For the first time when I join this forum I just dey stagnant dey observe like fowl wen go new place.
If u just join dis forum, e dey sure say u go just first confuse, me as I first join, I no even sabi Wetin I go even dey post, and person wey tell me about dis place don tell me how things dey happen for here, so I dey fear to post because I no wan go fuck up. Make I no go talk something, make people go dey enter me, so I just lock up dey observe, just dey follow Wetin people dey talk, na small small me self come dey understand how things be I come get mind dey post small small.
Then I still get some places where I still fear to enter or post something after my first and second week in the forum e.g
The economic board.
The Bitcoin discussion board.
I no come dey fear to talk for those two sections wey you mention above, the once wey I no dey vibe to post for na reputation section, and Technical board, and uptill now, I no dey post for those two places. If you no sabi talk, dey go just spoil person account for those places, you fit don talk something wey one of all those high rank no like, him go just dey monitor you, him go dey wait make you fuck up even if na small before him go attack you, na why me I dey always dey places wey dey lowkey.