I know say most persons wan rank up and go wan do anything possible to get merit from the merit source but I just say make I remind us say people de actually go through the things we de write both for our post and the replies we de give and for some, them de assume say anything when de the forum de legit and so them de actually apply the information when we de pass across gor here in their real life.
So while you codedly do your stuff in the forum, make sure you are not painting a misleading narrative to people so your information won't become a source of downfall to another person who is just trying to find his way in the forum.
Try and ensure you are not framing stories just to get people attention and then end up misleading people in the long run. Make we try to not be a hypocritical member for the forum, make everything wey we talk and advice make e be weting we they do and pracrise.
Well na correct talk u talk guy. With so many members now a days wey dey try rank up, so Dem go fit join campaign, some of Dem no longer care how Dem get merit. Dem go just think say anything wey Dem post soffar e give Dem merit na d koko. D tin be say, so many members for dis forum really no know many things and Dem real reason why Dem join d forum na to learn more about cryptocurrency. But if people for forum con start to dey post anyhow ting just to rank up, then these people wey wan learn go learn wrong thing. So make we just remember say anything wey we do, make e no be for only our own good, but for d good of others.