With all of this thing going on, how much money and BTC go make you beat your chest say I don dey balance for this country now?
BTC na your money already na. Nothing again like how much money and BTC. Bitcoin Dey spendable, sendable and if that one no do you then you fit still convert am to US dollar, or our Niara.
For me this no be our problem. If you Dey talk of this thing you no need Dey personalize am because everyone get their own different financial hope but rather me I want an economy where the poor masses can atleast afford their daily bread.
I understand your point bros. Once BTC dey your wallet, na your money already. Personal comfort no mean anything if the economy is bad but I just want to know how wey dey think individualy here. Me sef go dey happy if economy is good where even people wey no hold BTC go dey afford daily bread without ease.
Assuming you used ₦2.5 million for food in a year and ₦2.5 million for house rent which can be too much for most people, that is ₦5 million in a year.
If you use ₦15 to ₦30 to establish a business, such business supposed to give you more than ₦100000 to ₦200000 very month. I estimate the profit to be 20% APR which is small.
Minimum wage for people that are not rich is even close to that amount.
5m per year for average Nigerians is realistic because that is roughly 400k per month but for places like Abj and Lagos, e go still dey tight but somehow OK in some other parts.