Bitcoin Forum
May 01, 2024, 11:14:08 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: Campaign to improve posting quality for local boards(NAIJA)  (Read 315 times)
Hatchy (OP)
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 406
Merit: 461


The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID


View Profile
January 11, 2024, 07:53:10 AM
Last edit: February 10, 2024, 07:56:01 PM by Hatchy
Merited by 1miau (20), GazetaBitcoin (4), mindrust (3), Porfirii (1), EarnOnVictor (1)
 #1

 
As our local board just dey celebrate e one year anniversary, we dey happy to know say we sef naija people get our own hux for dis great forum. so far many new people don dey know about the forum and Dem don dey register account but Dem no really understand how tins take dey work work here. somany newbies, no know the rules, how to create quality post, where to post and things to avoid wey fit give you problem. Some how, no be only our newbies Dem still no know some of these tins but even some of our senior men Dem fit  no really no how to make correct quality post.

DIS NA WHY E DEY HAPPEN LIKE DAT

As Dem dey grow, Dem fit no learn these things. somany of Dem dey lucky to earn enough merit wey help Dem rank up and Dem rush enter paid signature campaign. Normally we know say dis place na where we dey come hustle and learn but so many of us no really dey take d learning part serious reach the earning. so far dis matter dey later come affect some people wen den don dey high rank. Dem go con dey get problem with posting and Dem go dey break so many rules, even dey post wrong things sef.

To dey post correct tins for dis forum go help you improve your way and manner of approach even for outside the forum. the way you talk, the way u write and even how you relate with people Dem go also improve.

e get some kind Useful information for Nigerian newbies wey as a member of our forum and nija local board u suppose no. these tins Dem go help you a long wey, to tay improve your post quality well, come make you dey amongst the top posters and also give you correct reputation for we local board and forum at large.



These ones na topics dem wey some of our correct naija board people Dem don write to tay guide we people on how to post well and not only to post well, but also to use correct English or pidgin as the case may be. we no say our local board dey accept two language wey be PIDGIN AND ENGLISH and dis one don be debate over d years even before Dem finally give us our own local board. English na general language for we country and many schools no dey allow Dem student to dey speck this pidgin at all. but we no fit leave pidgin as na him we Tay grow. na dat wan be watin Dem dey call mother language. dis language na be d first language wey every naija pikin dey understand as small pikin, before him go enter school come learn the English wey we dey speak today.

As we dey speak this pidgin, make we still understand say pidgin no just be any how language as e sef still get pattern of speech and writing. normally, some people go say pidgin no get one particular way of writing and many African countries wey dey speak am, if u listen you go hear many style wey Dem too still dey use.

pidgin dey easy to speak but when e come reach to write am, many of us no understand that one. this matter fit still affect our post. if you write better post for pidgin and you no Sabi d coco people Dem fit no understand watin you de write and Dem go pass your post as Dem no fit read am.

HOW I FIT TAKE WRITE BETTER PIDGIN ENGLISH .

Since pidgin no dey compulsory for we local board, I go say if you no Sabi write for pidgin make you just continue your post for English and avoid mixing pidgin with English. dis one fit create more problem for your readers Dem. if you must write for pidgin, then you supposed know the correct way Dem tay dey write am.
every body for we contri know about this Jehovah witnesses Dem and Dem new idea of translating so many books and even bible to pidgin. as person wey no sabi write for PIDGIN and really wan learn, you fit go Dem website JEHOVAH WITNESS and find Dem pidgin books make you read. na one of our local board members still bring dis idea come.

I also take my time, Tay find some kind articles and material wey we fit check out on how to take write and understand pidgin and if you go like, still try observe them.


The Amazing Grammar of Pidgin English


Pidgin and Education:A Position Paper

Nigerian Pidgin – 20 useful words and phrases


I DEY NEW TO THE FORUM, WATIN I SUPPOSE DEY POST.

yes, dis one na another correct question wey supposed dey the mind of every new person for we forum. d forum na one wonderful place, wey you fit learn and get correct update for anything wey concern Bitcoin, cryptocurrencies, market, sport and even global economy. but e no be like our normal Facebook or social media wey we fit just post anyhow thing as you fit enter trouble.As new person, your first concern na to learn all these different thing wey Dem dey post, read all the rules (unofficial rule of Bitcointalk) and understand how everything take dey work. the best way to take learn watin to post, na to dey observe from other members dem wey don tay and get correct reputation. this na one correct method wey some senior men go tell you say Dem tay adapt the forum and con still rank up. this one no mean say you go dey copy den style or anything, but you go use am take learn. every body get Dem unique posting style for d forum and Na e make am dey easy to detect when person buy account or hack another user account. so try develop you own, no copy person own. ones you don learn how to post and watin you go post, you go notice say you self dey improve and fit dey relate with some other correct post for forum.

WHERE TO POST?

Another thing wey some people dey find problem again na where to post. if you look the forum well, you go see say each board or child board get names and these name dey tell you watin each of Dem be and d kind post wey you fit see for there. when you create post, first you go need to know the important point for inside the post. these points, na e go let you know where you fit post am. for example, I write post, concerning issue of login for forum.This idea don already tell me say na META board na I go post this thing. Again, I write  post on how to create quality post for beginners. yes this one concern the forum, but you go come need to ask yourself if na the forum or na for newbies na you create this post. since we get board for BEGINNERS AND HELP, dat one go be the correct board for your post.
somany times, you go see some of our local member Dem de post issue wey relate to we countri for general board or for economic board. dis one no clear at all. some sef no really know how to hide fowl yansh and dem go dey fall our hand for outside we local board. this one no clear. if you get anything wey you wan discuss concerning we countri abeg try dey post am of here. na e make am we get local board.make we all learn and start to create quality post today.
ones you don understand which board to post, you go see say e go come dey easier for you to navigate the forum and understand every section and board Dem.


e get the tin wey I also want make we still know as members of we local board and if you check the rule wey Igebotz write for e thread, you go see say e sef na correct man. over d time wey I don spend for dis forum, I dey see how so many members dey complain say Dem de insult Dem or use mouth take finish Dem post for out side the localboard. yes even me don experience am and you know why you no supposed to dey reason am?
This forum na place, with many people from all over the world. every body get different perspective and idea of many things. you no expect everyone to always agree with your point all the time or give you merit. when you see somebody dey talk ill of your reply, post or comment and you know say you dey right or no too dey sure, the best thing na to learn and no too dey quick to reply. if watin e dey talk dey truth, tell am thank you appreciate and commot from that place. no go dey let Dem put eye for your account or come do watin go lead Dem to tag your account. ones dem dey talk watin no correct, if you understand am pass Dem. you fit follow Dem talk but if you no know just rest.  
if Dem dey curse you no rush dey throw words as e fit Damage your reputation for forum. other people go surely support you if you dey right no need to come dey create fight.
dis issues, dey common for forum and we local board. I don see so many situations wey men go dey argue watin no reach to argue and small small e don turn quarrel. abeg make we dey show good example and maintain correct discipline for here as these white people Dem dey strict. admin dey watch us, so if we dey always make fights for we Localboard, Dem no go dey answer us.


WATIN BE OFF TOPIC AND WHERE I FIT POST AM

I no say somany new members go don dey see dis off topic well well and come de ask Dem sef say how I go tay know say na off topic post I dey create. well, off topic no get one definition. off topic na post wey no fit into any board. that one mean say d topic no concern anything wey we suppose dey discuss for forum but you just feel like say you wan create am as thread. yes e get so many matter wey we de like discuss no be everytime or everything be money. things dey outside those ones but Dem no too dey necessary for we forum na e make we get off topic board for general forum and some local boards. for now, we local board never get this sub board and we sef don request for am but still no response from admin Dem. As at last year, d rate of this off topic post come too much and e con turn to spam as person no fit see better topic talk put for we local board. All these kind low quality post no good at all. as e dey make we board dey somehow for everyone. make we try dey avoid all these kind post wey be off topic and as I explain am, no be say Dem no get use but here no be Facebook. so we suppose dey limit all those kind topic for forum.


so far, I don list all these many points wey I think say go help improve our posting for local board and forum at large. this campaign originally na 1miau idea co supported by Gazetabitcoin. I don try make sure say I chuck mouth put for those matter Dem wey I don come across for we local board well well. Abeg make We try dey create good post as e go help us well as we dey grow for rank until we don commot from forum.


some additional threads Dem wey go fit help us improve quality posting

Some avoidable forum mistakes of Newbies

[TIPS] to avoid pyramid quotes (for Newbies)

Why people plagiarise in the forum and how to avoid plagiarism.


you fit go read the original thread wey 1miau create for here: Campaign to improve posting quality for local boards

Also read quote from 1miau on quality posting:
Quote
Providing a good posting quality is essential to keep Bitcointalk’s role as an important source of Bitcoin-related content, with hopefully some new people signing up here and of course, established members staying active and not leaving Bitcointalk.

Since Merit is not limited to prevent spammers from joining Bounty Campaigns, Merit was also introduced to encourage more interesting content and Merit Sources are advised to facilitate and reward good content, while discouraging bad, uninteresting or flawed posts such like Shitposts.

I’ve tried to incentivize a good posting quality in our German local board by my 1miau Merit criteria, where I’ve outlined points resulting in Merits and points making it much less likely to receive some Merits.


na AOBT na run dis Translation by Dem self

███████████████████████████████▀▀▀▀
███████████████████████████████
█████████▀▀▀▀▀█▀█▀▀▀▀▀█████████
███▄▀▀▀   ▄▄▄▄   ▄▄▄▄   ▀▀▀▄███
███████▀▀▀████▌ ▐████▀▀▀███████
█████▀███▀█▀██▌ ▐██▀█▀███▀█████
███████▀▄▀▄███▌ ▐███▄▀▄▀███████
█████▄██▄██▄██   ██▄██▄██▄█████
███████▄▄▄████   ████▄▄▄███████
██████████▀▀▀▀   ▀▀▀▀██████████
██████████▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄██████████
███████████████████████████████
███████████████████████████████▄▄▄▄
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
.
TRUST DICE
.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
█▀▀▀











█▄▄▄
#1 RATED CRYPTO
CASINO IN THE WORLD
██ ██ ██ ██ █Trustpilot
▀▀▀█











▄▄▄█
▄█████████████████████████████
██████████████████▀▀█████▀▀████
█████████████████▀█████████▀███
██████████████████████████████
███████████████████████████▄███
█████████████████████████▄▄████
███████████████████████████████
█████████████░░░███████████████
███████████░░░█████████████████
█████████░░████████████████████
█████░░░██████████████████████
███░░█████████████████████████
▀░░░█████████████████████████▀
█▀▀▀











█▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
1714605248
Hero Member
*
Offline Offline

Posts: 1714605248

View Profile Personal Message (Offline)

Ignore
1714605248
Reply with quote  #2

1714605248
Report to moderator
1714605248
Hero Member
*
Offline Offline

Posts: 1714605248

View Profile Personal Message (Offline)

Ignore
1714605248
Reply with quote  #2

1714605248
Report to moderator
The network tries to produce one block per 10 minutes. It does this by automatically adjusting how difficult it is to produce blocks.
Advertised sites are not endorsed by the Bitcoin Forum. They may be unsafe, untrustworthy, or illegal in your jurisdiction.
Bright0515
Member
**
Offline Offline

Activity: 96
Merit: 22


View Profile
January 11, 2024, 12:35:03 PM
 #2

Bro I swear this one na one of the best topics I Dom see for this local board e come be like say you talk my mind we as the newbies sometimes you know go know and understand the kind thing wen you go post and no be everything person supposed post regardless as Dem call am local naija board no mean say everything you post go dey scattered sometimes you fit post sef person no go understand and read wetin you dey post after you write finish go back to de beginning Read wetin you write e go help you well well many newbies just depend on the merit Dem no wan hear if Dem write up make sense or not if you no get wetin to post just come online read people post e go give you motivation and help you understand how the forum dey work and e dey very important to read wetin de rules Dem talk before you cause problem for yourself.
Hatchy (OP)
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 406
Merit: 461


The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID


View Profile
January 11, 2024, 12:51:31 PM
 #3

Bro I swear this one na one of the best topics I Dom see for this local board e come be like say you talk my mind we as the newbies sometimes you know go know and understand the kind thing wen you go post and no be everything person supposed post regardless as Dem call am local naija board no mean say everything you post go dey scattered sometimes you fit post sef person no go understand and read wetin you dey post after you write finish go back to de beginning Read wetin you write e go help you well well many newbies just depend on the merit Dem no wan hear if Dem write up make sense or not if you no get wetin to post just come online read people post e go give you motivation and help you understand how the forum dey work and e dey very important to read wetin de rules Dem talk before you cause problem for yourself.

Na better idea wey 1miau initiate and e don Tay wey I dey compile the thread(2months now). I hope our people Dem go read am as e dey very important for everyone wey dey we Localboard. Just as you talk am, the topic hit some major point wey I see say most newbies dey suffer well well wen Dem newly come. If Dem take time read am, Dem go see how Dem fit tay counter this issues and small small adapt to the forum and create quality post. Bitcointalk na one interesting place to dey among but if you no understand the place, you fit no last for here. Make we try read this post as e go dey useful for everyone no be only newbie self.

███████████████████████████████▀▀▀▀
███████████████████████████████
█████████▀▀▀▀▀█▀█▀▀▀▀▀█████████
███▄▀▀▀   ▄▄▄▄   ▄▄▄▄   ▀▀▀▄███
███████▀▀▀████▌ ▐████▀▀▀███████
█████▀███▀█▀██▌ ▐██▀█▀███▀█████
███████▀▄▀▄███▌ ▐███▄▀▄▀███████
█████▄██▄██▄██   ██▄██▄██▄█████
███████▄▄▄████   ████▄▄▄███████
██████████▀▀▀▀   ▀▀▀▀██████████
██████████▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄██████████
███████████████████████████████
███████████████████████████████▄▄▄▄
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
.
TRUST DICE
.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
█▀▀▀











█▄▄▄
#1 RATED CRYPTO
CASINO IN THE WORLD
██ ██ ██ ██ █Trustpilot
▀▀▀█











▄▄▄█
▄█████████████████████████████
██████████████████▀▀█████▀▀████
█████████████████▀█████████▀███
██████████████████████████████
███████████████████████████▄███
█████████████████████████▄▄████
███████████████████████████████
█████████████░░░███████████████
███████████░░░█████████████████
█████████░░████████████████████
█████░░░██████████████████████
███░░█████████████████████████
▀░░░█████████████████████████▀
█▀▀▀











█▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
Makus
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 322
Merit: 214

Bitcoin!!


View Profile WWW
January 11, 2024, 01:09:06 PM
 #4

Sharp, e clear die. Like this now I don get thread wey I fit dey recommend dey give newbies make Dem for use take perfect their posting quality, including some high rank member and my self. Omor only the translation sef nor easy, op you don try, better thumbs up for you and this translation team wey dey package this level. Na all this kind things we need for this forum. Anyway e go still good make others too come read make them learn, dem say learning no get end, na why we need to dey update our selves  once once.
Chilwell
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 560
Merit: 408


The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID


View Profile WWW
January 11, 2024, 04:11:40 PM
 #5

I wan give references to @chilwell, for the additional link wey e suggest. Thank you brother.
Three boza for @Hatchy, truly you have try very well because this topic of yours is very very important to our local board, not only newbies will benefit from this even the higher rank will benefit too, if I have the capacity I will definitely pin the thread at the first page of our board. My appreciation goes to the originator of the topic 1miau and GazetaBitcoin, and other sponsors. My special salute goes to Hatchy for bringing this enlightenment close to us by translating it to the language we can read and understand.

R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBIT|
4,000+ GAMES
███████████████████
██████████▀▄▀▀▀████
████████▀▄▀██░░░███
██████▀▄███▄▀█▄▄▄██
███▀▀▀▀▀▀█▀▀▀▀▀▀███
██░░░░░░░░█░░░░░░██
██▄░░░░░░░█░░░░░▄██
███▄░░░░▄█▄▄▄▄▄████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
█████████
▀████████
░░▀██████
░░░░▀████
░░░░░░███
▄░░░░░███
▀█▄▄▄████
░░▀▀█████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀
█████████
░░░▀▀████
██▄▄▀░███
█░░█▄░░██
░████▀▀██
█░░█▀░░██
██▀▀▄░███
░░░▄▄████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀
|
██░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░██
▀█▄░▄▄░░░░░░░░░░░░▄▄░▄█▀
▄▄███░░░░░░░░░░░░░░███▄▄
▀░▀▄▀▄░░░░░▄▄░░░░░▄▀▄▀░▀
▄▄▄▄▄▀▀▄▄▀▀▄▄▄▄▄
█░▄▄▄██████▄▄▄░█
█░▀▀████████▀▀░█
█░█▀▄▄▄▄▄▄▄▄██░█
█░█▀████████░█
█░█░██████░█
▀▄▀▄███▀▄▀
▄▀▄
▀▄▄▄▄▀▄▀▄
██▀░░░░░░░░▀██
||.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
░▀▄░▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄░▄▀
███▀▄▀█████████████████▀▄▀
█████▀▄░▄▄▄▄▄███░▄▄▄▄▄▄▀
███████▀▄▀██████░█▄▄▄▄▄▄▄▄
█████████▀▄▄░███▄▄▄▄▄▄░▄▀
███████████░███████▀▄▀
███████████░██▀▄▄▄▄▀
███████████░▀▄▀
████████████▄▀
███████████
▄▄███████▄▄
▄████▀▀▀▀▀▀▀████▄
▄███▀▄▄███████▄▄▀███▄
▄██▀▄█▀▀▀█████▀▀▀█▄▀██▄
▄██▄██████▀████░███▄██▄
███░████████▀██░████░███
███░████░█▄████▀░████░███
███░████░███▄████████░███
▀██▄▀███░█████▄█████▀▄██▀
▀██▄▀█▄▄▄██████▄██▀▄██▀
▀███▄▀▀███████▀▀▄███▀
▀████▄▄▄▄▄▄▄████▀
▀▀███████▀▀
OFFICIAL PARTNERSHIP
FAZE CLAN
SSC NAPOLI
|
Samlucky O
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 280
Merit: 190


The great city of God 🔥


View Profile WWW
January 11, 2024, 07:29:19 PM
 #6

@hachy I really appreciate the effort you make by creating this thread. e go go along way for people wey get so much questions to ask. The problem wey dey here na Every body dey busy dey find wey to meet up to there target. Most people here especially those wey Dey campaign like bitvest and eloncoin, You go notice say dem dey struggle to meet up weekly quota and also to add contribution to the forum. e come be like say attention dey devided to even correct somethings wey dey happen here na problem. Most people get the mindset say my work is to make post and get paid every week and not to teach anybody anything. while Most people dey struggle to rank up enter better signature and na those things naim dey make e come be like say many people no dey contribute. No be say people no dey answer their questions but most at times newbies no dey focus on old thread or view profile of legendaries and other hero members wey don become wetting dem be today. Sothat them fit learn from them. Most people dey alway bring out their mind to educate them but the more you keep educating the one wey dey, the more many people dey come creat thread. E for say the forum na place wey be say e dey batch by batch, like maybe 20 people at once wey dem go teach sotay dem go understand am fully before another set go come, e for better but since e no dey like that, e go dey difficult. Countless times wey newbies don ask question about how the forum works, people give them exactly all this link you bring here, but still dem no read am. but dem continue to dey post wetting them like. so human being na the Most difficult thing to Control. Even as you don drop this laydown procedure, you go still notice say if New person come today come ask question and then send this your thread for them to learn, them go see am say e too long to read and them go continue wetting dey there mind. So we go try our best but make dem too dey form the habit of reading rather than posting. If you check about 4months ago when Most of come here, you go notice say shitpost been plenty, naso dem keep to dey reapeat am untill people come get to know about am. but of recent alot of newbies don full everywhere with the mindset of to quick rankup and enter campaign. and the shiposting don also increase. so I believe na gradual Process dem go still learn about how the forum dey work. even me wey dey talk I still dey the learning process too.

Hewlet
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 266
Merit: 114



View Profile
January 11, 2024, 07:52:49 PM
 #7

This is a good combination of key elements that would help improve the posting quality in the local board and if like say them de pin thread for the board, e for make sense to even pin this one join and on a regular bases, you fit de add useful information when go also de helpful to the board.

As we know we use verbal communication for here, e de very necessary make we sabi how to write and write am in a way when go de inline with the vision of the board.

I understand say no be everybody really de used to this writing with pig in stuff but if we fit de write more with pig in e go make sense. I done go through the pigin link when you drop and e De informative to a large extent but one sweet thing about nija pigin be say you no need learn am or rehearse am, all you need na to yarn am the way e be you and e go send the information to the receiver.

███████ ███████        R O L L B I T        CRYPTO'S MOST INNOVATIVE CASINO        [ PLAY NOW ]        ███████ ███████
//     TRADE RLB NOW!     //
███████ ███████ ███████            OFFICIAL EUROPEAN BETTING PARTNER OF SSC NAPOLI           ███████ ███████ ███████
Majestic-milf
Hero Member
*****
Offline Offline

Activity: 798
Merit: 589



View Profile
January 12, 2024, 06:32:05 AM
 #8

 My guy @Hatchy this nah beta work you do here and by right you sopoz collect water, but my drum don finish and I really believe say the more people read this your yarn beta changes fit occur and nah the prayer be that. Big ups to @1miau and all the AOBT gang them for this initiative.
E get wetin I wan tok and I believe say others go follow me put mouth. No be say this work no make sense o but I feel say those wey wan still make the mistake go make am because we don see how some newbies their problem nah how to follow simple instruction and I know say this no be only for them alone but we feel say e go reach the intended audience? Abi e get wetin we need to do more for this kind issue of low quality posts and spam to reduce? I say make I ask.
 

R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBIT
  CRYPTO   
FUTURES
 1,000x 
LEVERAGE
COMPETITIVE
    FEES    
 INSTANT 
EXECUTION
.
   TRADE NOW   
knowngunman
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 588
Merit: 316



View Profile WWW
January 14, 2024, 10:45:21 AM
 #9

E get wetin I wan tok and I believe say others go follow me put mouth. No be say this work no make sense o but I feel say those wey wan still make the mistake go make am because we don see how some newbies their problem nah how to follow simple instruction and I know say this no be only for them alone but we feel say e go reach the intended audience? Abi e get wetin we need to do more for this kind issue of low quality posts and spam to reduce? I say make I ask.

This one no be matter of following simple instruction ooo the problem with our newbies na reading and nothing more. Dem no like to read and comprehend anything because if dem dey read, dem go definitely follow instructions since dem wan go far for Forum and no one go dey happy to see his account ban or post deleted for not up to standard. Even for school exams, you go read the instructions and questions before you begin write. If you no wan read, you go end up doing the wrong thing. Dem think say being successful in this forum is by how you sabi write.

If we succeed to get sub board and moderator now, important thread like this supposed dey pin for everyone to see always when they visit local board. This week alone I don see like five thread for this board wey be either not necessary, repetition and or in the wrong place but I no wan point fingers yet. I still dey observe first to see them change after they've been guided. No be by force to create post in the local board, follow discussion in the comments section and people go still see am. For their mind, creating a post will catch attention and probably get merit not also knowing that it exposes your flaws to the public.

R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBITCRYPTO
FUTURES
[
1,000x
LEVERAGE
][
.
COMPETITIVE
FEES
][
INSTANT
EXECUTION
]██████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██████
████████████████████████████████████████████████████████
.
TRADE NOW
.
████████████████████████████████████████████████████████
██████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██████
Hatchy (OP)
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 406
Merit: 461


The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID


View Profile
February 02, 2024, 09:08:57 AM
 #10

My people Una dooh, I dey bump this thread just so our newbies dem go fit still read and understand how to make correct post for we local board. With the current idea wey @ Igebotz don Carry come, I don see say d newbies come dey try if at all dey create correct discussions for we lb. E go still good make Dem still try read through this post as e dey educative and go direct them well on how to create correct post.

███████████████████████████████▀▀▀▀
███████████████████████████████
█████████▀▀▀▀▀█▀█▀▀▀▀▀█████████
███▄▀▀▀   ▄▄▄▄   ▄▄▄▄   ▀▀▀▄███
███████▀▀▀████▌ ▐████▀▀▀███████
█████▀███▀█▀██▌ ▐██▀█▀███▀█████
███████▀▄▀▄███▌ ▐███▄▀▄▀███████
█████▄██▄██▄██   ██▄██▄██▄█████
███████▄▄▄████   ████▄▄▄███████
██████████▀▀▀▀   ▀▀▀▀██████████
██████████▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄██████████
███████████████████████████████
███████████████████████████████▄▄▄▄
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
.
TRUST DICE
.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
█▀▀▀











█▄▄▄
#1 RATED CRYPTO
CASINO IN THE WORLD
██ ██ ██ ██ █Trustpilot
▀▀▀█











▄▄▄█
▄█████████████████████████████
██████████████████▀▀█████▀▀████
█████████████████▀█████████▀███
██████████████████████████████
███████████████████████████▄███
█████████████████████████▄▄████
███████████████████████████████
█████████████░░░███████████████
███████████░░░█████████████████
█████████░░████████████████████
█████░░░██████████████████████
███░░█████████████████████████
▀░░░█████████████████████████▀
█▀▀▀











█▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
DubemIfedigbo001
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 294
Merit: 229


Let love lead


View Profile WWW
February 02, 2024, 11:48:08 AM
 #11

My people Una dooh, I dey bump this thread just so our newbies dem go fit still read and understand how to make correct post for we local board. With the current idea wey @ Igebotz don Carry come, I don see say d newbies come dey try if at all dey create correct discussions for we lb. E go still good make Dem still try read through this post as e dey educative and go direct them well on how to create correct post.
Nice one brother, this your post suppose dey pinned for this board sef, na say we never get  moderator now be the problem, post wey get this kind quality na wetin we for use dey welcome newbies for the local board, like em suppose be a must read for everybody, e go good make you dey bump am even if na every first week on a new month, make the idea dey fresh for people mind, Low quality posting na one of the things wey make me no dey too post for this board unlike before. The thing just get as em be and I go like make @theymos give us moderator so these mumu posts our moderator go fit dey delete them to help arrange this our local board the way em suppose dey. I remember one time wey I make one post for Bitcoin discussion board, that one na say I do plenty typographical error, no be say na off-point ooo, within two hours, the moderator there don delete am and the thing make me dey very careful anytime I wan post for that board till date. That kind thing go help make all the shit posters dey very careful with them post quality because them know say any rubbish post wey them make no go last for the board

Su-asa
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 266
Merit: 196


Can't go home alone.


View Profile
February 03, 2024, 06:06:45 AM
 #12

Sharp, e clear die. Like this now I don get thread wey I fit dey recommend dey give newbies make Dem for use take perfect their posting quality, including some high rank member and my self. Omor only the translation sef nor easy, op you don try, better thumbs up for you and this translation team wey dey package this level. Na all this kind things we need for this forum. Anyway e go still good make others too come read make them learn, dem say learning no get end, na why we need to dey update our selves  once once.
We really needs this threads in our local board so that the we and the new guys can be able to see them and improve our post qualities.
The OP of this discussion have done well to translate this post in our own local languages because as this is a local board, not everyone here knows how to write in English but they know little about the local pidgin language the OP did well, from beginning it is not easy to translate the whole of this discussion to our local languages.

Makus
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 322
Merit: 214

Bitcoin!!


View Profile WWW
February 03, 2024, 06:15:39 AM
 #13

We really needs this threads in our local board so that the we and the new guys can be able to see them and improve our post qualities.
The OP of this discussion have done well to translate this post in our own local languages because as this is a local board, not everyone here knows how to write in English but they know little about the local pidgin language the OP did well, from beginning it is not easy to translate the whole of this discussion to our local languages.

If to say I reputation don high for this forum I for tell our local board moderator to pin this thread for front, so that e no go dey give down again, cause this kind thread naim good make we pin, so that any newbie wey first come go sit down read am, before them start to post. I no say off topic no dey easy to separate from newbies but as time goes on them go learn, but first them need guide, and na em be this. Newbies abeg make una dey try read something like this, na the only wey when una go take learn fast.
Pi-network314159
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 210
Merit: 124


View Profile
February 04, 2024, 02:24:19 AM
 #14

We really needs this threads in our local board so that the we and the new guys can be able to see them and improve our post qualities.
The OP of this discussion have done well to translate this post in our own local languages because as this is a local board, not everyone here knows how to write in English but they know little about the local pidgin language the OP did well, from beginning it is not easy to translate the whole of this discussion to our local languages.

If to say I reputation don high for this forum I for tell our local board moderator to pin this thread for front, so that e no go dey give down again, cause this kind thread naim good make we pin, so that any newbie wey first come go sit down read am, before them start to post. I no say off topic no dey easy to separate from newbies but as time goes on them go learn, but first them need guide, and na em be this. Newbies abeg make una dey try read something like this, na the only wey when una go take learn fast.
Exactly. This matter wey you talk so Naim be wetting just dey my mind. Say make them pin this thread for our local board sothat all those newbie wey dey come no go too much dey ask Unnecessary questions concerning how the forum they work or not. But with this everything them need don dey in a place. So no need to stress anymore.
Bright0515
Member
**
Offline Offline

Activity: 96
Merit: 22


View Profile
February 04, 2024, 06:30:48 AM
 #15

It is true that something you don't know is noteless but still many people don't care about knowing it. For me I think the four ( W's ) which is the Where, When, What and Why must be observed by every poster. Make we no carry our hand as them say na local come carry over local things come scatter our own home because this ( LOVAL BOARD ), I see am as one of the best and simple place for everyone but we come dey take am for granted.
No body is perfect up till now me I Neva know everything  here so na to melo down follow this forum step by step Omo no carry the hustle play oo, quality post matters a lot newbies need to go through the forum reading rules and reading the kind of posts before posting u fit dey in a haste to post u post ur account join am. Naija bro abeg make we make our own board quality.
Hatchy (OP)
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 406
Merit: 461


The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID


View Profile
February 10, 2024, 07:52:55 PM
 #16

Bump.

███████████████████████████████▀▀▀▀
███████████████████████████████
█████████▀▀▀▀▀█▀█▀▀▀▀▀█████████
███▄▀▀▀   ▄▄▄▄   ▄▄▄▄   ▀▀▀▄███
███████▀▀▀████▌ ▐████▀▀▀███████
█████▀███▀█▀██▌ ▐██▀█▀███▀█████
███████▀▄▀▄███▌ ▐███▄▀▄▀███████
█████▄██▄██▄██   ██▄██▄██▄█████
███████▄▄▄████   ████▄▄▄███████
██████████▀▀▀▀   ▀▀▀▀██████████
██████████▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄██████████
███████████████████████████████
███████████████████████████████▄▄▄▄
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
.
TRUST DICE
.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
█▀▀▀











█▄▄▄
#1 RATED CRYPTO
CASINO IN THE WORLD
██ ██ ██ ██ █Trustpilot
▀▀▀█











▄▄▄█
▄█████████████████████████████
██████████████████▀▀█████▀▀████
█████████████████▀█████████▀███
██████████████████████████████
███████████████████████████▄███
█████████████████████████▄▄████
███████████████████████████████
█████████████░░░███████████████
███████████░░░█████████████████
█████████░░████████████████████
█████░░░██████████████████████
███░░█████████████████████████
▀░░░█████████████████████████▀
█▀▀▀











█▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!