Original Topic: [FREE TOOL] NoFomoBTC — Bitcoin Converter, Analysis, Network & Learning ToolsAuthor: irfan_pak10
NoFomoBTC — Bitcoin tools wey no get FOMOMoney changer • Analysis • Market Calendar • Network • Where una go learnbeta tools wey dem create for crypto. E no get signals. E no dey predict. E no dey promise profit.NoFomoBTC na set of bitcoin tools wey dey make especially for people wey wan know Bitcoin very well, people wey wan get useful information about bitcoin and understand am practically, without unnecessary hype or pressure.
For am to tell una wettin Bitcoin go do next, d site go help una check wettin dey happen for dat moment, e go help una study wettin happen before, e go also help una to understand d risk, and una go learn how Bitcoin dey take work normally.
1. Easy ways wey u go fit use convert Bitcoin

E go convert Bitcoin into fiat currencies and u no go get any problem with am, u go fit add plenty currency rows to compare dem values and e no go open different calculators. .
Highlights:- Live Bitcoin pricing via CoinGecko
- Na every 10 seconds him prices dey updates
- Multiple conversion rows
- Easy ways wey u go fit use see all d necessary information
2. To study how Bitcoin Price dey move

D Analysis page dey show bitcoin price history, together with it moving averages, Bollinger Bands, support/resistance zones, RSI and MACD.
Make u choose among dem 24H, 7D, 30D, 90D and 1Y views. Zoom am, pan and check d exact price points.
Important: D page dey describe how d current situation of chart looks like. Dey no dey use am predict wettin go happen in d future, and e no bi buy or sell signal.

For am to hide everything under one score, d site dey show all d observations wey contribute to that particular reading.
Breakdown includes:- Trend
- Momentum
- Volatility and levels
- Recent patterns
- Support and resistance context
Setup Quality CheckA checklist for five conditions or things wey person suppose check after he don decides to trade, to know whether na good or bad idea.
Those things wey u go check na:
- Multi-timeframe alignment
- Trend strength
- Risk-to-reward
- Distance from resistance/support
- Momentum extremes
Even though u get high score, e no mean say you're capable to trade ooo.
3. Na your AI u go use as your trainer

NoFomoBTC no go call an AI model for u ooo.
Instead, e go prepare a Socratic prompt wey go contain all your trade plan, e go contain d state of current chart and multi-timeframe readings. U go just copy dat prompt into your own ChatGPT, Claude or Gemini account.
D aim na for AI to challenge your sense of reasoning, how u go fit handle risk, exit plan and blind spots, e no go dey just predict d price for u like dat.
Dat same tool dey also compares indicators from different timeframes so dat u go understand wettin short-term readings means in another angle.
4. Strategy Backtester + Position Size Calculator
Strategy Backtester- make u replay simple historical rules
- u go con choose d test window
- u go also add d money wey dem go charge u for trading platform
- put am at d back of your mind say d price fit change anytime
- See wettin d rule for don do if una use am during d choosen period for d past
Position Size CalculatorE go calculate how much Bitcoin u go fit get based on d percentage of your account wey u dey ready to risk.
5. DCA History Explorer + Practice Trading Journal
DCA History ExplorerU fit go check how dem dey buy bitcoin before, using a particular amount and select time window. D tool dey also point out d uncomfortable part wey dey no dey usually put for headline, including when dey fail and how long e take dem to recover.
Practice Trading JournalMake u record practice trade, and also write d reason why u take dem, entry, stop, target and position size.
Dey store d journal for browser and u go fit export am as CSV.
6. Market Mood

U fit see how people dey feel through Fear & Greed indicator, along with d information about how d top cryptocurrencies dey take perform within 24-hours.
Their aim na to show market mood, not to turn people's feelings or opinions into a prediction.
7. Market Calendar — Context, Not Predictions

D Market Calendar dey follow every event wey dem schedule, the events wey dey often happen at d same time when bitcoin price dey move up and down, including:
- Fed/FOMC meetings
- US CPI and PPI releases
- Non-Farm Payrolls
- Jobless Claims
- BTC options expiry
- Bitcoin halving-related events
D calendar go dey help d users know about compulsory event, so dat dey know go surprise if dey see any sudden movement for market.
Historical ReviewMake u choose a past event type and check how Bitcoin dey normally move around previous occurrences.
D table go compares d movement of price at:
-4H, -30M, +30M, +1H, +4H, +24H and +7D.
Dis one na one of d main ideas is behind NoFomoBTC: the same type of event fit produce very different market reactions, So, na historical data dem dey show, instead of showing one simple story.
8. Bitcoin Network — The Engine Room

Dis page don stay away from price and e con show wettin d Bitcoin network itself dey do.
Live network information dem includes:- D different fee wey people are now paying for bitcoin transaction
- D normal fee wey d transaction go cost
- How busy d network dey always be
- Transaction wey dem never confirm
Dey arrange d data in a way wey people go fit understand am easily.

U also fit track:
- Number of d new mined block wey dey for bitcoin blockchain
- total energy wey all d miners they use to mine
- U go check whether any progress dey between d current halving and d next
- How much time remain before e go do d next halving
9. The Academy

D Academy get 15 well arranged lessons and e go dey track your progress.
Topics wey show for d new curriculum na, price charts, what moves prices, candle patterns, market structure, support/resistance, moving averages, RSI, volume, wallets and more.
D ones wey dey for d Academy na:
Time Machine • Glossary • Scam Radar • Crash Museum
Dey arrange d lessons in a way wey people go fit understand am easily and also practicalise am to know whether u understand am.
For example, d wallet lesson contain all dis:
- Private keys and public addresses
- Seed phrases
- Custodial vs non-custodial wallets
- Hot vs cold storage
- Practical security habits
- Short knowledge checks
Why NoFomoBTC?Sometimes crypto tools dey become another problem: signals, predictions, big claims, and d screenshot wey dey show d profits wey person fit make.
NoFomoBTC don take the opposite approach.
See the information.
Make you understand the context.
Test your ideas.
Make u manage risk.
Make u learn d system.
Make u dey make your own decisions.Visit NoFomoBTCBitcointalk •
X •
Telegram •
GitHubPrices via CoinGecko. Sentiment via alternative.me. Network data via mempool.space. Not financial advice.
na AOBT na run dis Translation by Dem self