e just dey scary how 99% of the world's data dey on the internet. Even our incognito(private browsing) data sef dey on the internet with our digital fingerprints. Me and person being dey discuss how easy e dey to actually track anybody for this earth as long as say the person dn active for internet before. if no be say some laws dey cover how this big tech company dey take collect our data, some of us wey think say we dey untracable for dn go jail sef. Everything about us actually dey internet as of now, even your "view once" for whatsapp sef. Infact any things wey you thinks say you delete still dey there only say you no get access to them again. Just dey careful of things wey you dey post for internet.
This one nah true because me seff, been don dey wonder say all those data when we dey put up for Internet despite say we dey use both normal browser and the private browser were dem really dey go? Until me seff watch one video when one UK man dey explain say any data of our self when we put up online fit dey very vital when them fit use am against us.
This no be just datas when we put up on line seff, according to the guy ehn say even deleted datas from our phone as far as that phone they connected to the Internet e fit go reach the hands of hackers
Big facts why be say dem never get any full details on the baba of bitcoin "Satoshi Nakamoto" dat baba after the creation of bitcoin just go incognito, so everything just dey like mystery. The thing is to always try to make sure your data no matter where e dey, dey completely secured.