I bring dis up here cuz @ times we dey lost opportunities or say we dey adapt d wrong ones.
No b lie u talk shah becus 4 dis life we dey now so eh, wth d plenty hardship way dey surround pple, 2 carry money enta somtin way persn no reali sabi, e dey very hard o. Na persn way gt mind or persn way gt plenty dey fit do am.
To make moni nw dey vry hard nd e con mak say, 4 persn 2 con put am 4 were e ft lose am, na watin dey mak risk hard 2 tak.
Wen e no involve moni, e no hard persn learn o. Pple go put effort bt stil, e get som pple way b say eh, dem no dey lik wan see reason evn wen e dey clear dem 4 eye. De say learnin na continuous process nd evn theories dey get space 4 up-grade. Wen we try see truth, mak we no luk am as contrary, mak we accept am.