Suspected bandits attacked the communities of Mari and Dina in Kwara State, in Nigeria, killing at least five, and three soldiers. The attackers reportedly abducted several residents and ambushed security forces responding to the incident .
Residents expressed fear over the escalating violence and urged authorities to enhance security measures.
Dis killing matter self don tire me, as dis one happed at plateau state wey another one don Dey happen for Kwara state already, all dis killing wey Dey happen for dis country na political because our politicians self get hand for all dis things, and dem no want make e stop just because of Wetin dem Dey benefit. No part of d country even Dey safe again, insecurity for everywhere and we get politicians for dis country, we get president for d country, we get governors, we get senators and other political posts, and everybody just lock up.
Omo don’t even know who go come save us for dis country, because I feel say everything don too spoil for dis country, and I don’t know if anybody go fit come fix am again. Bad news just full everywhere now, if u enter internet now, na just
Bad news you go just Dey see about things wey Dey happen for dis country.
Omo make God just help us for dis country, but e no really funny. Politicians Dey use life and properties of their citizens Dey play politics, some people no really get mind at all. Abeg make our president look for how him go take stop all dis killings now.