Some of us dun really experience wetin e mean to dey poor and hopeless, na why we nor dey carry bitcoin play because e dey give us hope say tomorrow go better. Before some of us wey come from really poor background dey always reason how tomorrow go better because we know say our family dey depend on us and we nor get any serious inheritance wey dem leave for us, and our families even suffer to carry us pass school, money nor even dey for dem to give us to start business, life hard been hard well well and we nor get hope on how tomorrow go be because we know say e nor easy to just get investment wey fit give person money tomorrow for this our country wey things hard, and oportunity nor dey avaialable for everyone.
Bitcoin changed everything ooo, Bitcoin give us hope say tomorrow fit better, bitcoin give us opportunity to fit dey invest the small small money we dey get into bitcoin to fit make more tomorrow. Bitcoin give us hope for this our tight country.
Wetin you think? Without investment opportunity for bitcoins, how e for be?
Yes bitcoin give hope because he don help alot of people, so especially in places where jobs are hard to find or the economy feels unstable, so people see it as a way to grow small money overtime and sometimes a kind of financial freedom, the people who usually survive in crypto are not always the smartest trader, often they are the most patient and disciplined, so bitcoin is not magic it won't solve every life problem overnight.