So far the digital market is concern, bear market plays some crutial to investors, and thereby making the bitcoin market very interesting to navigate.
People don’t know the importance of bear market in the crypto space, most people never want bear to happen, they just want people price to keep on pumping. If bear don Dey happen for market, u go don see people Dey panic already, and plenty people go don Dey sell during this period. Time wey dem suppose Dey buy bitcoin cheaply, na sell dem go Dey sell their own bitcoin wey no really make sense.
If bear Dey happen, I know say everybody money go Dey drop, but na another opportunity for people to buy bitcoin at cheaper price but people no Dey understand that part. Also make we know say we no fit just avoid bear market, bitcoin price no fit just Dey pump without bear happening, so make all of us know that, and if bear Dey happen, we no need Dey panic.