Bitcoin Forum
July 02, 2024, 12:42:54 AM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
  Home Help Search Login Register More  
  Show Posts
Pages: « 1 ... 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 16 17 18 19 20 21 22 23 24 25 26 27 28 29 30 31 32 33 34 35 36 37 38 39 40 41 42 43 44 45 46 47 48 49 50 51 52 53 54 [55] 56 57 58 59 60 61 62 63 64 65 66 67 68 69 70 71 72 73 74 75 76 77 78 »
1081  Local / Off-topic (Naija) / Re: Stay patient 🤞 on: December 16, 2023, 08:15:28 AM
Op as you talk am na so e be oo, crypto trade no be wattin person go do come dey expect to see changes sharp sharp, I even like the illustration wey you use as e be say na planting of tree you use because, naim be the best way to take describe crypto investment especially when we dey talk about Bitcoin investment. Bitcoin investment requires enough patience and one of the ways wey you fit take dey patient with your holding na when you learn about Bitcoin well before you invest or along the way as you don invest, because na when you learn, you go take understand say Bitcoin get limited supply compared to the investors wey ready to hold am, and economics teach us say limited supply with increase in demand go make the price increase, na why Bitcoin price na up e dey go. The more people hear about am come put body na the more e go just dey go up, though e fit get small bear movement, but that one no go last.
1082  Local / Nigeria (Naija) / Re: MLM na dangerous marketing strategy on: December 16, 2023, 08:02:14 AM
E don Tay wey all this kind things dey exit for this life, even for Nigeria def, Dem many wey I don jam, e get one tym sef I nearly fall for one of Dem wey Dem dey call NEW LIFE l. This people so mouth sweet me untill I been wan join, if to say any of una don attend their seminar you for understand wattin I mean,  the people wey dey involved are very good marketers wey sabi persuade person and Dem sabi talk fast. Anyway ones I hear say the entire money process dey gbakam for referral, I just no say no be my thing be that, that time wey I been dey find work naim Dem be wan use my head because na from vacancy bill naim I take get their number and when I call Dem come direct me go their side. I no go advise anybody to put body for that kind thing oo, because inside the business so na you go dey find people wey you go bring come join, under sun and rain.
1083  Local / Nigeria (Naija) / Re: Guide on how not to get your bank account banned while trading in P2P trade. on: December 16, 2023, 07:49:05 AM
Omor which kind of matter be this one na, why CBN go dey do this kind of thing, Dem don dey cross their limit oo, wattin be the meaning of this one, say dem go enter p2p trading platform to they observe people trade, that means even the p2p wey go lick people information give Dem sef no get head, because na them go still write for their terms say no third party, so why Huh Op you try well well as you carry this one come board today at least person don dey aware of wattin Dem dey plan, but e for still goes well if to say you provide link or source from where you get the information from if possible, so that we go dey sure say na from legit background.
1084  Local / Off-topic (Naija) / Re: Eleme people actually Dey this forum on: December 15, 2023, 02:28:54 PM
Baba I greet oo, I no say you wan try to locate others so that una fit hangout for the same territory but make I still clear you say to provide this kind of more detailed location for were you dey stay and you know say we not supposed to even release these kind of information especially for forum like  wey majority of our talk na money matter we dey talk. To be honest e nor dey safe as e be say many outsiders don dey fit understand our local pidgin. My brother safety first oo, make Dem for no use us chop Christmas oo.
1085  Bitcoin / Bitcoin Discussion / Re: Finally I did it (I am happy to join). on: December 15, 2023, 01:18:24 PM
Op ones again congratulation on your accumulation journey, I can see that you have topped up your first accumulation to a more advanced level, that Is a great step you took back there ... 1.7 million naira is a huge sum of money even if it is not close to half of a bitcoin, but I believe some day you would arrive there, it gives me joy knowing that you have learnt enough and have started putting those learning into practice, not every person have this courage to buy bitcoin at this level. Just as JayJuangee would always advise that you start your bitcoin accumulation as soon as possible, the regret you have should be a thing of the past and you should focus on the future by, becoming more aggressive in your accumulation.
1086  Local / Nigeria (Naija) / Re: Kuda down time 😳 on: December 15, 2023, 07:29:30 AM
It's very embarrassing seeing all these comments that kuda is known for steady maintenance, I have never used them and did not even plan on using kuda nor have I opened any account in kuda. When it first came i never liked them, opay has been my choice since 2020 and I am doing just fine with them. Op I would like to advise you that you make you use  of op since this maintenance issue is a continuous event that consume a lot of time. Beside I believe maintenance should be done at midnight and not in the day that they experience lots of traffic.
1087  Local / Politics and society (Naija) / Re: Better way to earn a merit on: December 15, 2023, 07:13:33 AM
It obvious am new here yea am a newbies. What make a post earn a merit ? What are the characteristics of a good post and how do we earn a merit for our post and other activities happening here and how is Bitcoin always important in the forums . So Member, full member, hero member, Lagendary and so on pls let have the tips thanks 🙏❤️ #bitcoin Lords

Op you are very much welcome to this forum, I dey see say some of our boss Dem don provide links for you to take understand the question wey you ask, and I believe say you go find the links useful, actually if you wan really get merit for post dem, I go advise make you make good quality post and comment wey go dey useful for the next person wey read am, e fit be say na answer you dey answer person, and before you go know you don get merit. Make I advise you one tin, of you say na merit you wan dey chase e go hard for you to rank up oo and if you no get merit for post wey you feel say supposed get merit, that feeling fit make you give up sef, so the best thing na to just dey make quality post even if Dem no merit your post you fit still carry that post go apply for some thread wey dey inside beginners and help board wey dey give merit to post wey merit no reach.
1088  Local / Politics and society (Naija) / Re: Nigeria with confusion on: December 14, 2023, 05:00:24 AM
Omor no be small thing oo, gass now for my area na 1000 for filling station and gas plants while for normal street where Dem dey fill gas na 1100 per kg, some wey been dey for 700 before we start to convert generator Dem. This na one of the reason why this country leaders wey dey influence price are all wicked, no be say the gas follow for fuel subsidy seff oo, na just petroleum naim Dem just increase the price of gas like say e wan finish for market. The idea wey baba Charles-Tim bring up so, na very nice one I don even hear of solar electric cooker sef, so if person buy that one r go save from this rubbish wey dey happen to the price of gas and fuel.
1089  Local / Nigeria (Naija) / Re: Our savings nai save us on: December 14, 2023, 04:43:01 AM
My brother no be small thing oo, the way things take cost anywhere you go Dem dey talk about dollar increase, but the no get time wattin we wan do because this na because of bad economy wey we get.i know of person wey been dey save to buy car but now, e don dey use e car money for ake dey feed em family, life no easy again, forget say no matter how things increase we go still survive, e nor easy to survive this period. We dey feel the pain as we dey spend, no be ones or twice wey I don carry savings money take buy food chop, as the country hard so person no come dey see work like that again. I just dey pray make God help us because e be like say for this country to move forward e go hard well well.
1090  Local / Nigeria (Naija) / Re: Make we no be hypocritical member for the forum on: December 14, 2023, 04:28:22 AM
Op na real matter naim you dey Yan for here oo, some person as Dem dey find wey to get merit, dem just post anyhow, forgetting say before den come other people don dey wey been dey service the local board well, and got those wey dey post wrong information like lie lie news make person for get compassion give then merit. I go still like clear you say no matter how you lie reach for your  post. If person no like to merit you e not go merit you, so what the point of lying to your family. Because as we dey so, we don turn family, forget say we from different background and tribes. My advise na be say, make we still try to keep this our local board very healthy abeg.
1091  Local / Nigeria (Naija) / Re: Newly launched token alerts on: December 13, 2023, 08:54:17 PM
@mate2237 wattin you talk na true sha, say this kind of thread Dem many for this forum, and the op for fit just comment for other thread than to create em own. But wattin the op do sef no still bad because, this period na injury time and anything fit shele, so the thread dey act like remainder for us, make we for fit refresh our mind and return to the normal practice instead of to allow long throat and big eye, finish our bitcoin investment. Beside Mate2237 the link wey you post na link to entirely different thread wey dey talk about scam links wey dey fly around for social media while the op they talk about, selling your bitcoin to go buy shitcoin or scam project because you dey find huge profit of like 10x increase.

I know say you wan help the local board from spamming, but if na only me, this post dey very important as reminder for this period wey everywhere dey hot for scam matters. And the experience wey the op share na eye opener to many people wey dey think of to divert from bitcoin to altcoin.
1092  Local / Nigeria (Naija) / Re: Start Something on: December 12, 2023, 10:37:50 PM
Normally this life don pass when matured man or youth go sit down for house dey depend on em mama food, from week to week to month, so long as say you don pass teenager, you supposed to don get hand work or skill wey fit generate money for you, go  those wey like soft skills, we get many online skills wey dey pay well if truly say you dey serious. Just like the message wey papa David oyedepo been preach for Shiloh, e say you cannot be sitting down while trying to move forward, you have to stand up and take steps. When I hear this word e just sweat my belle, person wey dey houses day to day when nor dey go look for work naim do em self because, if you truly wan move forward for this life, you gats make moves wey go bring that opportunity come your way, nor dey expect manner to fall from heaven. There is a saying that heaven help those who help Dem self, even the bible say, "faith without works is dead" so as you still get faith, make you still try dey work out things, den you go see the hand of God for you life.
1093  Local / Politics and society (Naija) / Re: Make we keep our pigin unique on: December 12, 2023, 09:06:35 PM
I greet oo my pipo
Wen I first com dis forum I shock wen I  see say my contree 9ja get local board.asin eh e muzz me buh e sti increase my respect 4 naija.on a norms pigin suppose b we we language based on say almost  all state 4 9ja de use am.but nowadays pigin 4 dis our local board com get as e b. E com b like watin no b original again.most times wen pipo de make translation 4 we local board Dem no de take their time break am down to we pigin and dis matter no sharp as other pipo way sabi English go com fit read am well and no b so e suppose b bcos na pigin no b English. e nova too tay way I pm Loycev for one translation matter like dat but em ansa no gimme joy at all.i 4 post screenshot of E reply but based on say na pm ND I message am say I won post am buh e no agree.buh him reply na say E fit read most of the pigin so e no see much use of am. And no b so e suppose b. I no de point finger give any pesin but watin I de try talk b say if u wan use pigin type type am well.if na translation u de do no de rush settle down type am well remember say d way Dem go reason dis board na wit our post quality.
9ja board de grow on a steady so make we keep am dat way.If u get small issues no de fear to pm fellow local board members as Dem go hep u out wella.Sometimes sef pipo like Dem Fivestar4everMVP Makus Wiwo and even sokani don help me with some info way I need especially wen I b wan create dis post.
Tank u my pipo.
Keep 9ja board unique.

I no go lie you, wattin you Yan about our pidgin language na tru, because even me sef dey guilty of am, I believe say my pidgin dey very easy for externals Dem to read and I don still try to make am look very hard but, na wattin dey come out for my mouth naim still dey come out from my hands, so that dey very difficult for me to change, and if I say make I start to dey use dip pidgin slangs I no sure say even 10% of naija go understand me clearly, based on where I stay for warri , our pidgin too get many words to just express one thing, so e fit dey hard for others to understand. Anyway sha, I go still try my best but e for good make other too take this correction.
1094  Other / Beginners & Help / Re: [Merit] Help posts in local boards that did not receive enough merits on: December 12, 2023, 08:39:32 PM
This is the list of links:

Link 1: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5473010.msg63131709#msg63131709

Link 2: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5471381.msg63132213#msg63132213

Link 3: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5471348.msg63041275#msg63041275

Link 4: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5472504.msg63091613#msg63091613

Link 5: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5470690.msg63091823#msg63091823

Link 6: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5472631.msg63095922#msg63095922

Link 7: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5472678.msg63097948#msg63097948

Link 8: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5472616.msg63106593#msg63106593

Link 9: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5471514.msg63111621#msg63111621

Link 10: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5468797.msg63111708#msg63111708
1095  Local / Nigeria (Naija) / Re: The dangers in trying to influence or impressing the public off your worths on: December 12, 2023, 12:45:37 PM
My brother, luxurious life dey sweet oo, to show off dey sweet well well, but e still fit put you at great risk, because as you dey live your life they go, people go just dey corner dey observe you, and dem fit get bad intentions against you and before you go know dem don kidnap you as hostage for ransom. So much even you dey admire the lifestyle of some yahoo boys make you nor forget the risk wey still dey associated with their luxurious life. Especially now wey EFCC dey very active to find fraudster, life wey you wan enjoy go come dey hunt you down, if there is anything I have learnt, one of them is to contented with what I have and no try to impress anybody. E get one talk wey say, "don't try to impress anybody, if only you know the rate at which the dead are forgotten" the best life wey any crypto enthusiastic fit leave naim be to dey on a coded low-key life.
1096  Local / Nigeria (Naija) / Re: Is Nigeria still practicing the rule of law? on: December 12, 2023, 08:27:31 AM
My brother, wattin you talk  na so e dey happen now, the on wey pain me pass naim be justice so, even for th justice statue Dem supposed don commot that scale balance and blind fold for the lady justice statue because these days, na so so partiality we dey experience for the hand of judges. Dem say the blind fold na for impartial justice while the scale na for weight of evidence, but both with evidence and other things, Dem still dey make judge based on wattin dem like. the justice system isn't fair anymore, it's only for the rich and the highest bidder. Make I back up wattin I dey talk, normally for Nigeria na 8 years be the maximum wey person fit operate for some political position, like governor, president etc. but for bayelsa state the APC candidate, timipre Silva don first rule for 1 year but Dem come commot am say em election been no dey free and fair, later e come contest again and e come win, e come rule for 4 years. And now e still dey come out to rule for another 4 years wey go make am 9 years, and person come go sue to court say e no go fit work, yet the court say, based on say no be e fellow political aspirant say the matter no go anywhere. Though Dem still win am Sha, but that court statement dey very wrong, irrespective of the person wey sue you to court.
1097  Local / Nigeria (Naija) / Re: Creativities contributions earns rewards. on: December 12, 2023, 06:22:39 AM
Op you have spoken well, na all this kind of advice I dey like make person wey don see road shoe others, because this na one the best idea wey I don see say newbie carry come board so, some persons dey feel like say na post be the main thing, Dem no no say e get wattin you go do to make your post get good quality, Dem say writing itself na skill, do we gats learn am and the easiest way wey we fit take learn na to read other good quality and constructive posts wey our baba dem write. So long as you dey this forum and you like grow, reading no be wattin you supposed to carry play, because na em go make your writing look professional. I remember when I join this forum new, I dey fit read threads wey get more than two pages, every single comment wey dey inside. And this practice really help me from both small and great ranked members, because some times no be every good quality post Dem dey merit, naim make I dey say even the merit system na God hand e dey, if em touch the merit person to send you merit good for you.

I no go lie you, some times Dem dey give merit based on your reputation, for example if Theymos come caugh for here, you go see say merit go full ground, even if na hello e write.
1098  Local / Off-topic (Naija) / Re: Why we must heal our inner self on: December 12, 2023, 05:59:03 AM
Op I understand wattin you dey try talk oo, now adays our children dem wey dey grow don dey too use the social media carelessly, instead of Dem to read Dem go dey Facebook or TikTok from when Dem come back for school to night, den you go come dey see sa na for morning Dem go come dey rush dey do their assignment. If to say na so we carry the social for head when we dey their age, I no sure say many of us for graduate with good result, or get hope for beta future. As the social media fit teach us bad things na so e still dey teach us good things, I remember that year wey I wan write waec, na for Facebook I been take dey get some links and learn some kind solving Dem for maths and physics. And now the forum na still social media wey we take dey get am clear small small, so only this one alone dey show say the  internet space na very wonderful environment, but if to say many of us fit serious for this forum the way we serious for other social media er for don goo far.
1099  Local / Nigeria (Naija) / Re: Naija board service thread, how una reason am? on: December 12, 2023, 05:33:26 AM
Op na better thing wey you don talk so because, na adays na online dey move market pass, if you observe well you go see, now adays people don turn their WhatsApp status to business advertising ground, and them dey make. If to say dem nor dey make, Dem for no dey do am, and WhatsApp  dey restricted to just your contact, then talk more of this forum wey na everybody go dey see your post. But wattin I get against this idea na be say, this forum almost everybody dey use guy name wey no be their real name, and that na one of the things wey dey make the forum dey anonymous. So what if person come carry your money run, there is no way wey you go fit  track that person. So e Dem go create that kind board make Dem put rules, wey go make people fear to scam other, like trade with caution, or make sure say una do physical transaction, or person wey scam go chop negative tag. So that we no go dey hear, I was scammed .
1100  Local / Nigeria (Naija) / Re: Always get alternative to your fund. on: December 11, 2023, 10:12:47 PM
E get wetting I dey always observe this days from people. Many people dey like to comot without their ATM card for pocket. and some wey dere own don expire no dey even reason to request another one from bank, because them get mobile banking app for phone forgetting say emergency fit come up at any given time wey you go dey stranded while you get money for bank.

Make I take myself for example, e get the day I go pH go buy something. So along the line agbero snatch my phone from me unknowingly and everything dey inside the phone and I get ATM card with me. I been wan comot without ATM, but I just say make I carry am along. So as the phone lost I just use my ATM card to withdraw and continue with my activities plus my TP, if not how I for do am? Because even tp self don finish for my hand because of change of price on transportation. Maybe I for turn begger for street dey find TP because how to contact person for be problem. Expecialy when person no no dey close to bank.

So make we look into this matter, because some things wey dey common fit mess us up when we least expect. So wetting ona think about am?

As I dey so, I dey hardly carry my ATM card waka for street oo, forget say ATM card fit save you for time of emergency, e fit still ruin your entire life, just imaging the example wey you say agboro pick your phone when you nor know. And you no say some persons dey like to put their ATM card for the back of their phones, and person luckily pick your phone with that ATM for inside e mean say, e go just wipe everything  wey dey your account. Forget about ATM pin, people dey run am on a daily base,Dem go just do, request for otp and from there your funds go dey burn go. so even as we dey go outside with both out phone and ATM cards make we still shine out eye make Dem for no use us do escape goat. So avoid keeping your ATM card for the back of your phone.
Pages: « 1 ... 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 16 17 18 19 20 21 22 23 24 25 26 27 28 29 30 31 32 33 34 35 36 37 38 39 40 41 42 43 44 45 46 47 48 49 50 51 52 53 54 [55] 56 57 58 59 60 61 62 63 64 65 66 67 68 69 70 71 72 73 74 75 76 77 78 »
Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!