DaNNy001
|
|
April 11, 2024, 10:27:00 PM |
|
As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover. Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this. My people na wetin I get to share be this o.
Well my brother I know why I missed this your topic since but as I see am sef e never too late to shuk mouth put, for me watin I believe say the actual reason wey make dem give us this our local board na unto say we dey active well well but the clear fact na say we get local language which is the general pidgin because I believe if to say who ever dey give local board come hear na English we wan dey write and communicate here, I for reason say maybe he fit no even grant the request.
|
| CHIPS.GG | | | ▄▄███████▄▄ ▄████▀▀▀▀▀▀▀████▄ ▄███▀░▄░▀▀▀▀▀░▄░▀███▄ ▄███░▄▀░░░░░░░░░▀▄░███▄ ▄███░▄░░░▄█████▄░░░▄░███▄ ███░▄▀░░░███████░░░▀▄░███ ███░█░░░▀▀▀▀▀░░░▀░░░█░███ ███░▀▄░▄▀░▄██▄▄░▀▄░▄▀░███ ▀███░▀░▀▄██▀░▀██▄▀░▀░███▀ ▀███░▀▄░░░░░░░░░▄▀░███▀ ▀███▄░▀░▄▄▄▄▄░▀░▄███▀ ▀████▄▄▄▄▄▄▄████▀ █████████████████████████ | | ▄▄███████▄▄ ▄███████████████▄ ▄█▀▀▀▄█████████▄▀▀▀█▄ ▄██████▀▄█▄▄▄█▄▀██████▄ ▄████████▄█████▄████████▄ ████████▄███████▄████████ ███████▄█████████▄███████ ███▄▄▀▀█▀▀█████▀▀█▀▀▄▄███ ▀█████████▀▀██▀█████████▀ ▀█████████████████████▀ ▀███████████████████▀ ▀████▄▄███▄▄████▀ ████████████████████████ | | 3000+ UNIQUE GAMES | | | 12+ CURRENCIES ACCEPTED | | | VIP REWARD PROGRAM | | ◥ | Play Now |
|
|
|
nelson4lov
|
|
April 11, 2024, 10:28:29 PM |
|
Sometimes when you come see some things as e be, e just dey best to go with the flow. I used to have some differing opinions about the English vs Pidgin as mediums for discussion in the local board but my views been don change since. The truth is that Pidgin is not even our local language but is passed as such.
The way I think about it is this: If English speaking countries like US get local board on the forum, their conversations go still dey for English but it would just be centered on matters concerning their country and very little weight on sharing discourse in languages only them with understand.
|
|
|
|
Mate2237
|
|
April 11, 2024, 10:39:10 PM |
|
Really when dey dey enter other local boards we dey see say one English sef we no go see but here in our local board na only English we dey sef and when someone say why we dey use English hen plenty people go come attack di person say why him go talk dat kind things. Normally using English here e no make sense but not everyone can use the pidgin English to write fluently. But even as dat no Nigerian no go fit use small pidgin write it do person finish secondary school and dey write for here abi na England she go school?
Sometimes when other local boards go mentioned my name I go enter their I no understand anything so I would just carry my head come back again but here. Anyone wey come here go understand everything finished. Nai be another problem dem dey attack us well well for outside Board.
|
|
|
|
Coyster
Legendary
Online
Activity: 2170
Merit: 1293
Crypto Casino and Sportsbook
|
|
April 11, 2024, 10:41:54 PM |
|
I think say we don bury this discussion about either using pidgin or English, either as post subject or content of our post for this local board. I dey use the two of them, e dey depend on wetin i wan talk and on my mood at the time of making the post, both English and Pidgin is allowed, and you fit even mix the two of dem for one post, just as i am doing now. Why are you concerned about wetin non-Nigerians go think when they visit our local board, check the Indian local board, na posts for English language full there, because English follow for language wey dem dey speak well well for their country, just like in ours. So make we just die this matter, na quality posts matter, be it in English or in Pidgin.
|
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1582
Merit: 1141
|
|
April 11, 2024, 11:44:18 PM |
|
Having the title or the post in Pidgin is not necessary. If you like, post in English. If you like, post in Pidgin. We do not have to force anyone to post in Pidgin.
For my post above, where I force person to post for pidgin. Abi I no dey entitled to my opinion again? Please, we are having peace already, no need of bringing what is not.
E get the time wey war dey for here? I no too understand the way you carry respond to this post, hope say nothing sup. Na watin I been wan recount shah, the time way we been Dey argue here which of the language we go like put for front for the locale and we later resolve to use both Pighin and English via say, both na spoken tongue for we Naija. Some people even come up with threads way you go speak Yoruba and some other major tribal language but all that don die down now shah, the plenty English don wash them commot so, I see watin you Dey try talk at OP. I for like am well well to come here Dey read pighin o but, the fight has always been based on interest and watin Dey comfortable with everybody. So everybody fit pick sides and participate. Everybody or most people fit speak but, no be everybody fit write and you wonder how…? Meanwhile, e go first Dey rock am Dey go like this.
|
|
|
|
uchegod-21 (OP)
|
|
April 12, 2024, 06:36:09 PM |
|
Really when dey dey enter other local boards we dey see say one English sef we no go see but here in our local board na only English we dey sef and when someone say why we dey use English hen plenty people go come attack di person say why him go talk dat kind things. Normally using English here e no make sense but not everyone can use the pidgin English to write fluently. But even as dat no Nigerian no go fit use small pidgin write it do person finish secondary school and dey write for here abi na England she go school?
Sometimes when other local boards go mentioned my name I go enter their I no understand anything so I would just carry my head come back again but here. Anyone wey come here go understand everything finished. Nai be another problem dem dey attack us well well for outside Board.
My brother. I tire o... I know when the argument of pidgin and English dey arise here. Me I dey in support of freedom, but then we go need to protect our own. I no get problem with whatever language anyone wan use but I just dey beg us say make more pidgin dey. The post na to reawaken our consciousness to make more pidgin post and put pidgin title but some people no understand. As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover. Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this. My people na wetin I get to share be this o.
Well my brother I know why I missed this your topic since but as I see am sef e never too late to shuk mouth put, for me watin I believe say the actual reason wey make dem give us this our local board na unto say we dey active well well but the clear fact na say we get local language which is the general pidgin because I believe if to say who ever dey give local board come hear na English we wan dey write and communicate here, I for reason say maybe he fit no even grant the request. My brother, that thing you talk na the truth. If to say na English all of us dey knack here, no local board for us...
|
| █▄ | R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | ▀█ | THE #1 SOLANA CASINO | ████████████▄ ▀▀██████▀▀███ ██▄▄▀▀▄▄█████ █████████████ █████████████ ███▀█████████ ▀▄▄██████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ ████████████▀ | ████████████▄ ▀▀▀▀▀▀▀██████ █████████████ ▄████████████ ██▄██████████ ████▄████████ █████████████ █░▀▀█████████ ▀▀███████████ █████▄███████ ████▀▄▀██████ ▄▄▄▄▄▄▄██████ ████████████▀ | ........5,000+........ GAMES ......INSTANT...... WITHDRAWALS | ..........HUGE.......... REWARDS ............VIP............ PROGRAM | . PLAY NOW |
|
|
|
Coyster
Legendary
Online
Activity: 2170
Merit: 1293
Crypto Casino and Sportsbook
|
|
April 13, 2024, 06:24:22 PM |
|
My brother, that thing you talk na the truth. If to say na English all of us dey knack here, no local board for us...
That one no be true, did you see the Indian local board wey i link for my last post in this topic, so many of the topics and posts there is in English language and i no sure say anybody dey complain there. Even if most of the posts here is in English, there is gonna be no problem with that, English na our official language in Naija and we dey only use pidgin for mostly unofficial purposes for Naija, so using English language in this board does not negate the fact that it is a local board.
|
|
|
|
Belarge
Full Member
Offline
Activity: 546
Merit: 100
Eloncoin.org - Mars, here we come!
|
|
April 13, 2024, 10:10:13 PM |
|
My brother, that thing you talk na the truth. If to say na English all of us dey knack here, no local board for us...
Everybody wan carry eye see job, nobody is ready to lose because people go dey complain about the services been render while their bosses ask of sex from them, it's a normal thing but not everybody like that kind of thing. If any officer try am come where i dey, i promised myself to break e head, this world de advanced. Our local board dry try small small. Make we first rest small in the eye of these top men and at least released these top men.
|
|
|
|
Cryptoprincess101
|
|
April 14, 2024, 07:37:36 AM |
|
You need to understand that even though we prefer pigin English as our general language but yet it is not because an outsider wey read pigin carefully go understand wetin we dey discuss for here so make we just manage am like that dey post both pigin and correct English because all dis tins naim be the wayo wey Oyibo people play us because had it been say we get our own common language e for no dey like dis, even some Oyibo people wey dey our country no dey waste time understand pigin so there's no cause to prioritize any language in the local board.
|
|
|
|
Uhwuchukwu53
Member
Offline
Activity: 350
Merit: 44
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
|
|
April 14, 2024, 09:37:06 AM |
|
You need to understand that even though we prefer pigin English as our general language but yet it is not because an outsider wey read pigin carefully go understand wetin we dey discuss for here so make we just manage am like that dey post both pigin and correct English because all dis tins naim be the wayo wey Oyibo people play us because had it been say we get our own common language e for no dey like dis, even some Oyibo people wey dey our country no dey waste time understand pigin so there's no cause to prioritize any language in the local board.
The matter na ogboge one becos waiin op yam for one side get in truth but waiting dey inside be say as another person fit understand pegin beside some of our brother and sister for d board fit no write with am but fit read am for me a for talk say as much say the information kajad and na waiting we need for the board make we no reason am wether na pegin. Cryptoprincess dey yan now true for my work place e get one German forman wey we get for dere d man na pegin ooo English him now sabi if you dey feel say na pegin for dat kind person the more you exposed your secret because him na father of pegin many oyibo way there language no be English they use pegin like us just that na the tongue difference gi make you feel say they are correct but if they write for you no pegin.
|
|
|
|
sokani
|
|
April 14, 2024, 02:39:29 PM |
|
We don torchlight dis mata before and we agree say make we dey use both languages on di LB. Di reason wey be say people dey write more in English dan in Pidgin fit be say English posts dey get more merit dan Pidgin posts, because apart from di translation topics, e dey hard for foreign members to stroll enta our LB and begin dey give merit to posts wey dem no understand. Maybe when we get our own local merit source, di number of posts in Pidgin go increase.
|
|
|
|
SmartCharpa
|
|
April 14, 2024, 07:06:45 PM |
|
The pigin when some persons for this place fit speak fluently, others fit no de comfortable with am and we no go fit force them to de use wetin dem no de used to. If you can comfortably make your post with pigin in a way that's easy to comprehend, you can do it without any hesitation but if you can't, it's best to do what works well for you and do it in line with the boards rules and regulations.
E be like say you dey misunderstood waiting Op dey try to yan for here, he no talk say they should force anyone to do their post with pidgin, but e get as the matter take be. If you look at the picture he share so, almost the topic na English and if you look at the other board i believe say na their native language them dey speak there. We know say naija we no get native language but make we try dey put pidgin for our post, e fit bring more improvements here because no be everybody like to dey stress their sef over big big grammars. Person fit see post wey make sense but if they see say the English too big for them, they will just ignore the post. If some of our newbie see say we dey paint everywhere with English dey may not get interest on this board again, some sef fit no dey active again.
|
|
|
|
R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | | | 4,000+ GAMES███████████████████ ██████████▀▄▀▀▀████ ████████▀▄▀██░░░███ ██████▀▄███▄▀█▄▄▄██ ███▀▀▀▀▀▀█▀▀▀▀▀▀███ ██░░░░░░░░█░░░░░░██ ██▄░░░░░░░█░░░░░▄██ ███▄░░░░▄█▄▄▄▄▄████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ | █████████ ▀████████ ░░▀██████ ░░░░▀████ ░░░░░░███ ▄░░░░░███ ▀█▄▄▄████ ░░▀▀█████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀ | █████████ ░░░▀▀████ ██▄▄▀░███ █░░█▄░░██ ░████▀▀██ █░░█▀░░██ ██▀▀▄░███ ░░░▄▄████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀ |
| | | | | | | | | ▄▄████▄▄ ▀█▀▄▀▀▄▀█▀ ▄▄░░▄█░██░█▄░░▄▄ ▄▄█░▄▀█░▀█▄▄█▀░█▀▄░█▄▄ ▀▄█░███▄█▄▄█▄███░█▄▀ ▀▀█░░░▄▄▄▄░░░█▀▀ █░░██████░░█ █░░░░▀▀░░░░█ █▀▄▀▄▀▄▀▄▀▄█ ▄░█████▀▀█████░▄ ▄███████░██░███████▄ ▀▀██████▄▄██████▀▀ ▀▀████████▀▀ | . ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ░▀▄░▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄░▄▀ ███▀▄▀█████████████████▀▄▀ █████▀▄░▄▄▄▄▄███░▄▄▄▄▄▄▀ ███████▀▄▀██████░█▄▄▄▄▄▄▄▄ █████████▀▄▄░███▄▄▄▄▄▄░▄▀ ████████████░███████▀▄▀ ████████████░██▀▄▄▄▄▀ ████████████░▀▄▀ ████████████▄▀ ███████████▀ | ▄▄███████▄▄ ▄████▀▀▀▀▀▀▀████▄ ▄███▀▄▄███████▄▄▀███▄ ▄██▀▄█▀▀▀█████▀▀▀█▄▀██▄ ▄██▀▄███░░░▀████░███▄▀██▄ ███░████░░░░░▀██░████░███ ███░████░█▄░░░░▀░████░███ ███░████░███▄░░░░████░███ ▀██▄▀███░█████▄░░███▀▄██▀ ▀██▄▀█▄▄▄██████▄██▀▄██▀ ▀███▄▀▀███████▀▀▄███▀ ▀████▄▄▄▄▄▄▄████▀ ▀▀███████▀▀ | | OFFICIAL PARTNERSHIP SOUTHAMPTON FC FAZE CLAN SSC NAPOLI |
|
|
|
Sexylizzy2813
|
|
April 14, 2024, 10:51:21 PM |
|
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this. My people na wetin I get to share be this o.
Me I understand Wetin u dey talk, e no really go well, me I dey hardly post with normal English for dis place, the highest wey I dey do, if I dey use pigin talk, some places dey wey I fit just use normal English, then go back my pigin again. I dey like if I dey post make people wey no dey dis local board no understand Wetin I dey talk, any outsider wey come go just dey look my post, him go dey confuse. If many of these English piple reason am d way you reason am we no go get issue for this matter but them make some of us look like say we no follow for the bookuru matter, but you see that part wey u use some part of your post for English and later reverse to pigin dy confuse outsiders wey dy come look how we dy e still make sense, no be every time we go dy sell ourselves for this unit. From this title wey you dey talk about, seriously nothing wey we go fit do about am, because the rules for the local board na say make we dey use both English and pigin communicate, and you no fit force anybody to post with any language they want, as long as they are not going against the local board rules, but the only thing wey dey na to dey encourage people make dem dey use pigin often, even if dey wan write topic e go make sense like that pass.
I get your point say no be by force but nothing bad if we try dy unique for some things too, nah this our pigin them go take sabi us as naija made. Na every time we go dy copy wetin no be our own? Wetin happen to that one wey be true true our own? Abeg any how e be make we type am speak am nothing bad if piple wey no sabi learn am, you make mistake them go correct them.
|
|
██ ██ ██████ | R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | ██████ ██ ██ | ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ | ██████████████ THE #1 SOLANA CASINO
██████████████ | ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ | ████████████▄ ▀▀██████▀▀███ ██▄▄▀▀▄▄█████ █████████████ █████████████ ███▀█████████ ▀▄▄██████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ ████████████▀ | ████████████▄ ▀▀▀▀▀▀▀██████ █████████████ ▄████████████ ██▄██████████ ████▄████████ █████████████ █░▀▀█████████ ▀▀███████████ █████▄███████ ████▀▄▀██████ ▄▄▄▄▄▄▄██████ ████████████▀ | [ [ | 5,000+ GAMES INSTANT WITHDRAWALS | ][ ][ | HUGE REWARDS VIP PROGRAM | ] ] | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | ████████████████████████████████████████████████ PLAY NOW ████████████████████████████████████████████████ | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ |
|
|
|
GiftedMAN
|
|
April 15, 2024, 12:23:50 PM |
|
This tok go well but I dey see say some people dey drag the talk dey long like say dem no really understand wetin op wey be uche god mean, make we reason dis matter small, no body dey force any body to dey write every post for pidgin but make we still make our corner dey unique and how we go doam if we no dey write in pidgin wey be language wey most of us if not all of us go understand very well and sometimes self e get small small secret wey we fit keep here wey only us go dey understand wey other members no fit know even when dem visit here. How we go dey claim say we get local board when we know get topic wey dey for pidgin language wey we dey use as our local dialet, most of us dey use pure English dey write and e no funny because anybody fit enter dis corner get everything wey we dey do here and e no go well.
Make we just make the place look like wetin e supposed be, make the thread topic dey start with pidgin if possible and make we swallow some of the grammar dem use our local pidgin language e go make sense to all and e go make some strangers wey no from we corner not to know everything wey we dey discuss unless dem go really take time to dey break am down one by one.
|
| Duelbits | ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ | | TRY OUR UNIQUE GAMES! ◥ DICE ◥ MINES ◥ PLINKO ◥ DUEL POKER ◥ DICE DUELS | | | | █▀▀ █ █ █ █ █ █ █ █ █ █ █ █▄▄ | ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ | ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ | ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ | ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ | ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ ███ ▀▀▀ | | ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ KENONEW ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ | ▀▀█ █ █ █ █ █ █ █ █ █ █ █ ▄▄█ | | 10,000x MULTIPLIER | | ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ | | ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ |
[/tabl
|
|
|
Justbillywitt
|
|
April 15, 2024, 07:29:46 PM |
|
As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover. Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this. My people na wetin I get to share be this o. Omo there is no way person for talk pigin English all through. Normally for this our pigin level we still dey mix am with English because the pigin self get different grades. Well if na the only observation wey you noticed say dey wrong for the local board, then wahalah no dey at all. Me I been dey think say you wan talk something about shit postings, but it be like say that one don reduce. E get time wey be say na shit postings been dey give us challenge for this our local board. But onto this level wey you Yan like this, I go say too much wahalah no dey at all.
|
|
|
|
R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | | | 4,000+ GAMES███████████████████ ██████████▀▄▀▀▀████ ████████▀▄▀██░░░███ ██████▀▄███▄▀█▄▄▄██ ███▀▀▀▀▀▀█▀▀▀▀▀▀███ ██░░░░░░░░█░░░░░░██ ██▄░░░░░░░█░░░░░▄██ ███▄░░░░▄█▄▄▄▄▄████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ | █████████ ▀████████ ░░▀██████ ░░░░▀████ ░░░░░░███ ▄░░░░░███ ▀█▄▄▄████ ░░▀▀█████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀ | █████████ ░░░▀▀████ ██▄▄▀░███ █░░█▄░░██ ░████▀▀██ █░░█▀░░██ ██▀▀▄░███ ░░░▄▄████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀ |
| | | | | | | | | ▄▄████▄▄ ▀█▀▄▀▀▄▀█▀ ▄▄░░▄█░██░█▄░░▄▄ ▄▄█░▄▀█░▀█▄▄█▀░█▀▄░█▄▄ ▀▄█░███▄█▄▄█▄███░█▄▀ ▀▀█░░░▄▄▄▄░░░█▀▀ █░░██████░░█ █░░░░▀▀░░░░█ █▀▄▀▄▀▄▀▄▀▄█ ▄░█████▀▀█████░▄ ▄███████░██░███████▄ ▀▀██████▄▄██████▀▀ ▀▀████████▀▀ | . ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ░▀▄░▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄░▄▀ ███▀▄▀█████████████████▀▄▀ █████▀▄░▄▄▄▄▄███░▄▄▄▄▄▄▀ ███████▀▄▀██████░█▄▄▄▄▄▄▄▄ █████████▀▄▄░███▄▄▄▄▄▄░▄▀ ████████████░███████▀▄▀ ████████████░██▀▄▄▄▄▀ ████████████░▀▄▀ ████████████▄▀ ███████████▀ | ▄▄███████▄▄ ▄████▀▀▀▀▀▀▀████▄ ▄███▀▄▄███████▄▄▀███▄ ▄██▀▄█▀▀▀█████▀▀▀█▄▀██▄ ▄██▀▄███░░░▀████░███▄▀██▄ ███░████░░░░░▀██░████░███ ███░████░█▄░░░░▀░████░███ ███░████░███▄░░░░████░███ ▀██▄▀███░█████▄░░███▀▄██▀ ▀██▄▀█▄▄▄██████▄██▀▄██▀ ▀███▄▀▀███████▀▀▄███▀ ▀████▄▄▄▄▄▄▄████▀ ▀▀███████▀▀ | | OFFICIAL PARTNERSHIP SOUTHAMPTON FC FAZE CLAN SSC NAPOLI |
|
|
|
Kelward
|
|
April 16, 2024, 12:51:30 PM |
|
Personally I reason say writing in pidgin English, for make dis our local board to de very unique and wen oda nationals visit di board, dem go get di flow say truly na dis style of English de popular for naija, infact you go surprise say more people go de visit our board to de feel our flows. Wen I join dis forum new, I experience different debates for dis board about weda to de make posts for normal English or pidgin English, in the end na to use either of dem na im carry di day, and since den every member de use di one wey im de take flow pass.
I for prefer say make more posts dey de for pidgin English, but reverse na di case as e show for di OP, more posts de appear for normal English, so we need to accept am like dat. Aldo instead of say make person wey no sabi write for pidgin English to de goof for I'm post, e de better say make im post for normal English, because some of our people no sabi how to write fluent pidgin English.
|
|
██ ██ ██████ | R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | ██████ ██ ██ | ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ | ██████████████ THE #1 SOLANA CASINO
██████████████ | ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ | ████████████▄ ▀▀██████▀▀███ ██▄▄▀▀▄▄█████ █████████████ █████████████ ███▀█████████ ▀▄▄██████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ ████████████▀ | ████████████▄ ▀▀▀▀▀▀▀██████ █████████████ ▄████████████ ██▄██████████ ████▄████████ █████████████ █░▀▀█████████ ▀▀███████████ █████▄███████ ████▀▄▀██████ ▄▄▄▄▄▄▄██████ ████████████▀ | [ [ | 5,000+ GAMES INSTANT WITHDRAWALS | ][ ][ | HUGE REWARDS VIP PROGRAM | ] ] | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | ████████████████████████████████████████████████ PLAY NOW ████████████████████████████████████████████████ | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ |
Hero - Legendary Member
|
|
|
Coyster
Legendary
Online
Activity: 2170
Merit: 1293
Crypto Casino and Sportsbook
|
|
April 16, 2024, 06:44:01 PM |
|
Personally I reason say writing in pidgin English, for make dis our local board to de very unique and wen oda nationals visit di board, dem go get di flow say truly na dis style of English de popular for naija, infact you go surprise say more people go de visit our board to de feel our flows.
Wetin make you think so, IMO, the local board dey very unique as e dey now, and we no need approval from non-Nigerians. I no know if you read my last posts in this topic, i linked the Indian local board and you can see that na mostly English wey dem dey use for their own board. As regards this argument, i even think it is when we mostly use English language to communicate that non-Nigerians will be able to inderstand what we say in our local board, but that is nothing of priority and it does not matter.
|
|
|
|
Jegileman
|
|
April 16, 2024, 11:53:18 PM |
|
Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this. My people na wetin I get to share be this o.
I really get wetin you dey try yarn and wetin you dey talk really make sense if dem go do am like that. But as he say in the past dem say before them approve the local board, English and pidgin na him be the main languages wey we go dey speak for here, na him make people dey use English for here wella too. Abi people no too sabi how to use Pidgin take create title of their post for here? Even me don create topic for here before and na English I use right am in full. Anytime wey I visit local board and I wan comment for post, e dey always be on how the OP take start the thread I dey use reply am, if na pidgin, I dey follow am up with pidgin and if no be pidgin na normal English I dey use. No be say I no wan use pidgin dey reply but I dey sometime forget say we fit use Pidgin for here, if I remember quickly I dey switch and if I no remember, I go just continue like that till I finish then use pidgin for my next reply or comment for posting in the local board.
|
|
|
|
rachael9385
|
|
April 17, 2024, 01:13:27 AM |
|
The thing na be say, some persons no dey that fluent when them dey use pidgin take dey express themselves. And this no be just even small ranked members, I mean so e of the legendary here sef don still talk say them no dey fit express themselves for pidgin write ups like when Dem use English. So the matter of going back to change the local board settings by using only pidgin, my brother that one no carry any weight, no body go even reason you. The only thing na besay, if you wan create thread then use the language you prefer either English or pidgin, but to change local board make na only pidgin Dem use, e no go work.
|
|
██ ██ ██████ | R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | ██████ ██ ██ | ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ | ██████████████ THE #1 SOLANA CASINO
██████████████ | ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ | ████████████▄ ▀▀██████▀▀███ ██▄▄▀▀▄▄█████ █████████████ █████████████ ███▀█████████ ▀▄▄██████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ ████████████▀ | ████████████▄ ▀▀▀▀▀▀▀██████ █████████████ ▄████████████ ██▄██████████ ████▄████████ █████████████ █░▀▀█████████ ▀▀███████████ █████▄███████ ████▀▄▀██████ ▄▄▄▄▄▄▄██████ ████████████▀ | [ [ | 5,000+ GAMES INSTANT WITHDRAWALS | ][ ][ | HUGE REWARDS VIP PROGRAM | ] ] | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | ████████████████████████████████████████████████ PLAY NOW ████████████████████████████████████████████████ | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ |
|
|
|
AmaGold70
Member
Offline
Activity: 100
Merit: 35
|
|
May 05, 2024, 11:11:35 AM |
|
As I visit our local board, I come discover something. Follow me watch this screenshot weda you go fit observe wetin I discover. Make I for no stress you, if you check the image well, wey almost cover the first page. You go see say no title apart from the topic wey Majestic-mif raise wey be pidgin. All the title dey for normal English wey come make the board look like politics and society or off topic board for general forum. If wey put majority of these titles for ogbonge pigin, people wey enter here go really know say na local board be this. My people na wetin I get to share be this o. As @davidvictorson talk "if wishes were horses" I for really like make we dey use pidgin as our local language because eh pidgin sweet no cap, as we get too many languages for our country we for just take pidgin hold body for this forum make we too feel like say we get our own unique language wey no body fit understand except us. But I come see say no be everybody for naija Sabi pidgin as some of us no really school for we country but at all at all I believe say at least 80/90% of us here go Sabi pidgin, so let's give it a try.
|
|
|
|
|