|
Rgram
|
Some people wey dey predict bitcoin price na the people wey just enter the market newly
I no know how you take come to this conclusion but, person way just enter Bitcoin or the cryptocurrency space no go just predict the price of coin if en no sabi do some kind analysis. Most of the people way Dey predict Dey always get a way them Dey use arrive at certain price either price, using historical data, looking at candle stick patterns and other tools way Dey give insight to where price Dey go. Even inside all these things, you still gats realize say, na prediction, na watin person feel say e fit happen and e no necessarily be true. them dey fill say the best way to make plenty people buy bitcoin na to dey predict that bitcoin go reach $500k, while some people even say e go reach $1m before we enter 2028. I just they think say na wyning them dey do so that people go just buy so that price go increase for them to sell their own. Wey tin una think?
People go put out anything out there and e Dey left for you say, make you no just follow blindly. If you wan invest, you gats verify the information way you Dey see and believe say, e Dey you okay before you go ahead. On the long run, Bitcoin Dey always go bullish and e Dey left for you to hold until such a time.
|
|
|
|
|
casey15
|
 |
December 01, 2025, 05:26:48 AM |
|
Nah, one thing I know is that people don't just come out and make false predictions. Most predictions are based in historical data and past price action.. wether a bear or a bull market, price action always have a way of repeating it self that is why you can have a trading strategy that works over and over again for a long period of time.. so it's not whining... It based on historical data that these predictions are made.
|
|
|
|
|
|
Shineup
|
 |
December 01, 2025, 05:36:19 AM Merited by fillippone (1) |
|
Some people wey dey predict bitcoin price na the people wey just enter the market newly, and them dey fill say the best way to make plenty people buy bitcoin na to dey predict that bitcoin go reach $500k, while some people even say e go reach $1m before we enter 2028. I just they think say na wyning them dey do so that people go just buy so that price go increase for them to sell their own. Wey tin una think?
I don’t understand where you get that kind talk say people dey predict Bitcoin price just to make others buy so the price go rise. Honestly, make you no let anybody deceive you, nobody fit truly predict wetin Bitcoin price go be tomorrow or even in the next few years. All those talk $500k and $1 million before 2028, na just too much talk. Bitcoin price dey very unpredictable, even people that sabi am no dey sure how e go move. People wey really dey invest in Bitcoin no dey do am because of hype or quick profit, dem believe say Bitcoin get better future, and na long term gain dey focus on. Dem know say the Bitcoin price fit go up and down anytime, but dem continue to hold because of the believe wey dem get and the benefits Bitcoin fit bring. Dem no dey invest for today or next week, dem dey invest for the future. Sometimes na traders or short term investors dey use prediction as method to make others rush enter the market. Once people don buy the price fit rise, and dem go use that opportunity sell their own and cash out better money. So make you dey very careful do your own research, and no just dey follow prediction anyhow. Invest with sense, no be waiting dem talk. People wey dey enter the market in form of say dem dey rush am na there own cup of tea, me I no see anything wrong for people to dey make there own predictions and any way or anyhow they like am, Bitcoin na speculative asset, predictions must always come here and there, we are not supposed to make investment decisions because of how people dey predict Bitcoin since nobody can be very sure of their predictions, the best thing na make we anyone dey buy Bitcoin without any form of rushing because of other people predictions.
|
|
|
|
|
Tmoonz
|
 |
December 01, 2025, 06:02:43 AM |
|
Nah, one thing I know is that people don't just come out and make false predictions. Most predictions are based in historical data and past price action.. wether a bear or a bull market, price action always have a way of repeating it self that is why you can have a trading strategy that works over and over again for a long period of time.. so it's not whining... It based on historical data that these predictions are made.
People can predictions and only becomes false because it has not happened and it can only become true because it has happened and this is how the market has been though we no go doubt say some predictions fit no dey realistic within the time wey person predict am. I want to disagree with you where you talk say price will always have a way of repeating itself based on historical data, you are wrong and completely wrong to say that, there is no guarantee that price action will always repeat itself based on history even though people can make predictions with historical data yet they are not meant to be rely on because it may or may not happen the same way and the market will remain uncertain.
|
| █▄ | R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | ▀█ | THE #1 SOLANA CASINO | ████████████▄ ▀▀██████▀▀███ ██▄▄▀▀▄▄█████ █████████████ █████████████ ███▀█████████ ▀▄▄██████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ ████████████▀ | ████████████▄ ▀▀▀▀▀▀▀██████ █████████████ ▄████████████ ██▄██████████ ████▄████████ █████████████ █░▀▀█████████ ▀▀███████████ █████▄███████ ████▀▄▀██████ ▄▄▄▄▄▄▄██████ ████████████▀ | ........5,000+........ GAMES ......INSTANT...... WITHDRAWALS | ..........HUGE.......... REWARDS ............VIP............ PROGRAM | . PLAY NOW |
|
|
|
|
MainIbem
|
 |
December 01, 2025, 07:35:17 PM |
|
Normally, na speculation them dey call am and na wetin make the crypto space sweet be that, even if the predictions na whining or not, so long as there is market dey fluctuate here and there, up and down, and so forth. Na the sweetness of the market movement be that. 500k too much to reach this year self and that the current price never rest it cases.
Yeah the term for am ba speculation and the thing be say nobody fit get wetin go be the actual price of Bitcoin at a particular time cause the market dey always fluctaute you fit only speculate wetin eh fit be and most times your speculations gp dey incorrect cause you fit think say market go rise up whereas eh go drop during that time wey you feel say eh go rise. Although some people dey always see the bear market as bad times but no time be bad time as far as Bitcoin investment dey concern cause as the bull market dey add value to wetin you invest inside Bitcoin naso the bear market be better opportunity to buy more Bitcoin cheaper.
|
|
|
|
osasshem
Full Member
 
Activity: 1218
Merit: 137
Creating a Safer Crypto Ecosystem
|
 |
December 01, 2025, 10:06:38 PM |
|
Some people wey dey predict bitcoin price na the people wey just enter the market newly, and them dey fill say the best way to make plenty people buy bitcoin na to dey predict that bitcoin go reach $500k, while some people even say e go reach $1m before we enter 2028. I just they think say na wyning them dey do so that people go just buy so that price go increase for them to sell their own. Wey tin una think?
When you de talk of Bitcoin prediction, that one na competition way de for the forum's whereby you go win a prize at the end of the contest period, and also pass all rules and regulations guiding the contest. This one de different from people way de analysis the market for trading, and this most times na for person use. While another one Na speculations way person just push into the air, make everybody for hear and put mouth for the discussion within or outside the forum.
|
|
|
|
|
Pi-network314159
|
 |
December 01, 2025, 10:30:25 PM Merited by SmartGold01 (2) |
|
Some people wey dey predict bitcoin price na the people wey just enter the market newly, and them dey fill say the best way to make plenty people buy bitcoin na to dey predict that bitcoin go reach $500k, while some people even say e go reach $1m before we enter 2028. I just they think say na wyning them dey do so that people go just buy so that price go increase for them to sell their own. Wey tin una think?
Omo those ones you dey Yan no concern Bitcoin growth o. Wetting dey control Bitcoin price na demand and supply. When demand dey higher than supply Bitcoin price go high, and when supply dey high and demand dey low naim dey make Bitcoin price low. Naim make Bitcoin price dey unpredictable, Oyibo man dey call am volatility. Although influencers like Elon musk Dem and mack Zuckerberg Dem fit just come out say Dem wan begin invest for Bitcoin and Ile go make many people buy am Because of influence, and Bitcoin go rise. But e no guarantee say na everytime e dey work like that.
|
|
|
|
|
Stable090
|
 |
December 01, 2025, 11:30:03 PM |
|
Some people wey dey predict bitcoin price na the people wey just enter the market newly, and them dey fill say the best way to make plenty people buy bitcoin na to dey predict that bitcoin go reach $500k, while some people even say e go reach $1m before we enter 2028. I just they think say na wyning them dey do so that people go just buy so that price go increase for them to sell their own. Wey tin una think?
If you wan trade bitcoin or you wan invest in bitcoin, e better make you do your analysis then enter d market, no Dey depend on Wetin people talk, because dem go run you street. E Dey difficult to know people wey sabi bitcoin, and d newbies wey just Dey come. I don see situation wey be say na newbies Dey online Dey make predictions, and d funniest part be say dem no really Dey hold any bitcoin. Bitcoin price fit go any price at any moment, so bitcoin price just Dey difficult to predict. Nobody knows the price wey bitcoin go be in the next few month or years, so even people wey Dey predict bitcoin to hit $500k or $1m fit Dey right, and at the same time dem fit Dey wrong.
|
|
|
|
|
Bigjoe33
|
Some people wey dey predict bitcoin price na the people wey just enter the market newly, and them dey fill say the best way to make plenty people buy bitcoin na to dey predict that bitcoin go reach $500k, while some people even say e go reach $1m before we enter 2028. I just they think say na wyning them dey do so that people go just buy so that price go increase for them to sell their own. Wey tin una think?
Well, like you said, it's all predictions and nothing more. And of course, predictions are not realistic because it may or may not come through. So investors taking such predictions to heart and investing because they feel it will climb in price just as predicted might be making a mistake. The price of Bitcoin is determined by market forces and not by a mare prediction by any newbie investor or a pro/old time investors. They are just sharing there views or what they think and not the exact future of Bitcoin because they don't have the power to do so.. thus, investors should be careful of the kind of predictions they listen to or who they follow when it comes to investing. Consistent buys using the DCA strategy and then with a long term Hodling mindset is what it is.
|
|
|
|
|
Marykeller
|
 |
December 02, 2025, 09:12:32 AM |
|
Some people wey dey predict bitcoin price na the people wey just enter the market newly, and them dey fill say the best way to make plenty people buy bitcoin na to dey predict that bitcoin go reach $500k, while some people even say e go reach $1m before we enter 2028. I just they think say na wyning them dey do so that people go just buy so that price go increase for them to sell their own. Wey tin una think?
I d laugh out loud for wetin you talk because when it comes to Bitcoin price predictions, everyone is allowed to speculate on am, whether newbie or not. It doesn't even matter as such, as most predictions no d come out as true, maybe na for the future it will do that. No go d think sae, $500k or $1 million no go ever happen for where Bitcoin d, It will someday. Nobody knows when or how long em go take for Bitcoin to reach the predicted price. Bitcoin na volatile assets that has the tendency to increase for long term. People making mind blowing predictions on base wetin dem d see about Bitcoin price movement. But where they always get am wrong na to speculate when it will happen. Which them d get am wrong
|
|
|
|
|
Judith87403
|
 |
December 02, 2025, 01:42:50 PM |
|
I believe say if satoshi or the early adopters of bitcoin been talk am say Bitcoin go hit $120k by 2025, considering say with $1 you fit pack plenty BTC back then, you still feel like say na whyning. Although the truth be some people just Dey do their predictions without even being sure or knowing how the market be, e no change the fact say true true Bitcoin price go grow pass wetin we Dey see today and when we also look back people wey go regret why them no buy go Dey. So whether na whining or not, it’s left to you to buy or not, even if them sell their own, e no mean say others no go hodl and bitcoin no go crash because say some people sell their own.
|
|
|
|
|
AmaGold70
|
 |
December 02, 2025, 03:36:55 PM |
|
Some people wey dey predict bitcoin price na the people wey just enter the market newly, and them dey fill say the best way to make plenty people buy bitcoin na to dey predict that bitcoin go reach $500k, while some people even say e go reach $1m before we enter 2028. I just they think say na wyning them dey do so that people go just buy so that price go increase for them to sell their own. Wey tin una think?
We don already know say nobody go fit predict Bitcoin price the way e go be and everybody just dey drop the predictions wey Dem think say go be but e no mean say Dem take am dey force people make Dem believe their predictions and you suppose know this thing OP, even you sef fit drop your own predictions the way you feel like e go be for Bitcoin. No be whining as you see am but na just pure predictions and everybody get right to predict and no body dey here to deceive you into believing their predictions as everybody just dey speculate, your thinking about Bitcoin prediction is wrong because nobody fit control the market with their prediction.
|
|
|
|
|