Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: uchegod-21 on April 10, 2024, 08:19:06 PM

Title: E no resemble local board.
Post by: uchegod-21 on April 10, 2024, 08:19:06 PM
As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover.
https://www.talkimg.com/images/2024/04/10/jdXyG.jpeg
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Charles-Tim on April 10, 2024, 08:28:44 PM
I see the topics more as Nigeria local discussions.

Having the title or the post in Pidgin is not necessary. If you like, post in English. If you like, post in Pidgin. We do not have to force anyone to post in Pidgin.

You can go through the topics and threads generally and see that it is still about discussions of Nigeria and what that supposed to be in Nigeria local board. It can be politics, economy or whatever but it is still about Nigeria discussion which is what that matters.

Please, we are having peace already, no need of bringing what is not.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: uchegod-21 on April 10, 2024, 08:34:57 PM
Having the title or the post in Pidgin is not necessary. If you like, post in English. If you like, post in Pidgin. We do not have to force anyone to post in Pidgin.
For my post above, where I force person to post for pidgin. Abi I no dey entitled to my opinion again?

Please, we are having peace already, no need of bringing what is not.
E get the time wey war dey for here? I no too understand the way you carry respond to this post, hope say nothing sup.
Anyhow anyhow, I believe say people done understand wetin I post. People wey go first make their title to be pidgin go try from henceforth. Person wey no fit go continue for English, e simple.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Charles-Tim on April 10, 2024, 08:40:33 PM

No vex if my post looks like an attack. What I just felt is that we should leave people to make their own choices.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Amphenomenon on April 10, 2024, 08:56:11 PM
Having the title or the post in Pidgin is not necessary. If you like, post in English. If you like, post in Pidgin. We do not have to force anyone to post in Pidgin.
For my post above, where I force person to post for pidgin. Abi I no dey entitled to my opinion again?
I get what Charles-Tim means here, is just that our LB is not like other LB that make give strict restriction on the language accepted there, while here we can both use english and pidgin mainly some of us here have use igbo and other of our local language and also though its an Opinion, the topic title doesn`t show it that same way.

Please, we are having peace already, no need of bringing what is not.
E get the time wey war dey for here? I no too understand the way you carry respond to this post, hope say nothing sup.
Anyhow anyhow, I believe say people done understand wetin I post. People wey go first make their title to be pidgin go try from henceforth. Person wey no fit go continue for English, e simple.
[/quote] To be frank you know there are usually alot of drama on our LB which is has been dying slowly I guessed that what he meant here, also with your reply here you can actually see there is no need for this post since those who want to use pidgin will use it while if they don`t feel like they may use english.
bcos me self dey use both, na how post tel move na matter if I go use pidgin or English

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Davidvictorson on April 10, 2024, 09:30:15 PM
As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover.
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.
I understand wetin you dey talk.
In the beginning, I bin try to advocate for this but e be like say that one nor fir work so I gave up on the idea. I personally, want to see more topics for pidgin but if wishes na horses.

Another reason for this fit stil because o this Hatchy merit thread (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5484607.0). Allow quote the question wey I been one ask am before him lock the topic.

Yea thanks for that. I guess I didn't think about that at first. Pidgin is a local language and any merit source that would review post from my local board must be a native speaker to be able to do review. I'll distribute the merits as requested.
Well done Hatchy. You are contributing positively to the growth of the Nigerian Local Board and I am impressed.

Please correct me if I am wrong but from what I understand from the text above, it implies that only topics written in English qualifies to receive merits not because it may not be a high quality post but because the reviewer will understand it better since he is a non-pidgin-English speaker. Right?

We sure need the Local board Merit source applications to be approved ASAP.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Hatchy on April 10, 2024, 09:41:06 PM
Well, I get watin @ uchegod-21dey try talk but as @ Charles-Tim talk am, e no really matter. Our local board get two language wey be pidgin and English so person fit create anything wey e like as long as e fit create watin people Dem go fit discuss put.

Another reason for this fit stil because o this Hatchy merit thread (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5484607.0). Allow quote the question wey I been one ask am before him lock the topic.
No vex say I lock am bro. I no first get intension to dey lock the thread before but person wey dey our local board give me neutral tag just because I open am. D person request say make I lock am so I just rest. :'(

Quote
Well done Hatchy. You are contributing positively to the growth of the Nigerian Local Board and I am impressed.

Please correct me if I am wrong but from what I understand from the text above, it implies that only topics written in English qualifies to receive merits not because it may not be a high quality post but because the reviewer will understand it better since he is a non-pidgin-English speaker. Right?

We sure need the Local board Merit source applications to be approved ASAP.
E wan resemble watin you talk but no be so Sha. As we know, merit sources Dem na obodo ibo people Dem. And these people Dem no dey speak or fit read pidgin like that. So even though say we ask for help, Dem fit no review the threads because Dem no fit read am well. Dat one no mean say na only English post them go dey merit or na e qualify. Sha From watin @1meau talk like this, e mean say we go really need to fight once again for merit source. Although we don dey fight for Long but no reply from admin them.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Churchillvv on April 10, 2024, 10:05:13 PM
~snip~
I totally grasp what you meant with this post but for some they may not really understand it from your perspective but everyone is right at the same time.

From a clear understanding what you mean is that we should try to make our titles and posts with pidgin language in order to privatize our discussions than open them in English, making it as readable for everyone in the forum unlike other local boards where if you don't understand their lingual Franca you can't relate to what's going on there. So what you're saying indirectly is we should put more effort to use our LB language than the general language in the forum hence it will protect us from what we call "See finish" by the merit sources and other colleagues.

It's still a good idea, I like it but my problem is I'm not too good at writing in pidgin but from now i will try my best to pass some information through pidgin. Since both English and pidgin are acceptable in the local board we can still mix them when necessary but as long as information is being passed it's fine by some people that's what exactly most people are trying to say too.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Lida93 on April 10, 2024, 10:36:59 PM
Having the title or the post in Pidgin is not necessary. If you like, post in English. If you like, post in Pidgin. We do not have to force anyone to post in Pidgin.
For my post above, where I force person to post for pidgin. Abi I no dey entitled to my opinion again?

Please, we are having peace already, no need of bringing what is not.
E get the time wey war dey for here? I no too understand the way you carry respond to this post, hope say nothing sup.
Anyhow anyhow, I believe say people done understand wetin I post. People wey go first make their title to be pidgin go try from henceforth. Person wey no fit go continue for English, e simple.
my people make una calm down first, ona blood too the hot. ;D

Although I understand where uchegod-21 dey drive at with the aim of him post and eim no bad at all onto say him want make the local board get the Naija pidgin outlook very right from the post titles as a visitor visit make him feel the odour from there before him enter inside the thread to see discussion. No be for English to just overshadow the whole board frontage. But the thing now on the other hand nah say the board the entertain both English and pidgin writings so nah which one the poster dey okey with nah him go use. Na so the matter just be.

The only thing we fit do here now na to just the persuade and encourage our people make the the rub body with the pidgin language for their post titles where necessary to retain that uniqueness with other boards, make every every no just the be pure English.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Wiwo on April 10, 2024, 10:51:58 PM
Having the title or the post in Pidgin is not necessary. If you like, post in English. If you like, post in Pidgin. We do not have to force anyone to post in Pidgin.
For my post above, where I force person to post for pidgin. Abi I no dey entitled to my opinion again?

Please, we are having peace already, no need of bringing what is not.
E get the time wey war dey for here? I no too understand the way you carry respond to this post, hope say nothing sup.
Anyhow anyhow, I believe say people done understand wetin I post. People wey go first make their title to be pidgin go try from henceforth. Person wey no fit go continue for English, e simple.
No vex if my post looks like an attack. What I just felt is that we should leave people to make their own choices.
The matter clear na just mis understanding, if not both of una mean the same thing,  because in as much as e be say we get the freedom to yan in clear English for this board, e still dey important make we dey try make the local board look more organic or representing the multi lingua board which is English/pigin,  any ways the thread call for more pigin discussions,  while charlse make emphasis on the accessibility of the current English topics trends as acceptable also.

E clear like that, I been don't the losgard my pigin skills since majority of my comments lately come be English,  but never mind na because most pf the comments na about bitcoin or cryptocurrency related topics.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: odunybiz on April 10, 2024, 10:58:58 PM
I see the topics more as Nigeria local discussions.

Having the title or the post in Pidgin is not necessary. If you like, post in English. If you like, post in Pidgin. We do not have to force anyone to post in Pidgin.

You can go through the topics and threads generally and see that it is still about discussions of Nigeria and what that supposed to be in Nigeria local board. It can be politics, economy or whatever but it is still about Nigeria discussion which is what that matters.

Please, we are having peace already, no need of bringing what is not.

OP should know that it is not everyone that are capable of writing in pigin. I as an example, I'm not perfect when it comes to writing in pigin. Since the board isn't against using normal English in writing. Therefore, one can express it's content in English. What matter most here the content and not the look of the thread.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Davidvictorson on April 10, 2024, 11:05:16 PM
E wan resemble watin you talk but no be so Sha. As we know, merit sources Dem na obodo ibo people Dem. And these people Dem no dey speak or fit read pidgin like that. So even though say we ask for help, Dem fit no review the threads because Dem no fit read am well. Dat one no mean say na only English post them go dey merit or na e qualify. Sha From watin @1meau talk like this, e mean say we go really need to fight once again for merit source. Although we don dey fight for Long but no reply from admin them.

Thank you replying here and I grab
Wetin I dey think now be say pidgin English fit follow too. And the kind of pidgin posts wey fit follow na like all those translation posts as that one dey easier to understand because him to merit the person based on the effort wey the person put and just like to say thank you to the translator.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Majestic-milf on April 10, 2024, 11:07:44 PM
 Baba you tok something wey really enter body. Twale for you. I know say rules bin dey stated wey permit the use of English for this our board but e come be like say many people come dey misuse this advantage. The time wen our big ogas been dey fight for this section I no sure say the aim na far am to be majorly English if not we for no call am naija local board. The essence of championing for this place nah be say we too go get were we fit freely nack the pidgin without fear of being misinterpreted or accused of speaking wrong English but at the same time just so that those wey pidgin and then no dey waka the same street no go feel left out go fit put their own, nai make I feel say the rule makers for this board add English.
 Nai make till today I respect how our big bros @Mpamegbu hold that him thread proverbs in pidgin down, him make am strictly on pidgin so that we fit still get a taste of that our naija vibe. Believe me, e no mean say we go be aje kpako if we nack pidgin, e just be our way of identifying ourselves.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Cryptomultiplier on April 10, 2024, 11:27:42 PM
I see the topics more as Nigeria local discussions.
Very true. A lot of changes has happened over the time and I see that even the newbies have somehow improved on their post quality and style of topic presentation.
Also, the fact that this local board is just a bit Chunk size of the whole Bitcointalk forum platform and with enough discussions not being segregated, it makes it easier for newbies and even oldies to be more active and expressive with their own world views.

Quote
Having the title or the post in Pidgin is not necessary. If you like, post in English. If you like, post in Pidgin. We do not have to force anyone to post in Pidgin.

You can go through the topics and threads generally and see that it is still about discussions of Nigeria and what that supposed to be in Nigeria local board. It can be politics, economy or whatever but it is still about Nigeria discussion which is what that matters.

Please, we are having peace already, no need of bringing what is not.

Hehehehe, abi o. Leave us to enjoy our peace o. Naija wahala don too much already to dey bother about Pidgin English or Native English or Queens English. The Koko be say we communicate in the language that we as Nigerians can understand.
However, if you check the local boards of other countries, you would notice you can hardly understand their conversations, unless it's in English and that's why I may be tempted to agree that with pidgin English, we can be more free to express ourselves, but not all of us here would still understand the pidgin English or be able to type or discuss with it here fluently and most importantly, merits hardly get earned for post or comments in pidgin English.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Hewlet on April 11, 2024, 09:51:26 AM
Nothing really de sup for this matter. If what you are posting requires you to use the simple and correct English, it's not out of place to do so. If you're passing a sensitive information that requires you to code it somehow, that's when using pigin can become necessary. Normally most of us de like to blend both good English and pigin for our daily conversations and na why e be like say we de do same for our local board discussion.

What we have to understand is Nigeria is not like most other countries that have a general local language that's unique and popular such that all members can use it. The pigin when some persons for this place fit speak fluently, others fit no de comfortable with am and we no go fit force them to de use wetin dem no de used to. If you can comfortably make your post with pigin in a way that's easy to comprehend, you can do it without any hesitation but if you can't, it's best to do what works well for you and do it in line with the boards rules and regulations.

What should be talking about is how to improve on the quality of our local board post and also work on ensuring that our naija newbies don't go to the English board tarnishing our local board image. To me, that's one of the serious issues we should be concerned about.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Majestic-milf on April 11, 2024, 12:04:25 PM

What should be talking about is how to improve on the quality of our local board post and also work on ensuring that our naija newbies don't go to the English board tarnishing our local board image. To me, that's one of the serious issues we should be concerned about.
I get wetin you dey try yarn but baba, nah when you get something you go try not to abuse am, the Koko be say we dey slowly turn here to English board and if go you go fit dey honest with yourself, you sef go see say nah true Op dey talk. E no go make sense say we go carry mata wey we suppose tackle for here as our board dey go oda boards dey yarn.
 This mata of posting majorly in English for we this we cabal just resemble wetin dey happen for naija; we leaders no wan beta the country but rather prefer to go other places and dey see those areas as superior to our own.
 Make I no cap careless but e get the way we go dey back the thing, doz our pipo from other boards go wan like to learn sef...make we no dey shame for this pidgin as e look to me say nah wetin we dey do..

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Sexylizzy2813 on April 11, 2024, 12:12:45 PM
As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover.
https://www.talkimg.com/images/2024/04/10/jdXyG.jpeg
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.

Uche my senior oga no be lie you talk and from how things be for here e make here look like say outsiders fit come post for this place and e dy pain me say some of this our senior piple wey don tey for this place, wey follow struggle to make here be wetin e be today no fit speak out say make everybody respect this LOCAL BOARD to maintain the pride wey we get as Nigerians just as other local board them dy do.
Make una go somewhere likeTurkish local board weda you go fit understand wetin them dy talk without using Google but if them come here na so all these piple wey we get as brodas and sistas go dy use English as if them dy wen English enta our contri, to say the truth this one follow for why this place no dy as fun as e bin dy before and some members (like Mr Obari and the rest of them) no get that joy to dy come here as before too... Make all of una wey think say una sabi English do well oh... Make pride leave una oh.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Obari on April 11, 2024, 12:34:37 PM

The truth be say ,  one major reason why I leave the board na say, I no been want any problem with anybody because I been don Dey notice plenty shit wey people Dey do without  feeling any guilt.
Plenty of us go don notice say a lot of issue Dey fly around about us and one major reason na because most of us no even sabi write for pigin english and I no Dey blame anybody because this pigin no really easy to write.

Another issue wey need attention, na the matter wey concern love and respect wey we really Dey lack for the board and a lot of users Dey forget say we still get lives to live outside of the forum and as such suppose Dey respect ourselves but the forum don make am seem like say everybody na the same and equal wey truly no be so.
Make we allow love lead and reason everybody matter with respect.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: EluguHcman on April 11, 2024, 12:45:38 PM
The truth of this pidgin and English language in use here in the forum is basically considered based of easy communications of individuals.
This one no be claiming, almost all of us in this country Nigeria comfortably communicates with the pidgin language which is our general language since there are excessive diversities with different languages spoken in the country.

The unique side of it here is that most of us who comfortably flows with the pidgin finds it hard to construct readable and understandable texts which others can relate and communicate along with.

There are numerous pidgin language threads in the forum which I have not come across anyone complaining about why pidgin is being used on the context but I have seen where most persons films their pidgin texts in a way that it is complicating to understand what the message the writer is trying to pass to the forum. Definitely this could be cause that such forum users is trying to force in just to flow with the pidgin language.
Lot of forum users complicating their contexts has been guided to use English language of they finds the pidgin language uneasy during communication and that has also brought some easy to the forum saving us some stresses on how we could relate to others threads.
Maybe this could be why @Charles-Tim means we are having peace at the moment.

Let's just say sometimes what has an advantage would do have disadvantage at the other hands, sometimes ago, one of us raise an alarm that the forum is flooded with English language which was supposed to be all about pidgin and for that, there is no privacy observations for us in the local board. The forum users might be right or not because there is no tense of secretive ideals to be shared amongst us which other forum users are to be deprived from learning about.

Let's understand this fact that we are not here in the local board to promote our pidgin local language but to discuss about specifically bitcoin related issues and activities going on in our environment at large.

Let's also consider the @Hatchy merit Campaign thread which the merit source @1miau made clear that he is unable to relate with what some of the supposed quality posts referred by Hatchy is talking about. This is also one factor we should be considered. We actually never saw that coming and therein it was kind of a barrier for a foreigner to contribute productively here for the growth of our local board.

To me, let's just keep rolling with any form that we can communicate so effectively.
We are Naija and after much disagreement of some of our fellow members here on this very thread, I hope we still agrees at last because we are just one of a family as long the forum is concerned.
✌️

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Stable090 on April 11, 2024, 10:07:53 PM
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.
Me I understand Wetin u dey talk, e no really go well, me I dey hardly post with normal English for dis place, the highest wey I dey do, if I dey use pigin talk, some places dey wey I fit just use normal English, then go back my pigin again. I dey like if I dey post make people wey no dey dis local board no understand Wetin I dey talk, any outsider wey come go just dey look my post, him go dey confuse.

From this title wey you dey talk about, seriously nothing wey we go fit do about am, because the rules for the local board na say make we dey use both English and pigin communicate, and you no fit force anybody to post with any language they want, as long as they are not going against the local board rules, but the only thing wey dey na to dey encourage people make dem dey use pigin often, even if dey wan write topic e go make sense like that pass.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: DaNNy001 on April 11, 2024, 10:27:00 PM
As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover.
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.
Well my brother I know why I missed this your topic since but as I see am sef e never too late to shuk mouth put, for me watin I believe say the actual reason wey make dem give us this our local board na unto say we dey active well well but the clear fact na say we get local language which is the general pidgin because I believe if to say who ever dey give local board come hear na English we wan dey write and communicate here, I for reason say maybe he fit no even grant the request.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: nelson4lov on April 11, 2024, 10:28:29 PM
Sometimes when you come see some things as e be, e just dey best to go with the flow. I used to have some differing opinions about the English vs Pidgin as mediums for discussion in the local board but my views been don change since. The truth is that Pidgin is not even our local language but is passed as such.

The way I think about it is this: If English speaking countries like US get local board on the forum, their conversations go still dey for English but it would just be centered on matters concerning their country and very little weight on sharing discourse in languages only them with understand.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Mate2237 on April 11, 2024, 10:39:10 PM
Really when dey dey enter other local boards we dey see say one English sef we no go see but here in our local board na only English we dey sef and when someone say why we dey use English hen plenty people go come attack di person say why him go talk dat kind things. Normally using English here e no make sense but not everyone can use the pidgin English to write fluently. But even as dat no Nigerian no go fit use small pidgin write it do person finish secondary school and dey write for here abi na England she go school?

Sometimes when other local boards go mentioned my name I go enter their I no understand anything so I would just carry my head come back again but here. Anyone wey come here go understand everything finished. Nai be another problem dem dey attack us well well for outside Board.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Coyster on April 11, 2024, 10:41:54 PM
I think say we don bury this discussion about either using pidgin or English, either as post subject or content of our post for this local board. I dey use the two of them, e dey depend on wetin i wan talk and on my mood at the time of making the post, both English and Pidgin is allowed, and you fit even mix the two of dem for one post, just as i am doing now.

Why are you concerned about wetin non-Nigerians go think when they visit our local board, check the Indian local board (https://bitcointalk.org/index.php?board=89.0), na posts for English language full there, because English follow for language wey dem dey speak well well for their country, just like in ours. So make we just die this matter, na quality posts matter, be it in English or in Pidgin.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Smartvirus on April 11, 2024, 11:44:18 PM
Having the title or the post in Pidgin is not necessary. If you like, post in English. If you like, post in Pidgin. We do not have to force anyone to post in Pidgin.
For my post above, where I force person to post for pidgin. Abi I no dey entitled to my opinion again?

Please, we are having peace already, no need of bringing what is not.
E get the time wey war dey for here? I no too understand the way you carry respond to this post, hope say nothing sup.
Na watin I been wan recount shah, the time way we been Dey argue here which of the language we go like put for front for the locale and we later resolve to use both Pighin and English via say, both na spoken tongue for we Naija. Some people even come up with threads way you go speak Yoruba and some other major tribal language but all that don die down now shah, the plenty English don wash them commot so, I see watin you Dey try talk at OP.

I for like am well well to come here Dey read pighin o but, the fight has always been based on interest and watin Dey comfortable with everybody. So everybody fit pick sides and participate. Everybody or most people fit speak but, no be everybody fit write and you wonder how…?

Meanwhile, e go first Dey rock am Dey go like this.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: uchegod-21 on April 12, 2024, 06:36:09 PM
Really when dey dey enter other local boards we dey see say one English sef we no go see but here in our local board na only English we dey sef and when someone say why we dey use English hen plenty people go come attack di person say why him go talk dat kind things. Normally using English here e no make sense but not everyone can use the pidgin English to write fluently. But even as dat no Nigerian no go fit use small pidgin write it do person finish secondary school and dey write for here abi na England she go school?

Sometimes when other local boards go mentioned my name I go enter their I no understand anything so I would just carry my head come back again but here. Anyone wey come here go understand everything finished. Nai be another problem dem dey attack us well well for outside Board.
My brother. I tire o... I know when the argument of pidgin and English dey arise here. Me I dey in support of freedom, but then we go need to protect our own. I no get problem with whatever language anyone wan use but I just dey beg us say make more pidgin dey. The post na to reawaken our consciousness to make more pidgin post and put pidgin title but some people no understand.

As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover.
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.
Well my brother I know why I missed this your topic since but as I see am sef e never too late to shuk mouth put, for me watin I believe say the actual reason wey make dem give us this our local board na unto say we dey active well well but the clear fact na say we get local language which is the general pidgin because I believe if to say who ever dey give local board come hear na English we wan dey write and communicate here, I for reason say maybe he fit no even grant the request.
My brother, that thing you talk na the truth. If to say na English all of us dey knack here, no local board for us...

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Coyster on April 13, 2024, 06:24:22 PM
My brother, that thing you talk na the truth. If to say na English all of us dey knack here, no local board for us...
That one no be true, did you see the Indian local board wey i link for my last post in this topic, so many of the topics and posts there is in English language and i no sure say anybody dey complain there. Even if most of the posts here is in English, there is gonna be no problem with that, English na our official language in Naija and we dey only use pidgin for mostly unofficial purposes for Naija, so using English language in this board does not negate the fact that it is a local board.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Belarge on April 13, 2024, 10:10:13 PM
My brother, that thing you talk na the truth. If to say na English all of us dey knack here, no local board for us...
Everybody wan carry eye see job, nobody is ready to lose because people go dey complain about the services been render while their bosses ask of sex from them, it's a normal thing but not everybody like that kind of thing. If any officer try am come where i dey, i promised myself to break e head, this world de advanced. Our local board dry try small small. Make we first rest small in the eye of these top men and at least released these top men.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Cryptoprincess101 on April 14, 2024, 07:37:36 AM
You need to understand that even though we prefer pigin English as our general language but yet it is not because an outsider wey read pigin carefully go understand wetin we dey discuss for here so make we just manage am like that dey post both pigin and correct English because all dis tins naim be the wayo wey Oyibo people play us because had it been say we get our own common language e for no dey like dis, even some Oyibo people wey dey our country no dey waste time understand pigin so there's no cause to prioritize any language in the local board.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Uhwuchukwu53 on April 14, 2024, 09:37:06 AM

The matter na ogboge one becos waiin op yam for one side get in truth but waiting dey inside be say as another person fit understand pegin beside some of our brother and sister for d board fit no write with am but fit read am for me a for talk say as much say the information kajad and na waiting we need for the board make we no reason am wether na pegin.

Cryptoprincess  dey yan now true for my work place e get one German forman wey we get for dere d man na pegin ooo English him now sabi if you dey feel say na pegin for dat kind person the more you exposed your secret because him na father of pegin many oyibo way there language no be English they use pegin like us just that na the tongue difference gi make you feel say they are correct but if they write for you no pegin.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: sokani on April 14, 2024, 02:39:29 PM
We don torchlight dis mata before and we agree say make we dey use both languages on di LB. Di reason wey be say people dey write more in English dan in Pidgin fit be say English posts dey get more merit dan Pidgin posts, because apart from di translation topics, e dey hard for foreign members to stroll enta our LB and begin dey give merit to posts wey dem no understand. Maybe when we get our own local merit source, di number of posts in Pidgin go increase.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: SmartCharpa on April 14, 2024, 07:06:45 PM
The pigin when some persons for this place fit speak fluently, others fit no de comfortable with am and we no go fit force them to de use wetin dem no de used to. If you can comfortably make your post with pigin in a way that's easy to comprehend, you can do it without any hesitation but if you can't, it's best to do what works well for you and do it in line with the boards rules and regulations.

E be like say you dey misunderstood waiting Op dey try to yan for here, he no talk say they should force anyone to do their post with pidgin, but e get as the matter take be. If you look at the picture he share so, almost the topic na English and if you look at the other board i believe say na their native language them dey speak there. We know say naija we no get native language but make we try dey put pidgin for our post, e fit bring more improvements here because no be everybody like to dey stress their sef over big big grammars. Person fit see post wey make sense but if they see say the English too big for them, they will just ignore the post.

If some of our newbie see say we dey paint everywhere with English dey may not get interest on this board again, some sef fit no dey active again. ;D ;D

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Sexylizzy2813 on April 14, 2024, 10:51:21 PM
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.
Me I understand Wetin u dey talk, e no really go well, me I dey hardly post with normal English for dis place, the highest wey I dey do, if I dey use pigin talk, some places dey wey I fit just use normal English, then go back my pigin again. I dey like if I dey post make people wey no dey dis local board no understand Wetin I dey talk, any outsider wey come go just dey look my post, him go dey confuse.

If many of these English piple reason am d way you reason am we no go get issue for this matter but them make some of us look like say we no follow for the bookuru matter, but you see that part wey u use some part of your post for English and later reverse to pigin dy confuse outsiders wey dy come look how we dy e still make sense, no be every time we go dy sell ourselves for this unit.

Quote
From this title wey you dey talk about, seriously nothing wey we go fit do about am, because the rules for the local board na say make we dey use both English and pigin communicate, and you no fit force anybody to post with any language they want, as long as they are not going against the local board rules, but the only thing wey dey na to dey encourage people make dem dey use pigin often, even if dey wan write topic e go make sense like that pass.

I get your point say no be by force but nothing bad if we try dy unique for some things too, nah this our pigin them go take sabi us as naija made.
Na every time we go dy copy wetin no be our own? Wetin happen to that one wey be true true our own? Abeg any how e be make we type am speak am nothing bad if piple wey no sabi learn am, you make mistake them go correct them.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: GiftedMAN on April 15, 2024, 12:23:50 PM
This tok go well but I dey see say some people dey drag the talk dey long like say dem no really understand wetin op wey be uche god mean, make we reason dis matter small, no body dey force any body to dey write every post for pidgin but make we still make our corner dey unique and how we go doam if we no dey write in pidgin wey be language wey most of us if not all of us go understand very well and sometimes self e get small small secret wey we fit keep here wey only us go dey understand wey other members no fit know even when dem visit here. How we go dey claim say we get local board when we know get topic wey dey for pidgin language wey we dey use as our local dialet, most of us dey use pure English dey write and e no funny because anybody fit enter dis corner get everything wey we dey do here and e no go well.

Make we just make the place look like wetin e supposed be, make the thread topic dey start with pidgin if possible and make we swallow some of the grammar dem use our local pidgin language e go make sense to all and e go make some strangers wey no from we corner not to know everything wey we dey discuss unless dem go really take time to dey break am down one by one.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Justbillywitt on April 15, 2024, 07:29:46 PM
As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover.
https://www.talkimg.com/images/2024/04/10/jdXyG.jpeg
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.
Omo there is no way person for talk pigin English all through. Normally for this our pigin level we still dey mix am with English because the pigin self get different grades. Well if na the only observation wey you noticed say dey wrong for the local board, then wahalah no dey at all. Me I been dey think say you wan talk something about shit postings, but it be like say that one don reduce. E get time wey be say na shit postings been dey give us challenge for this our local board. But onto this level wey you Yan like this, I go say too much wahalah no dey at all.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Kelward on April 16, 2024, 12:51:30 PM
Personally I reason say writing in pidgin English, for make dis our local board to de very unique and wen oda nationals visit di board, dem go get di flow say truly na dis style of English de popular for naija, infact you go surprise say more people go de visit our board to de feel our flows. Wen I join dis forum new, I experience different debates for dis board about weda to de make posts for normal English or pidgin English, in the end na to use either of dem na im carry di day, and since den every member de use di one wey im de take flow pass.

I for prefer say make more posts dey de for pidgin English, but reverse na di case as e show for di OP, more posts de appear for normal English, so we need to accept am like dat. Aldo instead of say make person wey no sabi write for pidgin English to de goof for I'm post, e de better say make im post for normal English, because some of our people no sabi how to write fluent pidgin English.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Coyster on April 16, 2024, 06:44:01 PM
Personally I reason say writing in pidgin English, for make dis our local board to de very unique and wen oda nationals visit di board, dem go get di flow say truly na dis style of English de popular for naija, infact you go surprise say more people go de visit our board to de feel our flows.
Wetin make you think so, IMO, the local board dey very unique as e dey now, and we no need approval from non-Nigerians. I no know if you read my last posts in this topic, i linked the Indian local board and you can see that na mostly English wey dem dey use for their own board. As regards this argument, i even think it is when we mostly use English language to communicate that non-Nigerians will be able to inderstand what we say in our local board, but that is nothing of priority and it does not matter.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Jegileman on April 16, 2024, 11:53:18 PM
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.

I really get wetin you dey try yarn and wetin you dey talk really make sense if dem go do am like that. But as he say in the past dem say before them approve the local board, English and pidgin na him be the main languages wey we go dey speak for here, na him make people dey use English for here wella too. Abi people no too sabi how to use Pidgin take create title of their post for here? Even me don create topic for here before and na English I use right am in full.

Anytime wey I visit local board and I wan comment for post, e dey always be on how the OP take start the thread I dey use reply am, if na pidgin, I dey follow am up with pidgin and if no be pidgin na normal English I dey use. No be say I no wan use pidgin dey reply but I dey sometime forget say we fit use Pidgin for here, if I remember quickly I dey switch and if I no remember, I go just continue like that till I finish then use pidgin for my next reply or comment for posting in the local board.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: rachael9385 on April 17, 2024, 01:13:27 AM
The thing na be say, some persons no dey that fluent when them dey use pidgin take dey express themselves. And this no be just even small ranked members, I mean so e of the legendary here sef don still talk say them no dey fit express themselves for pidgin write ups like when Dem use English. So the matter of going back to change the local board settings by using only pidgin, my brother that one no carry any weight, no body go even reason you. The only thing na besay, if you wan create thread then use the language you prefer either English or pidgin, but to change local board make na only pidgin Dem use, e no go work.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: AmaGold70 on May 05, 2024, 11:11:35 AM
As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover.
https://www.talkimg.com/images/2024/04/10/jdXyG.jpeg
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.
As @davidvictorson talk "if wishes were horses" I for really like make we dey use pidgin as our local language because eh pidgin sweet no cap, as we get too many languages for our country we for just take pidgin hold body for this forum make we too feel like say we get our own unique language wey no body fit understand except us. But I come see say no be everybody for naija Sabi pidgin as some of us no really school for we country but at all at all I believe say at least 80/90% of us here go Sabi pidgin, so let's give it a try.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Mate2237 on May 16, 2024, 10:24:06 PM
I just talked am recently, dis our board e no dey like local board because we dey use pure English pass di pidgin English and di reason why local board was created was to use pidgin English among ourselves. Although we dey speak English language too but as a Nigerian there is no way wey we no go fit use pidgin in anywhere. We should try our best to mix it with pidgin I dey beg una. If you look well those people wey dey use only English language e no get board  ut na di general boards them dey use.

So make we add our local language here so dat di board go dey distinction with di general boards.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Forever101 on May 17, 2024, 02:59:19 PM
Wetin be the concept of our local board, na about pidgin or country related issues.

Actually every local board get their own unique identification , so if we go get the matter well, we need identification and matter wey be crypto and country related, wey go make our board dey unique and recognized as local board.

Na here I go drop my biro

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: adultcrypto on May 17, 2024, 03:24:36 PM
I just talked am recently, dis our board e no dey like local board because we dey use pure English pass di pidgin English and di reason why local board was created was to use pidgin English among ourselves. Although we dey speak English language too but as a Nigerian there is no way wey we no go fit use pidgin in anywhere. We should try our best to mix it with pidgin I dey beg una. If you look well those people wey dey use only English language e no get board  ut na di general boards them dey use.

So make we add our local language here so dat di board go dey distinction with di general boards.
I know say the language na the main thing wey dey make some people think say we no dey vibe as omo 9ja as e supposed be. Well, make we no forget say no be everybody sabi our Nija pidgin wey be the koko. Some na ajebo from day 1, them go yankee schools and no follow us drag beans with our award winning garri. Base on this one them so, I still say make we dey melember dey go with as the board be now, knack grammar if your weight reach or vibes the Nija way if na wetin sweet your body. Las las all of us go dey alright if we work together to make here home. One love my people.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Asiska02 on May 17, 2024, 04:37:51 PM
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.

Wetin you yarn na true and if e dey like dat e no go bad at all. Why most of those topics be like dat na because say dem don agree generally before dem create the board say na pidgin and English dem go dey use. So if some people create thread finish, even if na for pidgin English, to use pidgin English as title go hard them because no be all even sabi speak am well or fit write am as we dey do. The good thing be say, make the information wey dem dey pass dey relatable and not confusing to the people wey dem dey send am too. Nothing too bad sha, but if e dey like dat, e no go still bad still.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Fiasem20 on May 17, 2024, 08:35:29 PM
I see no problem there, Nigerians writing with English language, although I know it's a local board.In Nigeria the two major languages are pidgin and English language so if a person wants to write his or her topic in English language I see no prob there for the fact that the person is passing something vital to the forum it's all accepted.I have a friend that know how to conserve in pidgin but he doesn't know how to write in pidgin,so we have people like that,so most people in this local board don't know to write in pidgin so should that exclude them from sharing their ideas??.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Abdulzuruku01 on May 18, 2024, 08:45:58 AM
As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover.
https://www.talkimg.com/images/2024/04/10/jdXyG.jpeg
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this.
My people na wetin I get to share be this o.

If u check other local boards dem dey communicate according to dere local language but you know for Naija no be everybody like pidgin, the wey some people dey yarn with pidgin here e dey hard me to read and I believe am sey no be only me dey face dis  problem. I don see person sef wey no dey even understand pidgin.
I think what matters is understanding and all d topics wey we dey discuss here all na Naija matters. People wey no de fit write with pidgin and dem get better information to pass how dem go come do?

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Sonia_123 on May 19, 2024, 04:19:28 PM
This our local board mata ,if for sweet well well of to sey we all write for the pigin , but the tin be sey we need to be our brodas keeper na him make we dey add English for inside ,some person hear am but nor fix speak or write am for book .
Una know sey some of us wey dey dis Naija no sabi speak dis pidgin wey we call awa local language ,and we wey dey write am for text sef, awa spellings dem no dey correct, and we dey mix am with English too , because we no know how we go talk am for pidgin, but so far we dey communicate life goes on .
 I no think sey as we dey mix the English words with pidgin we go fit mix correct English with anoda one wey no correct make e make sense or we go even accept , understand am or the tin and message wey we dey pass across to people, for you, you tink say you don write pidgin and you correct , go check pidgin Textbook and dictionary you go see sey you wrong because you mix pidgin and English write except who study pidgin for school, how many people get the Text book for him house? Make we leave the forum as e dey for others participation sake .

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Stable090 on May 19, 2024, 05:32:59 PM
I see no problem there, Nigerians writing with English language, although I know it's a local board.
Nobody talk say problem Dey now, and all of us don conclude say na both English and pigin we go Dey use post, but Wetin the OP Dey try talk be say make some topics tittle be pigin, if you check the front page you go see say na English dem use write all the topics, if you enter dis local board, you go think say na general board until u come check the name. But if some posts tittle na pigin, anybody wey open the local board go know say dis one na naija local board.

I know say some people prefer to use English to post, but abeg people wey Dey use pigin post, if Dey wan create post tittle  make dem try Dey use pigin, some post Dey wey na pigin e go be, but if d person wan write post tittle na English him go use, make we Dey try use pigin also for tittle.

Title: Re: E no resemble local board.
Post by: Mia Chloe on May 19, 2024, 08:16:33 PM
I have raised a similar post like this in the past however in my post I was emphasizing on the quality of the pidgin here in Naija board.  The main reason I made that post was because from my observations I noticed that reputable members who are not members of our local board were looking down on Naija board especially because of the quality of the pidgin we used here. The pidgin were more or less English that had little mods which isn't supposed to be so.

With this particular thread I hope Naija board members take pidgin seriously. Pidgin and English are both accepted here in Naija board however making use of pidgin makes posts kind of lovely and informal. The truth is as much as some of us here wants pidgin to be the main language here which would be nice, some posts are still better off as English. Some persons here may even have a hard time reading the pigin of certain users but the truth remains it will be difficult to make the whole board pidgin. This is because pigin doesn't really have a strict format unlike other languages like German, french..... And many others.