The reason behind this topic is quite simple based on the economic situation of the country. It's been proven that the best strategy so far in the accumulation of bitcoin is the DCA method but looking at the financial situation of the current Nigeria where inflation is the order of the day, how many Nigerians can truly generate wealth through bitcoin?
Another factor I looked into is the level of unemployment and the struggle to save money. We are aware of the rate of employment, those who are able to get good jobs and earn still need to have emergency money and some savings before thinking of buying bitcoin especially when he pays high bills.
Considering that many people earn below the minimum wage, can we say that Nigerians accumulate bitcoin?
As an average Naija person wey don Taya for suffer for this country e nor go take you anything to invest for Bitcoin because you wan come out of your current financial problem if not you go dey continue to suffer forever, na to just gather yourself well well and double your hustle so that you go overcome poverty once and for all because Bitcoin na sure investment wey if you take serious go save you from poverty .
The way u Dey talk, you Dey talk like say e easy. Difference Dey between person wey get source of income, Dey live within him means, e no too get but they live comfortable, fit provide at least him basic needs and person wey be sey Dey struggle to survive or Dey inside poverty. Person wey Dey struggle to survive, e Dey even hard for that person to provide their basic needs because of hardship and I know think say this set of people fit even invest because e even hard for them to chop or live comfortable. But the one wey be say atleast they manage live comfortable and provide his basic needs, even though him no get too much fit look towards that direction of investing and secondly no make am look certain like say na everybody wey invest for bitcoin, nai go Dey save from poverty.
So far you dey survive for Naija you fit buy Bitcoin, because inside this hardship wey you dey talk, people still dey do akawo, make i sey your akawo mainly na to meet up your needs for the year, what if you divide am into two, use the second half dey invest for bitcoin monthly using your dca, den the second half go akawo, e still better, everything na determination except you nor ready.
Hope say u know say people wey Dey do akawo Dey even do with the list #100, this one na for the set of people wey no get, how them wan divide this money use invest?
To invest is very good but if e no Dey, make nobody punish themself just because them wan invest, only do it when you know you can be able to keep up and accumulate a reasonable amount of bitcoin, so no one will be left with the option of wanting to sell of their bitcoin within a very short term just to survive and end up to stop investing.