For some time now, Bitget has stopped charging their normal fees on P2P transactions unlike before now when some percentage of your coins would be taken by the exchange as a fee.
I neva observe am for my side. I do small P2P a few days ago but I nor see dat wan. Anyway, e go dey good if dem begin do am. Although d charges sef nor be wetin go bite persin like fuel and kerosene prices dey do us now for Naija. My major concern for Cexs na for dem to weed out those unscrupulous elements wey dey there to scam inexperienced P2P traders. Also, make Bitget find way to ensure sey any merchants wey nor dey use dem original registered name for dem accounts nor go fit do P2P there.
E don already pass one month wey dem begin do no-fee P2P but if your eyes no sharp you no go even notice am and if you dey in de habit of not reading notices on platforms you go still close am as em pop up based on say your mind don dey for wetin really carry you come de exchange. Me I see am when e start, but I no believe dem until I don confirm am myself after some trades before I carry am come here. Laidis Bitget suppose pay me as na free promotion I do for dem to bring back all dem customers wey don run because of de fee.
Make u dey try round up ur transactions. E dey help us avoid roving eyes from banks or those wey dey trace crypto transactions. Na for awa own good sef. For instance, u for just calculate ur deal to something like ₦40,400 or ₦40,450. Nor dey add kobo join.
I fit round am up by myself?
Most times na de merchants dem dey round am up as dem no dey pay kobo. Most of dem state am clearly for dia rules so I no dey even bother.