Op you are very much welcome, thank God say you come find our local board sharpaly, because e dey give me joy as I dey see newbies Dem wey just dey register for the forum wey come their local board. Anyway most of the links wey I see my ogah Dem give you, na links concerning this forum, and for this forum if you wan survive you gat to obey the forum rules Wella, and if you wan grow for this forum you gats do enough reading. Because even the holy bible talk am say, study to show thy self approved, so you gats study hard. Any link wey dem give you for here, try make you cover am, na for you own benefit.
I get one link to give you, that link na Mastering Bitcoin, and this one go help you understand about Bitcoin well well, if you read am go far or finish am.
Mastering Bitcoin