Sell Bitcoin Wey U No Go Negotiate with vendors In Bybit.
I think say sir
Igebotz thread talked about am but when I checked, e no talk am so I come create dis one make people learn from am and use am to sell their Bitcoins in bybit wey you no go negotiate or convert am to USDT before selling dem.
You go fit sell bitcoin in Bybit with ease wey you no go change to USDT. I been dey battle with dem for over a year. And anytime when I dey sell bitcoin for bybit na so so negotiations nai dem dey negotiate. You can see, dis ones na recent banter with dem.

This guy tell me say, I no go fit sell bitcoin in Bybit wey vendors no go negotiate with you. And bitcoin wey I dey sell 95+k dis guy say him go pay 87k and him negotiate with me go reach 90k. I no gree sell.

As I no come gree na, him come say make asked for cancellation so him go approved. Na so I request for cancellation and him come approved so deal closed.
Nai I come dey brain storm on the app. There supposed to be a place in Bybit where I go click to sell Bitcoin without Negotiation and changing di coins to USDT because dat 1 dollar wey bybit dey cut for di converting charge dey pain me for body. I come say make I tried dis one and if dem still negotiate, I go change am to USDT and sell am with peaceful mind. So I come click di p2p, then I come see 1 with red and the thing come dey like message box. I come clicked am. Nai I come see some settings.
Ads types I come dey changed the setting. The default setting was. Show only eligible ads. And I changed am to:
Show only verified Advertisers, and Show only block advertisers. I ticked the two.
And Time for payment. I ticked 15 minutes.
Sort by:
I changed am to: Complete Rate.
And I clicked confirmed. Please check the image below for proper guidelines.

This one na the default settings, you have to change am to the above setting.

After everything. You click sell and select your amount, payment method. Which I dey used the bank I dey normally use and click any vendor from there. The payment go come straight without negotiating. Exact amount will be paid to your account without negotiation.