https://www.torizone.com/posts/2023/04/109273-buhari-apologizes-administration-caused-painWen I see dis matter, I just smile dey reason, why e come dey tell us sorry when he knows say e no fit run we country but still put hand, come spoil everything. I no know watin he dey think say Nigerians go just forgive and forget every evil thing wey him tenure do us? Many life's lost, insecurity, hunger, death and many homes broken. How Nigerians wan take hear sorry? I wan us this opportunity take give una a quick review or summary of things wey happen during his 8 year of ruling wey begin on the 20 may, 2015.
2015: the Boko Haram matter wey come increase well well for the north. Many families die, communities destroy upon say the Nigeria army still try intervene for the matter.make we no forget say our presido promise say if e enter chair, e go catch all these Boko Haram them but nothing wey he fit do.
2016: the economy come fall well well, fuel price and other oil products come dey scarcel. All these matter wey come lead to economic recession.
2017:Dem come launch the anti corruption campaign matter wey Dem talk say them wan take remove all these our bad corrupt oga them for any government position. But no be all of them Dem still commot the question na why?
2018: matter of the herds men, wey come dey drive our people Dem wey dey carry farm commot from bush. Them dey kidnapp some, ask for big money while the women, them go rape them. This wan con cause our people no to dey go farm well well, wey come lead to low supply of food for the country.
2019: this wan na after e First 4 years, e con start with closure of boarder land with all neighboring country them. We e talk say e wan try reduce smuggling of goods and make Nigeria for become a productive country not a consuming wan. This matter come kill the economy well well, as people no see food chop.
2020:the end sars matter, wey start to end the brutality wey the anti robbery squad them dey run for the country. This matter come latter lead to the lekki tool gatematter wey happen on 20, October 2020. Peaceful protesters gather, government come deploy army them wey come open live fire. This wan lead to many death, many people injure. But the Nigeria government denial this matter say na fake bullet them shoot.
2020/2021: covid 19 matter, why affect the whole world. Then Dem con supply food stuffs give each state for we country make Dem take give citizens, but the governments come dey hide them for secret warehouses and no give them out to the public.our people Dem come vex go dey break all the warehouse.
2022: the Asuu lockdown wey start as at around Feb 2022 come end for October
2022.The matter we government no gree take serious come make students dey hux for 9 months and dis wan kill education sector well well for the country.
Fuel price come reach 250 per litre and scarcity come dey. Transport increase, food price increase but them no do anything.
Early 2023, central bank come change currency and them con talk say make bank stop to dey collect old notes.this matter come lead to scarcity in paper money, no new notes because all our oga them don hide am say Dem wan use am take run elections.
I no really know watin I go talk again,but e be like say all the years wey Buhari take rule the country na suffer here and there. These people them families no dey the country so e no concern them watin happen to we common people. Soon them go swear in a new government, I wan ask una watin una dey expect. Abi na the same suffer we go still see Or Nigeria go better? I no dey against we president Sha oo e try wey e take apologize, but no be everybody go take that apology. My people abeg watin una talk for this matter?
all the information about the dates wey dis matter take happen fit no day accurate, but I do research from different search engine including google [\quote]