My people make una good evening, today I wan bring up something wey I notice for this our country Nigeria when it comes to this crypto space, We know say sometimes ago we been get plenty Ponzi schemes wey been dey collect money from people they double am, The most popular one been MMM, so after sometime MMM crash, and many people been really buy into the idea of investing online because MMM been dey deliver, but with time MMM come crash and most people money come hang,
Today i been dey discuss this Bitcoin halving with one of my female colleague, I been dey try wan convince say make she follow me Invest as I foresee a bull run by next year, but she come say she no go fit invest her money for any online business again after waiting MMM do her, I asked her why, she say she lost over 900k, I come dey try give her reasons why the two they completely different but she no gree , she say online business Na online business no matter how I want paint am, so my people I no know how una see am.
the thing be say because of the ponzi schemes wey don affect people for the country, many people come see anything wey concise internet and investment as scam related thing and na why people no even wan hear or understand watin Bitcoin dey all about. Some people dey even class am join say na yahoo something and na watin dem get and so far as you do anything related to internet dem don call you fraudster.