|
Zigabel
|
 |
Today at 04:26:14 PM |
|
E get wetin oyibo dey talk, dem dey talk am say no sability wey you sabi be waste, at anytime, e good make we start to dey teach children how dis thing dem mata dey be, because we no know how tomorrow go be, we dey see say for tech now, children dem don dey become developers and dem dey even do robotics, so dis one no go bad if we teach dem make dem sabi am put body as we dey do am, we fit say okay make we dey teach dem make dem dey get basic knowledge fes, no involve money fes because dem fit never sabi how to manage money well and volatility no dey smile, sometimes e fit happen wey be say d pikin go panic make move wey go make you loose money since dem go never fit sabi control dia emotion finish.
if you get d chance, e good make you dey teach dem small small, b4 dem go big come reach d age, dem go don too sabi d tin well well. d basic things to teach dem na, wetin wallet be, how to hold their coin safely or you go put am as security of dia coin den teach dem how to buy and sell safely too so dat dem no go fall for scammers, na dis basic tinz dem need know, for now, nothing really consine dem with technicals, dem fit do dat one later. make dem just know how d tin dey work, how dem dey make money form d tin and how to protect your money, and na good start for dem be dat.
|