Weytin go be Ur own persona very END? you go later spend your bitcoin finish or you go just continue to hold am till you die abi the investment na weytin you want make your family or generations enjoy? because me I dey think so say be weytin we go hold too much, I go just sell when I don dey old enjoy am small because the money no go spend em self and another person na em go chop our money for us ohh. reason am wella.
I go really like make I hold my bitcoin for my family members to enjoy or generation to enjoy. As long as nothing do me, and no be say i enter problem or I need any emergency money wey go make me think about selling my bitcoin if alternative no Dey, dem I go just hold my bitcoin, e better make my family members enjoy am.
If u Dey make investment, then na ur generation u suppose Dey make investment for be that now, u suppose Dey get plans for d future of ur family members, even if u no Dey again u suppose arrange things keep for them wey dem go Dey benefit from, dem no suppose suffer if u no Dey again, and e go make sense to leave bitcoin for them.
If u wan enjoy money, e no mean say u no fit later sell some of ur bitcoin now, but if u Dey enjoy, try dey think about ur children future, d investment wey u dey do now, e fit go a long way in d future. But if u Dey invest, make sure say ur seed phrase Dey property secured, and make sure say u keep am for place wey be say even if u no Dey again, ur family members go fit easily see am.