Newbies abeg, make ona no come this forum dy spoil our reputation abeg, I been don talk this thing before, this go be the last time I go talk this thing, after this na reporting I go start to dy do, no be naija bad pass oo, most of us never even comot for this country before but na to busy dy talk how we bad reach give the whole world as if we don test other countries see.
As I see the post, my body just weak, I don’t even know what to say, I checked the person wey post am posting history, and I see say na from Nigeria self, how you go post that kin rubbish for general thread just because of merit, because Wetin I know say d person dey look for no pass merit, you dey spoil your country reputation for other people eye just because you want make dem give u merit, and after posting the rubbish, him no still receive any merit. No matter how bad our country is, at least him no suppose go dey open our yansh for all those oyinbo make dem see, if him talk things like dis for local board, e no go too pain me, na just other section wey him carry am go vex me pass.
Seriously I don’t think anything can be done about it even if you report the person, dey fit just move d post commot for d section wey him post am go another section. Abeg make we just dey think first before we dey post, all those posts no really make sense, and if anybody carry person come dis forum, make dem dey try monitor people wey dem carry come. Person wey make that post lack orientation about the forum, him dey reason say na posts like that go give am merit.