The Nigerian police fall under the the executive arm of govt charged with the responsibility of enforcing laws and executing the policies and decisions of the government.
But if we critically analyze the definition, e go be like "what I ordered vs what I got" situation. We all know the issue wey bin happen for 2020. Even doh no be police be the reason for the protest, at least them follow due to the way dem dey take harrass motorists and commuters alike.
No be today dey don dey talk all those one jare, all na just story Nigeria police don too spoil and nothing wey any government go do now wey go change them, make we talk true if police wan do work, dem sabi work ooo but na just dis corruption dey kill dem, Wetin dey always dey their head no pass how dem go take collect money from citizens illegally na Wetin dey their head be that.
Even Wetin happen for 2020 na still police, all those sarz na one department dem dey for police, so all na still police and even as things calm down small, police harassment no still stop, police still dey do am. So I don’t know how dey wan take do am wey police harassment go stop ooo but even if e no stop, make e reduce well because police brutality don dey too much.