I think this could help the community for people like us to be self educated with those content rather than local news which I think we frequently get those update from our local news channels from TV, Radio and newspapers.
True talk but if you noticed the news talk dem dun dey reduced too because e no be like as e been dey before wey everyday thread na about politics and wetin dey sup for the election. This na local board so no too forget say na wetin dey relate to us na wetin we go dey discuss from time to talk. I dey always talk say no be about correcting people be d solution, wetin you dey do yourself to help the board. Okay so you dun notice say unrelated Bitcoin topic full for the local board so wetin you dey do to try channel people discussion go Bitcoin related topic. No be to dey talk talk without helping the mata, you self post Bitcoin stuff so other go follow you talk and dem for pick interest in Bitcoin related contents.
isn't meant for the locals or doesn't have enough quality to be posted here. Do we try to reduce our efforts that relates with local news and political tells and channel it to be more of cryptobased topics?
Crypto based contents doesn't directly relate to quality because person fit dey talk crypto talk yet nothing dey inside but person wey dey talk politics, society and other general mata dem wey dey worry the country fit dey make better sense. E no mata wetin you dey discuss but make e dey add value to the local board or other people life wey dey read am. Also it depends on wetin the community dey engage, if we reduce our engagement with all this low quality threads dem go disappear small small.
Your response always dey very solid as usual boss, and I like the fact say we dey listen and make adjustments as necessary along the way.
I sometimes no even dey fit comment because of the kinds of topics for here, but e don improve pass before.
I know say everyone no fit create BTC or crypto related topics everytime, but the fact be say this board suppose get where off topics not relating to BTC fit dey posted.
I no talk of the main general thread, but for this Naija board. So that we fit distinguish the topics for much sense to be gained and for just normal gist around.
Na just my opinion on the matter be this.