Ona dey really talk nonsense oo, because freedom of speech dy for we country no mean say we go dy talk anyhow na, how governor fubara use be weakling?
You think say na everybody dey desperate for power like all this greedy and wicked politicians?
We as Nigerians sabi talk nonsense, and we no sabi appreciate good people when we see one, Na so we talk the same thing about good luck Jonathan say na weakling him be because him say his political ambition no worth the lives of any Nigerian, now wey we don see the kind strong man in president tinubu we dy find since, now na still us still dey complain.
The earlier we understand say no be everybody get wicked and heartless mind, the better, because being wicked no make anyone a strong man, make we try reason wetin we dy talk before we speak out abegi.
Bro just as you talk, anybody fit tok anything wey dey there mouth cos of say we de free to tok anything wey dey our mouth, so because of sey em withdraw from the selection wey dey on today make am weakling, just imagine how some of our naija people the think na, no i never see people all the man for social media, some say pesin pikin name no supposed to be fubara, dey just the yan anyone, na this thing make me conclude sey, e go dey difficult for naija to get am right because them no believe in something like withdrawing from a process wey them fit say it is not worth dieing for or the citizens dieing for too, it is highly disappointing when the youths the tok like this, Gov Fubara don do em own, if e vex anyone make dem do their own.