Bitcoin don dey gain attention for everywhere but many Nigerians dey look am less con dey feel say na only rich people fit do am.some people fit no sabi how or where to start.
The truth be say you no need to get plenty money before you fit learn bitcoin.you go first know how e dey work and the risk wey dey involved before you try am.
No be every opportunity go dey wait for you,at least make you try learn howto invest first then you go dey put money small small,make una drop wetin una think about this matter abeg.
The thing u dey talk no be only for naija here e dey affect. Na worldwide problem, many people dey wey never dey reason bitcoin for the world.
Even with the way you Dey feel say Bitcoin awareness don reach na about 4-5% of the world population dey invested in bitcoin. You wey don hear about am now, hope say you sef dey invested ooo? Make you no b talk without Do!.