Ona good day ooo. Sometimes I dey wonder waiting this world or this country for look like if crypto been no dey because the rate of hardship in this country is too much and waiting dey cause some of this hardship na selfishness and man know man which most people call tribalism. Imagine where pesin go commot go look for work pesin wey dey in charge go tell you say no vacancy or chance for you mean while there is vacancy and you are qualified for the task but because you are not from same place with them, they will deprived you of the opportunity. Now, those vacancy, chance or slot they use to buy it and the people wey dey buy am na the big men, so times dey go buy slot keep for pesin wey no dey qualify for the job or dey go buy am keep for pesin wey never graduate from school. All these things dey very annoying, in fact e dey discouraging but I go advice everyone to keep pushing one day e go turn around for your good. However, crypto don make so many people no to get interest for all those company work because you fit dey your house dey make your cool money, nobody dey stress you, nobody to disturb you, you fit sleep anytime you want and wake up continue your work, you decide if you go work or not. Crypto is really helping, I get friends for school wey no get parents and right from our first year in school they have being paying their fees with the help of crypto, crypto has given a lot of skilled and unskilled individual hope or reason to survive. Crypto is really sweet and amazing because those salary wey company dey pay worker month end in crypto you fit make the money 1 or 2hrs depending na so crypto sweet reach.
Bros no loud am ooo, crypto na life jacket for this country, e don make people comfortable and reduced crime rate. The one wey dey sweet me pass na the crime rate wey em reduce, now we dey waka anywhere, anytime for my area. The hardship dey increase steadily, but person wey sabi crypto activities no dey feel am too much.
These period business people dey hear am because customers never belefull, na which money them wan take patronize you, na only food related businesses dey survive small here. Companies sef dey use artisans dey play wella now because them know well say hunger day.
All thanks to God and crypto, I no dey send who wan carry me play because I no dey beg for food and I dey make sure say them understand am before I start any transaction or contract with clients.
Crypto saved me and us all from this punishing economy imposed on us by wicked leaders.