And my question is who are the thugs, and are they among the Nigerian securities? Or are they government officials or not? and why are they exist without the government's approval and caused problems and government are silent..?
Please i want to hear the opinion of you all, because I don't really understand what is going on in this country..
By now u suppose know how things Dey work for dis country now. All those thugs wey u Dey see, dem no be security operatives, but u suppose know say d government know about them. Na all those thugs na him our politicians Dey use during election, na government Dey even give them weapons wey dem Dey use attack people, na dem Dey do dirty work for d government, so Wetin u expect make them talk.
During elections, na those thugs Dey rig election for our politicians, na them Dey give those thugs weapons wey dem Dey use attack, Lemi say na still people wey Dey power Dey send those boys, so Dey just have to look at them when they are doing their own activities.