My guy me I no sure say the rate go come down. If we look the way things they go so, instead way naira go dey come down na up e go dey go. So far we never see any sign say the rate of naira go come down for were dollar dey because even our government sef no dey help matters when we dey talk about economy palava. With the kind of progress way US economy dey progress this few days as them dey make sure to tackle anything way go destabilize anything way go affect their economy so, and Nigerian government no dey do anything to help the country economy, I no sure say naira go get changes anytime soon. But I just dey hope say things turn out well this year sha.
Dollar no dey come down anytime soon again, this your comment made to go and check the current price of one dollar to naira, I can't really believed with my own eyes. I dey see #1564 to #1610 which means, dollar dey high well well. And as him dey rise like this, e no go come down easily again and things go rise up this period. This one wey American government dey support Nigeria government to fight against terrorist, there must be an agreement between them before them come.