somethings I'm public.
|
| ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | ██████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████
████▄▄███████▄▄███████▄▄█████▄██ ██▄██████▌█▄██████▌█▄██████▌█▀█▀ █▐████████▐████████▐███████████ █▐████████▐████████▐████████▄▐▌ ████████▌████████▌████████▌▐█▐▌ ████████▌████████▌████████▌█▀ ▐████████▐████████▐███████ ▐██████▀█▐██████▀█▐██████▀ ████▀▀███████▀▀███████▀▀ | Metaspins |
██████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████████ | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | | |
♠ 𝟕 ☘︎ ⚽︎ | | | | | | | | | | 🏆 | 15K WEEKLY LEADERBOARD | | ⚡ | INSTANT WITHDRAWALS |
| | | | . ..Play Now.. |
|
|
|
|
Merit.s
|
 |
October 22, 2026, 08:35:17 PM |
|
Na u suppose advice yourself because you just see people wey dey talk about trading, you go dey show interest because say the guy talk say e dey make profit weekly. Sometimes, e fit be say them purposely dey discuss this kind matter just to know people wey dey into crypto because just as you put mouth for their discussion, e clear say you know about crypto. If really say them dey look for crypto person to rob, you don carry yourself give them.
Why I talk this because if say then calm down give you time to explain, you for talk more about bitcoin to them but because the guy say you still be beginner, na e make you lock up. Don't involve yourself with bitcoin discussion with strangers because you don't know if they are for real or looking for someone to rob.
|
|
|
|
Wiwo
Legendary

Activity: 1946
Merit: 1127
BiggerZ.com Ambassador - Ready to Help
|
 |
October 22, 2026, 08:56:53 PM |
|
C Mon, the guy is obviously a trader and doesn't give a F about wallet or custodial security.
His interest os on exchange and not wallet as far as he can trade and exchange his profits through p2p on the exchange; he may feel OK with that.
You, as an advanced person, can easily spot his problems and limitations in the cryptocurrency ecosystem, but he will never agree with your own points of view.
|
|
|
|
Nasdel4
Member


Activity: 168
Merit: 45
|
 |
October 23, 2026, 12:34:03 PM |
|
A lot of newbies fall into this category and I just don't understand why. It's okay to be excited about your wins but not to the extent where your security is at risk. I've seen people do this a lot and if you actually find out you'll come to realise that most of them don't really have deep knowledge about what they're talking about, some just do that to get attention from their peers and seek validation that they took are informed. This could lead to you actually missing out of vital information that could have helped you elevate your skills in whatever direction you're heading. Like I said it's okay to be excited but don't let it get to the extent where you compromise a lot to your disadvantage. Someone might be listening and with the rate at which crimes are perpetrated you can't be too careful.
|
|
|
|
|
CryptopreneurBrainboss
Legendary
Online
Activity: 2996
Merit: 5258
BiggerZ.com Ambassador - Ready to Help
|
 |
October 23, 2026, 02:41:43 PM |
|
i just say make i talk am say make we try no dey find oursef for dat kain settings make we no go drag eyes put for our bodi, use your knowledge beta your life dan to show off say you sabi any tin, try dey humble, nothing be d tin las las, d person wey you no give levels fit sabi wetin you no sabi wey be say you go need, but pride go make you miss am. No need to show off or try to prove anything, make e no put yoursef for security risk, try dey low key, E GET WHY.
Life no suppose just hard at all but we no just sabi package/arrange life na why e dey belike say life done dey hard. You teach when you speak and you learn when you listen so you suppose they listen more than you speak but everybody wants to be the loudest in the room and as such they don't learn anything. The wise allow others to speak because when they speak, they let out their secrets and expoe all the knowledge they have while the wise/smart listen attentively but no be say them no know wetin to talk instead they allow their silence do the talking for them. Those that go around looking like the smartest aren't always the ones but you see these calm ones that don't talk, they're actually the smarter ones because smartness knows how to disguise themselves as fools but the fools likes to look smart always. Remember empty vessels make the loudest noise so following OP advice isn't a bad strategy to use in life.
|
|
|
|
blackisbeauty
Newbie

Activity: 9
Merit: 0
|
 |
October 23, 2026, 03:27:59 PM |
|
Well you may be right but not only newbie do this, by the way I think you should also be careful, it's not everywhere such discussions trading or anything finances in general are discussed you have to bring yourself into the discussion. Firstly you do not know who they are, they could be discussing that to lure people into the discussion and from that you could be a target victim. I believe strongly In anonymity and I would hardly endanger myself in such situations.
What is even the essence of talking and making yourself known, to learn from them? A public place is not the best place to learn about something, unless the knowledge is just shared randomly and you could learn one or two. But approaching and asking questions just anyhow is really not too good. Some people can intentionally come into a public space like that, raise such topics loudly to lure people to begin to talk, and from there, they can get one or more contact that they can can find ways to defraud or carry out some bad plans. Many have gotten into trouble just like that. Since the crypto stuff gives me the privacy, infact Bitcoin particularly, there is no need speaking up anyhow especially in public. I love really love my privacy a lot.
|
|
|
|
|
Cityhunter34
Sr. Member
  

Activity: 1092
Merit: 358
AnonChange.com
|
 |
October 23, 2026, 03:42:00 PM |
|
i just say make i talk am say make we try no dey find oursef for dat kain settings make we no go drag eyes put for our bodi, use your knowledge beta your life dan to show off say you sabi any tin, try dey humble, nothing be d tin las las, d person wey you no give levels fit sabi wetin you no sabi wey be say you go need, but pride go make you miss am. No need to show off or try to prove anything, make e no put yoursef for security risk, try dey low key, E GET WHY.
These newbies always overdo things; once they start journey, they start talking anyhow in public. Just imagine if you were a bad person, I think you would harmed them. That's why we they always say we should try to keep our investment secret, because you don't know who is against you. Honestly, I dey always like the way most of us behave in public; we always pretend like say we don't know about Bitcoin investment, but immediately you feel like you're the one who knows, we will come out to correct you. Bitcoin investment is not about noise or power, because we learn different things every day, so let's not act like we know more than others.
|
|
|
|
|
Tungbulu
|
 |
October 23, 2026, 06:19:49 PM |
|
Na so them dey do. Once them don sabi one strategy way dey give them small money, them don dey call themselves professional traders and guru. Next thing na to dey collect money from people say them go teach them how to make money from crypto. Give this guy from your story, one month of continued successful trades, he no go waste time before he go open trading academy.
This na the reason why anything or anybody wey I see online wey dey pos as professional, whether na for trading o, or even investment, na me go be the last person wey go answer that kind person, even though say them dey drop proof of profits. I don dey around the sphere for sometimes now and with wetin I don learn so far, I fit know for sure say e no get any strategy wey fit dey continuously dey give person money like that. Make I rephrase that talk, e no get any strategy wey dey always dey give profits without losses, and anybody wey present that kind offer na either fraudster or him no sabi wetin him dey talk.
|
|
|
|
|
Marykeller
|
 |
Today at 09:19:07 AM |
|
Try to d dey on low key, e get why, as we d always advised cos peso no know who d observe them from within. Some people don't know sae they get attacked from the impression or yarnings they simply make outside, to prove to friends or outsiders sae they don't make am for life, not knowing that na their life them d endanger so.
People supposed learn to comport themselves. If they earn millions monthly or weekly, they should stay calm and zip their mouth. Be the one to learn and accept corrections, not always claiming they have arrived and knows it all, no need to be corrected on the things they are into
|
|
|
|
Crakryptvest
Full Member
 

Activity: 308
Merit: 202
BiggerZ.com Ambassador - Ready to Help
|
 |
Today at 12:48:50 PM |
|
This na the reason why anything or anybody wey I see online wey dey pos as professional, whether na for trading o, or even investment, na me go be the last person wey go answer that kind person, even though say them dey drop proof of profits. I don dey around the sphere for sometimes now and with wetin I don learn so far, I fit know for sure say e no get any strategy wey fit dey continuously dey give person money like that. Make I rephrase that talk, e no get any strategy wey dey always dey give profits without losses, and anybody wey present that kind offer na either fraudster or him no sabi wetin him dey talk.
As I come know say even people wey dey there bedroom the look for who the wan job na professional trader, me I just look and anyone wey make mistake hit me up, I go immediately tell them say make them go rest leave people make them rest, pesin no fit junx me for that kind thing. But make we tele ourselves the truth na because of say we know these things na em make we the talk say no strategy wey wey the work consistently, who knows wetin those people wey no no how trading the be don suffer for the hand of those men them, e just be like when person come tell me say sure game dey for gambling, I go just laugh first.
|
|
|
|
|