People wey dey enter Bitcoin with the mindset of “make I double my money by next week” usually dey end up been disappointed, because Bitcoin no be betting platform, e no dey do sharp sharp. Bitcoin na patience teacher.
So make I yarn you small story to illustrate wetin I wan talk. Imagine two guys for 2012. One buy Bitcoin small small, keep am inside wallet and forget am. The other one say “abeg I no get time for this internet money” go put all him savings for bank. Fast forward 2025. Bank guy dey complain say him interest no reach recharge card money, say inflation don chop everything. Whereas, the Bitcoin guy dey look him portfolio dey smile like person wey see just him old time girlfriend due to the fact say the value of the money don skyrocket, simply because he took the right investment decision. Hence, this short story brings us to a conclusion say "Bitcoin no dey make you rich overnight" but rather "Bitcoin go make you rich over time" Which is why them dey call am "store of value", and not "store of impatience". Because every 4 years, halving dey reduce supply. Demand dey increase, and that's the reason why it's price to always surely skyrocket over time.
So if you buy Bitcoin today and plan say “You go check am again for 10–15 years”, you don already beat plenty people wey dey chase quick money online. Bitcoin na like planting palm tree, you no go chop fruit next month, but when e mature, your children and their children fit still dey benefit.
So on that note, as we end the year 2025 in few days time and plan to enter New Year 2026, please ensure to make Bitcoin investment as part of your New Year resolution. Because time go surely reward you when you put your investment trust in Bitcoin. Thank you, and Happy New Year in advance.
Wetin you talk dey true actually, na patience game be this. Alot of persons go dey chase quick gains and still come dey end up frustrated inside, but if you choose to start small, and you dey consistent and actually think long term, you go reap the rewards. I like your short story, na perfect example of why discipline matter more than timing. Bitcoin matures with time and the earlier you start even with small amounts, the better positioned you go dey down the years. So yea, if you make Bitcoin part of your plan for 2026, that would be a smart thing to do.