My contri people, The federal competition and consumer protection commission(fccpc) don talk say make we report any trader dey price hikes goods & services..Them talk say enough is enough for any trader wet dey like to increase price of products,say make we help them identify and report such trader to their commission...My contri people,e be like say diz Tinubu government don dey wake from sleep
This country matter don tire pepsin all this one na formality, no go carry body say government want to do something. waitin show say waiting Dem dey talk go work how country people want take no say the trader hike the price wen them never carry out list of prices the items how it's supposed been sold, apart from dat, if na tru why not set-up task force way go involved our arms forces like police, civil defense and some others to go around all the market published the sanction meant for default to the public and back it up by their law which will not deviate from our constitution, you will no a government wey ready to change tins by their doing no be to talk for mouth many ways wey go work faster dey to achieve this.
As dem dey look for whistle blowers, are they not in the country where this tins dey happen na citizens way never see food chop go dey call and email them for defaulter, I see this matter as something way no get head because na when citizens don know the actual prize den go take detect person wey dey hike price. My opinion is that make they bring out price required of government by the traders published it, make news carry am both social media when citizens don dey aware of all this tin is very easy to even join hand fight this matter.
We don forgot say d traders get union and all if them dey do according to what Dem don agree until government don say all items like dis we want am to be sold citizens come dey follow the prize dey tackle trader and report those who no want obey this fccpc matter if reporting no go hold water.