Bitcoin Forum
June 19, 2024, 08:50:39 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
  Home Help Search Login Register More  
  Show Posts
Pages: « 1 ... 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 16 17 18 19 20 21 22 23 24 25 26 27 28 29 30 31 32 33 34 35 36 37 38 39 40 41 42 43 44 45 46 47 48 49 50 51 52 [53] 54 55 56 57 58 59 60 61 62 63 64 65 66 67 68 69 70 71 72 73 74 75 »
1041  Local / Politics and society (Naija) / Re: Nigeria with confusion on: December 14, 2023, 05:00:24 AM
Omor no be small thing oo, gass now for my area na 1000 for filling station and gas plants while for normal street where Dem dey fill gas na 1100 per kg, some wey been dey for 700 before we start to convert generator Dem. This na one of the reason why this country leaders wey dey influence price are all wicked, no be say the gas follow for fuel subsidy seff oo, na just petroleum naim Dem just increase the price of gas like say e wan finish for market. The idea wey baba Charles-Tim bring up so, na very nice one I don even hear of solar electric cooker sef, so if person buy that one r go save from this rubbish wey dey happen to the price of gas and fuel.
1042  Local / Nigeria (Naija) / Re: Our savings nai save us on: December 14, 2023, 04:43:01 AM
My brother no be small thing oo, the way things take cost anywhere you go Dem dey talk about dollar increase, but the no get time wattin we wan do because this na because of bad economy wey we get.i know of person wey been dey save to buy car but now, e don dey use e car money for ake dey feed em family, life no easy again, forget say no matter how things increase we go still survive, e nor easy to survive this period. We dey feel the pain as we dey spend, no be ones or twice wey I don carry savings money take buy food chop, as the country hard so person no come dey see work like that again. I just dey pray make God help us because e be like say for this country to move forward e go hard well well.
1043  Local / Nigeria (Naija) / Re: Make we no be hypocritical member for the forum on: December 14, 2023, 04:28:22 AM
Op na real matter naim you dey Yan for here oo, some person as Dem dey find wey to get merit, dem just post anyhow, forgetting say before den come other people don dey wey been dey service the local board well, and got those wey dey post wrong information like lie lie news make person for get compassion give then merit. I go still like clear you say no matter how you lie reach for your  post. If person no like to merit you e not go merit you, so what the point of lying to your family. Because as we dey so, we don turn family, forget say we from different background and tribes. My advise na be say, make we still try to keep this our local board very healthy abeg.
1044  Local / Nigeria (Naija) / Re: Newly launched token alerts on: December 13, 2023, 08:54:17 PM
@mate2237 wattin you talk na true sha, say this kind of thread Dem many for this forum, and the op for fit just comment for other thread than to create em own. But wattin the op do sef no still bad because, this period na injury time and anything fit shele, so the thread dey act like remainder for us, make we for fit refresh our mind and return to the normal practice instead of to allow long throat and big eye, finish our bitcoin investment. Beside Mate2237 the link wey you post na link to entirely different thread wey dey talk about scam links wey dey fly around for social media while the op they talk about, selling your bitcoin to go buy shitcoin or scam project because you dey find huge profit of like 10x increase.

I know say you wan help the local board from spamming, but if na only me, this post dey very important as reminder for this period wey everywhere dey hot for scam matters. And the experience wey the op share na eye opener to many people wey dey think of to divert from bitcoin to altcoin.
1045  Local / Nigeria (Naija) / Re: Start Something on: December 12, 2023, 10:37:50 PM
Normally this life don pass when matured man or youth go sit down for house dey depend on em mama food, from week to week to month, so long as say you don pass teenager, you supposed to don get hand work or skill wey fit generate money for you, go  those wey like soft skills, we get many online skills wey dey pay well if truly say you dey serious. Just like the message wey papa David oyedepo been preach for Shiloh, e say you cannot be sitting down while trying to move forward, you have to stand up and take steps. When I hear this word e just sweat my belle, person wey dey houses day to day when nor dey go look for work naim do em self because, if you truly wan move forward for this life, you gats make moves wey go bring that opportunity come your way, nor dey expect manner to fall from heaven. There is a saying that heaven help those who help Dem self, even the bible say, "faith without works is dead" so as you still get faith, make you still try dey work out things, den you go see the hand of God for you life.
1046  Local / Politics and society (Naija) / Re: Make we keep our pigin unique on: December 12, 2023, 09:06:35 PM
I greet oo my pipo
Wen I first com dis forum I shock wen I  see say my contree 9ja get local board.asin eh e muzz me buh e sti increase my respect 4 naija.on a norms pigin suppose b we we language based on say almost  all state 4 9ja de use am.but nowadays pigin 4 dis our local board com get as e b. E com b like watin no b original again.most times wen pipo de make translation 4 we local board Dem no de take their time break am down to we pigin and dis matter no sharp as other pipo way sabi English go com fit read am well and no b so e suppose b bcos na pigin no b English. e nova too tay way I pm Loycev for one translation matter like dat but em ansa no gimme joy at all.i 4 post screenshot of E reply but based on say na pm ND I message am say I won post am buh e no agree.buh him reply na say E fit read most of the pigin so e no see much use of am. And no b so e suppose b. I no de point finger give any pesin but watin I de try talk b say if u wan use pigin type type am well.if na translation u de do no de rush settle down type am well remember say d way Dem go reason dis board na wit our post quality.
9ja board de grow on a steady so make we keep am dat way.If u get small issues no de fear to pm fellow local board members as Dem go hep u out wella.Sometimes sef pipo like Dem Fivestar4everMVP Makus Wiwo and even sokani don help me with some info way I need especially wen I b wan create dis post.
Tank u my pipo.
Keep 9ja board unique.

I no go lie you, wattin you Yan about our pidgin language na tru, because even me sef dey guilty of am, I believe say my pidgin dey very easy for externals Dem to read and I don still try to make am look very hard but, na wattin dey come out for my mouth naim still dey come out from my hands, so that dey very difficult for me to change, and if I say make I start to dey use dip pidgin slangs I no sure say even 10% of naija go understand me clearly, based on where I stay for warri , our pidgin too get many words to just express one thing, so e fit dey hard for others to understand. Anyway sha, I go still try my best but e for good make other too take this correction.
1047  Other / Beginners & Help / Re: [Merit] Help posts in local boards that did not receive enough merits on: December 12, 2023, 08:39:32 PM
This is the list of links:

Link 1: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5473010.msg63131709#msg63131709

Link 2: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5471381.msg63132213#msg63132213

Link 3: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5471348.msg63041275#msg63041275

Link 4: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5472504.msg63091613#msg63091613

Link 5: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5470690.msg63091823#msg63091823

Link 6: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5472631.msg63095922#msg63095922

Link 7: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5472678.msg63097948#msg63097948

Link 8: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5472616.msg63106593#msg63106593

Link 9: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5471514.msg63111621#msg63111621

Link 10: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5468797.msg63111708#msg63111708
1048  Local / Nigeria (Naija) / Re: The dangers in trying to influence or impressing the public off your worths on: December 12, 2023, 12:45:37 PM
My brother, luxurious life dey sweet oo, to show off dey sweet well well, but e still fit put you at great risk, because as you dey live your life they go, people go just dey corner dey observe you, and dem fit get bad intentions against you and before you go know dem don kidnap you as hostage for ransom. So much even you dey admire the lifestyle of some yahoo boys make you nor forget the risk wey still dey associated with their luxurious life. Especially now wey EFCC dey very active to find fraudster, life wey you wan enjoy go come dey hunt you down, if there is anything I have learnt, one of them is to contented with what I have and no try to impress anybody. E get one talk wey say, "don't try to impress anybody, if only you know the rate at which the dead are forgotten" the best life wey any crypto enthusiastic fit leave naim be to dey on a coded low-key life.
1049  Local / Nigeria (Naija) / Re: Is Nigeria still practicing the rule of law? on: December 12, 2023, 08:27:31 AM
My brother, wattin you talk  na so e dey happen now, the on wey pain me pass naim be justice so, even for th justice statue Dem supposed don commot that scale balance and blind fold for the lady justice statue because these days, na so so partiality we dey experience for the hand of judges. Dem say the blind fold na for impartial justice while the scale na for weight of evidence, but both with evidence and other things, Dem still dey make judge based on wattin dem like. the justice system isn't fair anymore, it's only for the rich and the highest bidder. Make I back up wattin I dey talk, normally for Nigeria na 8 years be the maximum wey person fit operate for some political position, like governor, president etc. but for bayelsa state the APC candidate, timipre Silva don first rule for 1 year but Dem come commot am say em election been no dey free and fair, later e come contest again and e come win, e come rule for 4 years. And now e still dey come out to rule for another 4 years wey go make am 9 years, and person come go sue to court say e no go fit work, yet the court say, based on say no be e fellow political aspirant say the matter no go anywhere. Though Dem still win am Sha, but that court statement dey very wrong, irrespective of the person wey sue you to court.
1050  Local / Nigeria (Naija) / Re: Creativities contributions earns rewards. on: December 12, 2023, 06:22:39 AM
Op you have spoken well, na all this kind of advice I dey like make person wey don see road shoe others, because this na one the best idea wey I don see say newbie carry come board so, some persons dey feel like say na post be the main thing, Dem no no say e get wattin you go do to make your post get good quality, Dem say writing itself na skill, do we gats learn am and the easiest way wey we fit take learn na to read other good quality and constructive posts wey our baba dem write. So long as you dey this forum and you like grow, reading no be wattin you supposed to carry play, because na em go make your writing look professional. I remember when I join this forum new, I dey fit read threads wey get more than two pages, every single comment wey dey inside. And this practice really help me from both small and great ranked members, because some times no be every good quality post Dem dey merit, naim make I dey say even the merit system na God hand e dey, if em touch the merit person to send you merit good for you.

I no go lie you, some times Dem dey give merit based on your reputation, for example if Theymos come caugh for here, you go see say merit go full ground, even if na hello e write.
1051  Local / Off-topic (Naija) / Re: Why we must heal our inner self on: December 12, 2023, 05:59:03 AM
Op I understand wattin you dey try talk oo, now adays our children dem wey dey grow don dey too use the social media carelessly, instead of Dem to read Dem go dey Facebook or TikTok from when Dem come back for school to night, den you go come dey see sa na for morning Dem go come dey rush dey do their assignment. If to say na so we carry the social for head when we dey their age, I no sure say many of us for graduate with good result, or get hope for beta future. As the social media fit teach us bad things na so e still dey teach us good things, I remember that year wey I wan write waec, na for Facebook I been take dey get some links and learn some kind solving Dem for maths and physics. And now the forum na still social media wey we take dey get am clear small small, so only this one alone dey show say the  internet space na very wonderful environment, but if to say many of us fit serious for this forum the way we serious for other social media er for don goo far.
1052  Local / Nigeria (Naija) / Re: Naija board service thread, how una reason am? on: December 12, 2023, 05:33:26 AM
Op na better thing wey you don talk so because, na adays na online dey move market pass, if you observe well you go see, now adays people don turn their WhatsApp status to business advertising ground, and them dey make. If to say dem nor dey make, Dem for no dey do am, and WhatsApp  dey restricted to just your contact, then talk more of this forum wey na everybody go dey see your post. But wattin I get against this idea na be say, this forum almost everybody dey use guy name wey no be their real name, and that na one of the things wey dey make the forum dey anonymous. So what if person come carry your money run, there is no way wey you go fit  track that person. So e Dem go create that kind board make Dem put rules, wey go make people fear to scam other, like trade with caution, or make sure say una do physical transaction, or person wey scam go chop negative tag. So that we no go dey hear, I was scammed .
1053  Local / Nigeria (Naija) / Re: Always get alternative to your fund. on: December 11, 2023, 10:12:47 PM
E get wetting I dey always observe this days from people. Many people dey like to comot without their ATM card for pocket. and some wey dere own don expire no dey even reason to request another one from bank, because them get mobile banking app for phone forgetting say emergency fit come up at any given time wey you go dey stranded while you get money for bank.

Make I take myself for example, e get the day I go pH go buy something. So along the line agbero snatch my phone from me unknowingly and everything dey inside the phone and I get ATM card with me. I been wan comot without ATM, but I just say make I carry am along. So as the phone lost I just use my ATM card to withdraw and continue with my activities plus my TP, if not how I for do am? Because even tp self don finish for my hand because of change of price on transportation. Maybe I for turn begger for street dey find TP because how to contact person for be problem. Expecialy when person no no dey close to bank.

So make we look into this matter, because some things wey dey common fit mess us up when we least expect. So wetting ona think about am?

As I dey so, I dey hardly carry my ATM card waka for street oo, forget say ATM card fit save you for time of emergency, e fit still ruin your entire life, just imaging the example wey you say agboro pick your phone when you nor know. And you no say some persons dey like to put their ATM card for the back of their phones, and person luckily pick your phone with that ATM for inside e mean say, e go just wipe everything  wey dey your account. Forget about ATM pin, people dey run am on a daily base,Dem go just do, request for otp and from there your funds go dey burn go. so even as we dey go outside with both out phone and ATM cards make we still shine out eye make Dem for no use us do escape goat. So avoid keeping your ATM card for the back of your phone.
1054  Economy / Services / Re: [OPEN] Rollbit.com |Duel Arena Signature Campaign| Full Members+ Earn up to $80 on: December 11, 2023, 05:30:32 PM
Bitcointalk Profile Link: https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=3565817
Current post count: 444
bech32 BTC Address: bc1qw2exnyn34ek7dtt8rj98ule607j07c3klqpyu0
Merit EARNED in the last 120 days: 100
1055  Economy / Services / Re: [OPEN] Sherbet.com 🍭 Signature Campaign | Reward up-to $130/w on: December 10, 2023, 01:49:09 PM
Current number of posts (including this one): 443
Rank: Full Member
Bech32 address: bc1qw2exnyn34ek7dtt8rj98ule607j07c3klqpyu0
Merit earned in the last 120 days: 100
1056  Bitcoin / Bitcoin Discussion / Re: Finally I did it (I am happy to join). on: December 10, 2023, 01:35:31 PM
It gives me joy seeing that, you are growing from learning about Bitcoin to buying some set of Satoshi. Its a good start in your accumulation journey, I just hope you continue us DCA to accumulate for now, so that your accumulation will not bring any sudden and obvious change to your financial activity. Using electrum wallet is the best option for safe keeping your coins, I'll also  want you to keep you private key and your mnemonic seed in a safe, like a water proof and a fire prove safe so that in times of emergencies, like natural disasters your coins would still be safe.
1057  Economy / Reputation / Re: [v2][Self Moderated] In Merits, Count Down To Your Next Rank... on: December 10, 2023, 02:00:02 AM
Congratulations to you makus! I have been following you every where Loz. Just as you said that this year ending you must rank up. I see you have achieved your dreams. We are still on the same race aluta continua Victoria accerta. The journey is not a child's play but gradually we all will meet out target. I know how the feeling is right now. Just go to church today and give testimony haha.

Thanks mate, I really appreciate the kind words, I know for sure that you'll also rank up before match next year, just keep posting the good quality post.
1058  Economy / Services / Re: [CFNP] COINS.GAME | Most Rewarding Crypto Casino | Signature Campaign Up to $100 on: December 10, 2023, 01:44:33 AM
Merit earned in the last 120 days: 100
BTC address (Segwit): bc1qw2exnyn34ek7dtt8rj98ule607j07c3klqpyu0
1059  Economy / Services / Re: [OPEN] Rollbit.com | Signature Campaign | Full Members+ ~ Earn up to $80/Week! on: December 10, 2023, 01:16:52 AM
Bitcointalk Profile Link: https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=3565817
Current post count: 440
bech32 BTC Address: bc1qw2exnyn34ek7dtt8rj98ule607j07c3klqpyu0
Merit EARNED in the last 120 days: 100
1060  Economy / Reputation / Re: [v2][Self Moderated] In Merits, Count Down To Your Next Rank... on: December 10, 2023, 12:55:42 AM
My countdown to full member rank
Number of Merit(s) left: 5 4

Congratulations on becoming a full member. I just gave you the last four merits you needed to rank up… I hope to see your application as a senior member soon.

Thanks alot man, I really appreciate the kind
Pages: « 1 ... 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 16 17 18 19 20 21 22 23 24 25 26 27 28 29 30 31 32 33 34 35 36 37 38 39 40 41 42 43 44 45 46 47 48 49 50 51 52 [53] 54 55 56 57 58 59 60 61 62 63 64 65 66 67 68 69 70 71 72 73 74 75 »
Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!