They behave in the following manner on Bybit.
- They negotiate for a reduced rate.
Once I open trade with any merchants I nor dey even like chat dem up. Na automated system. As soon as trade open, dem too go dey alerted. Na d timer I dey set my eyes on.
- Sent you fake payment evidence if you fail to reduce the rate they are paying.
Where una dey find dis type of people sef? Abeg, make una dey drop names of merchants wey dey act like dat so dat others go dey avoid to do anything with dem, and also so dat more experienced members go fit pay dem a visit. Make we go greet dem small by trying dem out. Na merchants like dat I go like patronize sef so I go fit show dem small Tinubu shege banza.
- Forcing you to cancel the P2P order, which, if you do it three times a day, you can't perform again until after 24 hours.
- Delays you before making the payment, or takes much longer to later cancel the p2p trade.
Make una dey try choose merchants wey dey within 15 minutes window if una dey in a hurry. But I dey always suggest sey make we nor dey eva dey in a hurry anytime wey we dey do anything concerning money. Any small mistake dey always dey costly, whether for exchange or bank. So, if u pick whateva time window, make ur eyes dey on d time window and nor be on make d transaction end before then, even if u know sey d merchant dey online but dey slow to attend to u. Dat wan nor supposed vex anybodi.
Challenges with MexC Exchange
I get an account on MexC but I neva do any P2P there. So, I nor really fit sey wetin dey sup there and whether dem dey betta than Bybit.
Which exchange should be recommended for Nigerian p2p for now?
Bitget na betta option than Bybit at d moment. Scam attempts nor really dey there like wetin Bybit dey show us. I nor even know wetin make Bybit admins nor wan wake up to d challenges wey dey there and scare those thieves away.