This na sign say crime and insecurity Dey everywhere, so anything wey person Dey do u gat Dey on ur widas.
Right from d beginning of mankind, crime don dey. Rememba d case of Abel and him brother for Bible too. Na two things dey cause make persin deliberately kill anoda persin and those two things na envy and covetousness. If anybodi fit remove those two from dem bodi, e go hard to do am. So, once u observe sey envy dey any of ur friends body, just shift. Envy na bad thing.
U no even supposed tell person Wetin u get even if say na joke cos these days nobody know who be who and the heart of man is desperately wicked Abi how dem talk am for Bible.
The trick be sey anybodi wey mean well for u nor go even ask u to disclose wetin u get to dem bc dem too go know sey na ur privacy dem wan begin dig into. True friendship dey respect boundaries. Any friend wey nor dey respect ur boundaries nor be true friend. The problem wey me don discover in some of des things be sey most times na d crypto hodlers demselves dey use dem hand expose demselves because dem want make people know sey dem get dip pockets and dey loaded. Na seeking for validation me dey call am. Who cares, really?
That boi now don die go for just Wetin he think say na normal talk with people him sabi, wey lead to this extortion and death. I feel say he fit don recognise one of dem wey make dem kill am.
Maybe, him recognized somebodi there among dem. Anyway, him don die go. The lesson na for those of us wey still dey alive and don read wetin happen to am. Sermon wey pastors dem dey drop for burials nor be for persin wey dem wan bury but for those wey attend d burial. Na so e bi.