So i suggest we focus more on accumulating and holding Bitcoin, because as Bitcoin rise so, people wey benefit from it are the holders, no allow anybody deceive you, for this crypto world, holders nail dy make money pass people wey dy trade, anybody wey dy say, him dy make so so and so in trading dy lie, because trading no easy as most people or influencers dy paint am as, abeg, if we go succeed in this business, try to be a holder, because na Dem dy benefit pass.
Nah sense you just talk so, to be honest I nor let this exchange (binance) issues, affect my accumulating of bitcoin because I get other backup (exchanges) make I tey dey run my p2p stuff. If you dey think of making good money in trading you know you first funds well, because people with less funds are always greedy. Just imagine say you get $10million and you wan trade no need to even increase your leverages(future trading) you can just put it in x1 or x2 even lesser seff or you can even use Spot trading seff . And from the $10million you remove $1million tey trade , just one movement like 2% you dun ready dey In huge profit and using Such small leverages as a future trader, your liquidation amount won't be showing that means before your funds go liquidate that particular coin need to rise with one kind mad, massive percentage and e go hard before e happen.
But as trader with less funds there are always craving for huge profits which would lead them, in making some silly mistakes like trading with some insane high leverages so that they can endup with something huge with small amount of funds and the end them go endup losing all funds through liquidation or making different losses in different trading interval.
When come to holding to me is just the best, I know say he nor easy because many testing of emotions full am like when you go see your portfolio, they rise like those days rice for pot (now and days rice nor dey rice) e go dey tempt you to withdraw that investment, wey still dey premature state but if you get better principles towards hodl, and good cash slow then you duh make am be that because you go fit dey accumulate smoothly without no stress.